diff --git "a/raw/pidginTranslations_3.csv" "b/raw/pidginTranslations_3.csv" new file mode 100644--- /dev/null +++ "b/raw/pidginTranslations_3.csv" @@ -0,0 +1,3241 @@ +English,Pidgin +"Mtschew, it was not easy at all, at all, man!","Mtschew e no dey easy at all, at all kai!" +"At that time uh... ah that was how, any...","Dat time eh, ah na so any..." +I couldn't do anything.,I no fit do anytin. +My husband felt really bad for me.,My husband just dey pity me. +He was the one helping me out with some things.,Na im dey help me do some tings. +"Man, all our mothers work really hard.","Kai our mama dem, de dey try o." +They are really working hard.,"De dey try well, well." +"But ever since I gave birth... immediately after I gave birth, look at me feeling so great.","But as I con born now, immediately I born, see as I con well." +"Everything's f-... uh, it's like I was never pregnant.",Everytin f-... eh con be like sey I no dey pregnant before. +Everything's great now.,Everyting con dey a'ah. +"All the headache, everything, everything, all the sickness just stopped, okay?","All di headache, everyting, everyting, every sickness just stop kpai!" +"I said, ""uh, is this how it is?""",I say ehn na so e be? +"So now that we had the kid, the drama started.","So we con born di pikin now, drama con start." +"Yes now, okay you had a kid.","Yes now, okay you born baby." +"The baby, as I f-... gave birth to her, for f- two days, I did not see the baby.","Baby, as I f-... born am sef, for f-... two days, I no see di baby." +Because it came early.,Because na pretime. +The baby came earlier than expected.,Di baby no reach time wey I take born am. +So they kept her for... almost a week.,So de keep am for like one week. +"When I finally saw the baby, see, the tiny thing looked small.","As I con see di baby now, see di tiny ting con small." +Then I started breastfeeding.,Con start to breastfeed. +"Ah, waking up in the night is another job.","Ah to dey wake up for night, anoder work." +Another big job indeed.,Anoder big work o. +"I was just waking at night, man.",I just dey wake up for night kai. +"Sometimes... my mother was alive at the time, she would help me carry her a little.",Sometimes (my mama dey dat time) she go help me carry small. +"My husband would also carry her a while, until, until...","My husband too go carry small sotay, sotay..." +Because I was only feeding her with breastmilk.,Because na only breastmilk I dey give am. +I didn't give her any...,I no give am any... +I didn't give her any baby formula.,I no give am formula. +"So little by little, by the third month, she was waking up less at night.","So small, small, as three months reach, di time wey she take dey wake up for night con reduce." +I was still...,I con still dey... +"I was still just giving her food, breastmilk.","I still dey give am only food, breastmilk." +I wasn't giving her any formula.,I no give am formula. +"When she was six months old, ehen.",E con reach six months ehen. +"When we got to the sixth month, she stopped taking breastmilk.","When we reach six months, na she no even collect breastmilk again." +"One day, I tested her by giving her baby food.","One day, I con try am give am pap." +She took it.,E collect am. +I said ah.,I say ah. +Okay!,Okay! +"So after some time, she started taking breastmilk again.","So after some time, she con start to collect breastmilk again." +"So she was eating, sleeping and everything.","So she dey chop, dey sleep, everyting." +"That was how we went on, going bit by bit.","Na so we con dey do am, dey rough am small, small." +"But even up until now, she still wakes up in the middle of the night, she still wakes up.","But even till now sha, she still dey wake up for middle of di night o, still dey wake up." +But her hair has grown.,But her hair don grow now. +She's a girl.,Na girl. +"So I have started plaiting her hair little by little, little by little, and I'm buying clothes.","So I don dey plait im hair small, small, small, small, dey buy cloth." +We take pictures.,We dey take photo. +"The girl, she likes to play with phones.","Di girl, she like to play with phone o." +"Phones, laptops, television, all those things attract her.","Phone, laptop, telly, all dose tins dey attract am." +I don't know if she wants to do... if she wants to go into the entertainment industry or something.,"I no know wheder she wan do, wheder na entertainment she wan do now, or wetin." +I don't know.,I no know. +"We never know, but...",We never know but... +"Well, she has not started talking, but we play, we laugh.","She never even start to talk sha, but we dey play, we dey laugh." +We are just...,We just dey... +We are just fine.,We just dey. +"We are just fine, enjoying.","We just dey like dat, dey enjoy." +"After my mom stayed with me for one month, she left.","As my mama stay with me one month, she don go." +"Me and my husband started doing it little by little, little by little, together.","Na me, and my husband con dey do am small, small, small, small together." +"In fact, I've started working now.",I don even start work now. +So I have started taking her to daycare.,So I don even dey carry am go creche. +"So at least, sometimes, me too... I'll say I am going on, on break.","So at least, sometimes, me too, I go say I dey go on, on break." +"When she goes to daycare, I'll be able to work.","When she go creche, I go fit work." +I come back to the house in the afternoon.,I go come back for house for afternoon. +"In the evening, we continue as usual.","Evening time, we go continue wetin we just dey do." +"Me, I work for the local government.","Me, I dey work for local government." +I'm a civil servant.,I be government worker. +"Uh... so there in the local government, if I...","Ehn so for local government dere sha, if I go..." +"But the good thing is that since I gave birth, the government has a procedure.","But di good ting be sey as I born pikin, e get as government take do am." +"I gave birth, I got uh...","I born pikin, I get eh..." +I was on maternity leave for three months.,I dey maternity leave for three months. +I was away for three months.,I go three months. +"When I came back, three months... for those three months now, immediately I resumed, if others finish by four o' clock, they let me finish by two o' clock.","When I come back three months, for dat three months now, as I resume work, if oder people dey close for four o'clock, de gree make I dey close two o'clock." +"So I finish on time, go get my child, and head home.","So I go close on time, go carry pikin go house." +So this arrangement of two o' clock will go f-... will go on for six months.,So dis two o'clock one go go f-... go run for six months. +"After six months, I will start working again.","After six months, I go con start work again." +So that government procedure is good.,So e good as government do am. +My child will be almost a year old before I start working fully.,My pikin go don almost reach one year before I go con dey do work fully. +"So she will be very strong, like that.","So she go don dey strong well, well like dat." +Even those three months they gave us...,Even dat three months wey dey give us... +But we're still praying that they extend this uh... leave as uh... the doctors... the hospitals say we should breastfeed exclusively for six months.,"But we still dey pray make de extend dis eh leave as eh doctor, hospital say meh we dey do exclusive breastfeeding for six months." +"So if they can extend this uh... leave to a period of six months, it will be better because even that time... well, God has helped me.","So if de fit make dis eh leave meh e dey enter six months, for dey good because even dat time, God con help me sha." +There's a daycare next to my office.,E get creche beside my office. +I take my kids there.,I carry my pikin go. +"So while I'm here at work, I'll go feed her, go fin-... so that I will be able to do this uh, six months ehn.. six months full t-... uh mtschew, exclusively like they recommend.","So as I dey work, I go go feed am, go fin-... so dat I go fit do dis eh six months, ehn six months full t-... eh mtschew exclusive wey de talk." +But some people won't be able to do it.,"But e get some people now, de no go fit do am." +"They won't be able to do it, due to their work.",De no go fit do am because of deir work. +"It... those who work with private organisations, are the ones I pity the most.","E, people wey even dey private, na im I pity pass." +But ev-...,But ev-... +"Some people... even some government workers, cannot do it if there's no daycare in the office.",Some people (even some government people) no fit do am if creche no dey your office. +My saving grace is the fact that there's a daycare in my office.,Wetin help me be sey creche dey my office. +"If I hadn't had a daycare in my office, it wouldn't have been easy.","Creche no dey my office now, e for no dey easy." +"But that's what helped me, really, so I've been able to do it.","But na wetin help me sha, so, I con fit do am." +The child has grown now.,Di pikin don grow now. +"Now, she eats.",She don dey chop now. +So everything is alright.,So everyting don balance. +"Ehn... now in the office, as I am, it is...","Ehn for office now, as I dey so, e be..." +What I do is kind of like documentation work.,Wetin I dey do be like documentation work. +Ehn.,Ehn. +"When the ones who go out on assignment come back, I will ev...","People wey go out on assignment, come back, I go ev..." +"Or maybe... let's say I'm in charge of the staff, ehen what the staff does... people who go for training, who come back.","Or maybe make I talk sey I dey in charge of staff, ehen wetin staff dey do, people wey dey go training, wey dey come back." +It's administrative work.,Na admin work. +I colllect documents.,I dey collect document. +People are...,People dey... +"Ah when they write application letters, they forward them to me before I take them to my boss who will then pass them to...","Ah when de write application, forward for my side before me I go con carry am go give our oga wey go con pass am to..." +Everything.,Everyting. +Even if people want to see...,Even if people wan see... +"If people want to do... maybe... like collaboration (sometimes, all these NYSC [National Youth Service Corps] students, they come, wanting to do some work for our Local Government now), they will write their application letters.","If people wan do maybe like collaboration (sometimes all dis NYSC students, de dey con wan do some work for our local government now), de go write deir application." +I will be the one to process it.,Na me go process am. +I will be the one to forward it... to go and give it to my boss.,"Na me go forward am, go give oga." +Then the boss will check it before...,Oga go con check am before... +"Even when the boss wants to reply, I will still be the one to still...","Even when oga wan reply now, na me still go, still..." +"He will still channel the thing through me, then I will give the person the reply.",E go still channel di tin pass my side wey I go con give di person di reply. +"Whether he gets a favourable letter or whether the thing... the deal will not work out, I'll still be the one to pass... to tell them.","Wheder e get di favourable letter, or wheder di tin, di deal no go work, na me go still pass tell dem." +"Even during promotion exercises and all these things, I am still the one who hands over the letters to the staff members.","Even when dey do promotion, and all dis tins, na me still dey carry letter give staff." +This is what they've done.,Sey dis na wetin dey don do. +"As uh... given that I'm a strong Warri girl, being a staunch Warri chick, we like banga sauce, and starch.","As eh, base on di strong Warri girl wen a be, staunch Warri babe wen a be, we dey like banga soup, and starch." +Banga sauce and starch are our best foods.,"Banga soup, and starch na our correct food." +"Which means that any time you come to our neighborhood, if you have not seen banga sauce and starch in a clay pot, you need to go and ask yourself some questions.","Wey be sey any time you enter inside our field like dis, if you never see banga soup, and starch inside Ewere pot, you need to go, and ask yoursef oder question." +"So today, today, I will just tell you how to prepare your banga sauce and starch.","So today, today now, a go just tell you how you go take get your banga soup, and starch ready for your side." +"First and foremost, you need to get your banga [palm nuts].","Number one, you need to get your banga." +"Palm nut is what they call banga, you know.","Banga, na im de dey call palm nut uhm." +"It is... when you have gotten your banga ready, there are some spices which make banga sauce what it is.","Na, when you get your banga, e get di spices wey dey make di banga soup be banga soup." +"And the spices, one is called irogoje, and the other is called otaiko.","And dat spices, dem dey call am irogoje, anoder one, de dey call am otaiko." +Another one is called inyanyan; another one is called peletete.,"Anoder one, we dey call am inyanyan, anoder one, de dey call am peletete." +"And to top it all off, you will add bitterleaf to it so that when you start eating it like that, it will go down smoothly.","And to crown am all, you go put your bitterleaf inside so dat when you start to dey chop am like dat, e go just dey flow dey go." +"Okay, here's what you do!","Okay now, see wetin you go do!" +"Once you've bought your ingredients from the market... if you want to use fish, there's no problem with that.","Once you buy your eh tins when you go market now, if na fish you wan to use o, no problem." +"In Warri, they like using fresh fish... catfish.","For inside Warri, we dey like to use fresh fish, catfish." +And the kind of catfish we use is not the kind that was raised in the pond.,"And di kind of catfish wey we dey use, no be di one wey be sey de don feed for pond." +"It's the kind that was caught from the river, fresh ones.","Na di one wey come out from inside river, fresh one like dat." +"When we've bought it and taken it home, we will use a knife to cut off the head.","When we buy am come like dat, we go knack am, take eh knife knack di head of di fish." +Or we will put salt in into it and we will cover it.,"Or we go put salt inside, we go come cover am." +"When we do that, the fish will die on its own.","When we put am like dat, only di fish go die on im own." +Then what will we do?,Den wetin we go do? +We will take out the intestines.,We go remove di belle. +That's for the fish.,Dat one na for di fish o. +"Now, when you get to the market and you have bought banga, otaiko, rogoje, beletere, iyanyan and bitterleaf.","Now, when you reach market, you don buy your banga, you don buy your otaiko, your rogoje, your beletete, your inyanyan, your bitterleaf." +All these things I just mentioned are spices.,"Now, all dese tins wen a call now so, all of dem na spices." +What do you need to do?,Wetin you need to do? +You need to griund these spices because you won't be tossing them inside your sauce like that.,You need to ground dese your spices because you no go fit carry di spices toss throw inside your soup like dat. +"So you will take your ba-... your rogoje, otaiko and iyanyan.","So you go take your ba-... your rogoje, you go take your otaiko, you go take your inyanyan." +You will put them into your blender.,You go put dem inside your blender. +"If you don’t have a blender, put it on a grounding stone.","If you not get blender, put am inside grounding stone." +Then grind it.,Den ground am. +Get it really smooth.,"Make e dey smooth well, well." +And then put it in a corner.,Den put am for corner. +"Now, another thing you will use... you will use dry pepper in this very sauce.","Now, anoder tin wey you go use, you go use your dry pepper for inside dis very soup." +"Because if you use any other pepper, it may not give you that smell... that aroma it's supposed to give you.","Because if you go use any oder kind of pepper, e fit no give you dat smell, dat aroma wey e suppose to give you." +So you will use dry pepper.,So you go use your dry pepper. +"Now, to get your pepper ready, you will grind your dry pepper and set it aside.","Now, for your pepper now, you go ground your dry pepper too, put am for corner." +You will use seasoning cubes because these seasoning cubes we call...,You go use cube o because dis cube wey de dey call... +Uh... I don’t want to mention any names so that you will not insist on the one I mentioned.,"Eh, a no wan call any name now so dat you no go say na di one wen a call you go use." +A seasoning cube is a seasoning cube.,Cube na cube. +Any kind of cube.,Any kind of cube. +You will also use seasoning cubes while preparing this food.,You go use cube too for inside dis your food. +So you will set your seasoning cubes aside.,So you go put your cube for corner. +You also need crayfish.,You still need crayfish. +What?,Hm? +But you don’t need a lot of crayfish because they can overpower the sauce.,"But di crayfish wey you go use now, no be sey na plenty crayfish wey come overpower di smell." +So s-... you will just use a little crayfish.,"So s-... shekele crayfish, na im you go just use." +You will grind your crayfish and set it aside.,"You go still ground your crayfish, put for corner." +"Now, let's cook the banga sauce quickly, quickly, quickly.","Now, make we cook di banga soup sharp, sharp, sharp." +What will you do?,Wetin you go do? +"You've already gotten your palm nuts, also known as banga, ready.",You don get palm nut wey be your banga so. +Put your banga on the flame.,Carry your banga put for inside fire. +Do not buy the genetically modified banga.,No buy agric banga o. +Buy the locally planted banga because the local banga will give you the good oil you want.,Buy native banga because native banga go give you di correct oil wey you wan. +The genetically modified banga will just be thick.,Agric banga go only thick. +And it will not make the sauce delicious.,And e no go make di soup sweet. +"Well, buy the native banga.",Toh buy native banga. +"How can you identify the native banga, in case you want to know?",How you go take know native banga in case you want to know? +"Just press it with your hands, like this.",Just take hand press am like dis. +Native banga doesn't have much flesh.,Native banga no dey full. +"Once you touch it like this, it will shoot out a little, but before you will touch the genetically modified Banga in this way, it'll have already torn open and it's really fleshy.","Once you just use hand touch am like dis, e go just come out small, but agric banga, before you go do am like dis sef, e don tear, and di flesh, e dey plenty well, well." +That’s the difference between the locally grown and the genetically modified ones.,"Dat na di difference between native, and agric." +"But again, there's one other method.","But again, anoder style dey o." +Because your locally grown banga doesn't thicken up quickly.,"Because your native banga, e no dey quick dey thick." +"You will cook it for a very long time, but it will not get thick.","You go cook, cook, cook, cook, cook, e no go thick." +"But if you want it to get thick fast, you can add some of the genetically modified Banga to the locally grown banga.","But if you want make e quick thick, you fit get like small of your agric banga, join am wit di native banga." +But make sure that you use more of the locally grown banga than the genetically modified one.,"But make sure sey your native banga, e plenty pass your agric banga." +"So now, pick up your banga and put it on the flame when I tell you to.","Okay now, carry dat your banga now so wen a don tell you put for fire." +"When you have put it on the flame, within the next thirty minutes, your banga is ready.","When you put am for fire, thirty minutes pakan, your banga, e don done." +"If you are cooking with charcoal, it'll be ready within twenty minutes because of the intensity of the fire.","If you dey use charcoal dey cook, twenty minutes sef, because of di fire, e don done." +"Once your Banga is ready, take it off the fire just as it is and put it in a mortar.","Once your banga done, carry am like dat, put am inside your mortar." +You know that the mortar has a child [the pestle].,"You know sey di mortar, e get pikin." +"Yes, the mortar has a child.","Ehen mortar, e get pikin." +Put your banga in the mortar.,Put your banga inside di mortar. +Pound the banga with the child.,"Use di pikin, take am take beat di banga." +Pound it very well.,"Knack am well, well." +"When you are done pounding, pour water into it and wash the banga with your hand; wash it very well.","When you knack finish, put water inside, take your hand, wash di banga, wash am well, well." +"When you are done washing it, drain the water from the banga, put it in a pot.","When you wash finish, collect di eh eh water for inside di banga, put am inside your pot." +"When you have put it into a pot, set it on your stove.","When you put am inside your pot, carry am on top of your stove." +Let it boil for ten minutes.,Allow am make e boil for ten minutes. +"Once it boils for ten minutes, don’t waste time at all... at all.","Once e dey boil for ten minutes, no waste time at all, at all." +"That pepper that your have ground, put in your pepper.","Dat your pepper wey you don ground so, turn your pepper inside." +Take a little salt.,Take small salt. +Add the salt to it.,Put your salt inside. +"That salt you will add, and the pepper, will make the oil in the banga flow to the top of that sauce.","Dat your salt wey you go put, and your pepper wey you go put, e go make di oil wey dey inside your banga stand on top of dat your soup." +"Now once you have finished doing that, you will wait a little.","Now once you don do dat one finish, you come wait small." +"Add the irogoje, beletete, otaiko, and uh... inyanyan which you have ground together to the pot.","Carry your irogoje, your beletete, your otaiko, and eh your inyanyan wey you ground together so put dem inside your pot." +Let them boil for another ten minutes.,Allow dem make dem boil again for ten minutes. +"Afterwards, check to see if it has thickened a little, hm.","After ten minutes, check am wheder e don dey thick small hm." +"If it's not thick yet, leave it.","If e never thick small, still leave am." +"Then, the next thing you will do is add ground crayfish to it.","Den di next tin wey you go do again, carry your ground crayfish put am inside." +Put your salt in.,Take your salt put inside. +"When you have added the salt, fish is the last thing you will add.","When you put salt finish inside, na your fish e go be di last tin wey you go put." +It's... take your fish... add your fish to it.,"Now, carry your fish put your fish inside." +Let the fish bpil.,Allow your fish make e dey boil. +"Then once it's done, make sure that you're careful when you stir the sauce; don’t stir it just any old way.","Den once e boil, make sure sey when you turn di soup, not turn am anyhow, anyhow o." +"You will stir it slowly, so that your fish will not break into pieces.","You go turn dem small, small so dat your fish, e no go scatter." +"Now, once you've added that, the next thing to add is your bitterleaf.","Now, when you don put dat one finish, di next tin wey you go do now na your bitterleaf." +So get your dry bitterleaf.,So carry your dry bitterleaf. +Put your dry bitterleaf into it.,Put your dry bitterleaf inside. +"When you might have put your dry bitterleaf into the sauce, do not mix it with the spoon again.","When you put your dry bitterleaf inside, not put spoon again o." +"Beacause if you mix it with the spoon, it will become bitter.","Because if you put spoon, di soup, e go come bitter." +So put your dry bitterleaf into the sauce.,So put your dry bitterleaf inside. +Then let it boil for five minutes.,Den allow am make e boil on im own for five minute. +Do not put a spoon into it.,No put spoon inside. +"After five minute, pick up your spoon and stir your banga sauce with it.","After five minutes, carry your spoon, take am take turn your banga soup." +Then let it continue to boil.,Den still allow am make e dey boil dey go. +"Since you're using the locally grown banga, it will not get dry too quickly.","Since na native banga you dey use, e no go quick dry." +"Now, the next thing you will do is... our local pot which we use in Warri.","Now, di next tin wey you go do, na our local pot wey we dey use for inside Warri." +They call it an ewere pot.,De dey call am Ewere pot. +"Wow, it reminded me of my mom and dad at home.","Uhm e don make me remember my mama, and my papa for house." +"Okay, you see your ewere pot, you will put your ewere pot on the stove.","Okay dat your Ewere pot so, you go come carry your Ewere pot, put am on top of your stove." +Heat the ewere pot for a very long time.,"Allow fire make fire beat di Ewere pot well, well." +"When it has been heated up well enough, pick up your spoon.","If fire done beat am well, well, take your spoon." +Take your banga sauce which is yet to thicken up in the pot.,Take your banga soup wey be sey still light for inside pot. +Put it into your ewere pot.,Put am inside your Ewere pot. +Put the fish into it.,Carry your fish put am inside. +Heat up the sauce right inside the ewere pot for three minutes.,Allow di fire make e beat di soup inside di Ewere pot for three minutes. +"After three minutes, take your Ewere pot off the fire and set it on the floor.","After three minutes, carry your Ewere pot, put am for ground." +Then the last thing is your starch.,"Den di last tin, na your starch." +Starch is our local food which we eat the banga sauce with.,"Starch, na our local food wey we take dey chop di banga." +"And that starch, it's made from cassava; the cassava that garri is made with.","And dat starch, e dey get am from inside cassava cassava wey de take dey do gari." +So that your starch... just put the starch in water.,"So dat your starch na, just put your starch inside water." +Get your frying pan and put a little oil into it.,"Carry your frying pan, put small oil inside." +"When you put starch... put enough water which will give you the consistency you want, so that the starch will not be too hard or be sticky.","When you put starch, put enough water wey you go take know sey dis starch, e no go strong, or di starch, e no go too dey light." +The next thing to do is put the starch in your pot.,"Di next tin wey you go do, carry your starch inside your pot." +"When you have put the starch into your frying pan, then continue to turn the starch while it's on fire.","When you carry your starch inside your frying pan, den continue to dey turn your starch inside di fire." +Keep turning the starch.,Dey turn your starch. +It will take only ten minutes for the starch to stick together.,E go take only ten minutes for your starch to gum body together. +"If the starch is ready, bring it down from the fire.","If your starch don ready, carry your starch down." +Get your banga sauce.,Carry your banga soup. +Then enjoy.,Den enjoy yourself. +This story I wanna tell now is about my own life experience.,"Dis story wen I wan give now, na about my own life experience." +My mother and father are...,"My papa, and mama dey..." +"They are from Etsako in Edo State, in Nigeria, where they had me.",Dem na from Etsako in Edo State for inside Nigeria wey dem give birth to me. +"They gave birth to me, but they didn't just have me.","As dem give birth to me, no be me alone dem give birth to o." +There are eight of us.,We be eight in number. +"We were six boys, and two girls.","We con be six boys, and two girls." +"In the process, as you get older, life, it is full of different challenges.","In process, as person dey grow for life, di life, e full of different challenges sha o." +Though it's God who helps us all through.,Though na God na im dey see us through. +"When we were growing up, as young children, when our parents gave... when they gave birth to us, we were strong, and healthy, and we were growing up well.","When we dey grow up, as young children, our parents give us, give birth to us strong, and healthy, and we dey grow up well." +"We played outside, played when coming back to the house, went to school, came back home.","Play go outside, play come house, go school, come back." +"One fateful day, then when I turned seven, I was going to school, we had started writing our final exam to go to the next class.","One fateful day, den when I don reach seven years, wen I take go school we don dey write our final exam to go to di next class." +"I was in primary two then, ready to go to primary three.",I dey primary two then to go to primary three. +I didn't finish my exam.,I no finish my exam. +"It was from there, I got sick and had to come back to the house.",Na dere I for con sick come house. +Then they rushed me back to the house.,De con rush me come house. +Ah!,Ah! +"When my mother saw me, she said no, this one is not the one (Though my father had travelled, he was not around...)... she said this is not a case of self medication.","When my mama con see how my body be, say no, dis one no be di one (though my papa travel, e no dey around), sey no be di one wen e go take put me for house dey do self medication." +Then she swung into action.,She con swing into action. +"With her nextdoor neighbour, they took me to a specialist hospital.","With her oder neighbour, de con carry me go specialist hospital." +"When we got there, they said ""no, uh... this one needs to be admitted straight away.""","When we reach dere, de say no ah dis one na admission straight o." +Then they placed me on admission.,De con put me for admission. +"Then they did a series of surgical operations, even before my father came back from his journey.",Con do series of operation even before my papa con come from journey. +"As he came back from his journey, he said his body gave him signs, so he came back.","As im come from journey say body give am sign, naim come back." +Then he knew that uh... I was hospitalized.,Con really see sey ah me dey on admission. +"Then we really tried everything, it was a battle for almost a year in that specialist...","We con try o, battle o for almost a year for dat specialist." +"Then when they wanted to do renovation, they transferred me to UBTH.","When de wan con do renovation, de con refer me to UBTH." +"They said no, I should go to UBTH.","Sey no o, make I con go UBTH!" +So I was in UBTH.,So I con dey UBTH. +"UBTH also placed me on admission, they did a series of surgical operations on my body.","Ubth con still put me on admission, con do series of operation for my body." +Then...,Con... +"Well, they did a good job.",De try sha. +They brought me back to life.,Sey de fit revive me back to life. +"At the end of the day, even on my sick bed, I was not even praying to live because the pain I was enduring at that time was too much, I was in an awful situation.","At di end of di day, even me on my sick bed, I no even dey pray to even live because di pain wen I dey pass through at dat time dey too much, dey terribly bad." +"So we tried, tried, tried everything.","So we try, try, try." +Even the hospital could not make headway.,Even di hospital no fit make headway. +"Then they said, okay, let's try native medicine.",De con say okay make we try native. +"Then my parents took me to the villages, all sorts of villages.","My parents con carry me go villages, different, different villages." +One guy would bring his own medicine.,Dis one go bring im own medicine. +"Another would would say, ""ah, it's this.",Dis one go say ah na dis one. +"Someone who had this disease took this one... it's this one... it cured him at the time.""","Person wey e sick dis one, na dis one e take cure am one time." +They did all sorts of things.,Dem do different types of things. +Some would say no.,Some go say no o. +You should do a sacrifice.,Na to do sacrifice. +Do all the sacrifice for...,Do all di sacrifice for... +"All these ones I am telling you now, it took us seven years.","All dis one I dey tell you so, e con take over seven years." +So even my parents got tired.,So even my parents con tire. +Even my father got tired.,My papa sef con tire. +He then realised the truth.,E con see as di matter be. +"He said, this one is... it's either I live, or I go to the other side.","E say dis one na, is either I live, or I go di oder side of the world." +Then he said he could not continue anymore.,E con say e no fit anymore. +"Then he moved me from the village to town, and said that whatever happens, we will accept it.","Con move me from village come town say anything wey happen, we go take am like dat." +Glory be to God!,To God be di glory! +"October... (but I cannot remember the exact year now) October... (just after seven years)... a... October second, it was that day [eng that I found my healing eng].","October (but I no go fit remember di exact year now), October (when e just be seven years), October second, na dat day na im I found my healing." +"And this time, I went back to the church.","And dis time, I con come back to di church." +"I will say that for this one, my life is a miracle.","I go say for dis one, my life na miracle." +"You know, I didn't get healed at the herbalist's.","You know, I no find my healing for di herbalist place." +I did not get healed at the hospital where I went.,I no find my healings for di hospital wen I go. +"It was in the church, when we came back to the church, where we were born, which... which is the Roman Catholic Church, it was there I found my miracle, I found my healing.","Na church wen we con come back to di church wen dem born us put which, wen be di Roman Catholic Church na dere me con find my miracle wen I con take find my healing." +"To train a child in fashion design, first we interview them to see how much they know.","To train pikin for fashion, we go first interview di person to know where e go school reach." +Why do we interview them?,Why we dey interview am? +"So that us seamstresses, we'll know where to start with the person.","Make we wey we be di sewing mistress, meh we know where we for start with dat person." +"Because if they're schooled, a small job is what we'll do with them.","Because if na who go school, na small work na im we go do follow di person." +"But if they're not schooled, we'll start from scratch.","But if e no go school, na im be sey we go start from di grassroot." +"For someone schooled, pedalling the machine won't be hard.","Because who go school, to pedal machine, e no go hard am." +Because that's the first process.,Because dat one na di first process. +We will teach them to pedal.,We go teach am to pedal. +"And this pedalling now, it goes in two directions.","And dis pedaling of machine now, na two ways." +"We pedal forward, we pedal backward.","We go pedal go front, we go pedal go back." +Backwards isn't easy at all.,Dat back own no be am at all. +It breaks needles.,Dat one dey break needle. +"But if you're pedalling forward, you will know that yes, you're on the line.","But if you dey pedal go front, you go know sey yes you dey di line." +"And with someone who's educated you know, you will know that yes, it's forward they're pedalling.","And who go school now, you go know sey yes na front im dey pedal come." +"But someone who did not go to school, they'll just be pedalling for pedalling's sake.","But who no go school, e go just dey pedal for pedaling sake." +"But if you look at it, you'll know they're pedalling backwards.","But if you look am, you go know sey na back na im dey pedal go." +"And the way they're pedalling backwards, it won't sew.","And dat back wey im dey pedal go, e no go fit sew." +"But if they're pedalling forward, it's fine.","But if e dey pedal come front, you go know sey yes, na make up." +"For someone who is schooled, pedalling won't be hard for them.","Person be sey im go school, to pedal, e no go hard am." +"But if they didn't go to school, us seamstresses, we'll need to take time to sit down on the machine.","But if e no go school, we wey be sewing mistress, we go need to take time to sit down for machine." +"As we are pedalling, they'll be watching our legs.","As we dey pedal, e go dey look our leg." +They'll know we're pedalling forward.,E go know sey na front na im we dey pedal go. +"But for someone schooled, we don't need to do all this for them.","But who go school, we no need all dose process for am." +"We'll just give 'em a machine and say 'here you go, pedal!'","Na just to give am one machine say take, dey pedal!" +"And if you give them a machine, we will need to remove the needle.","And if you give am one machine, we go need to remove di needle." +"Why we remove the needle that's there is so it won't crack, because if we don’t remove the needle, if it cracks and we put in thread and are sewing, our sewing... our stitchings will not be fine at all.","Why we dey remove di needle wey dey be sey so dat e no go crack dat needle because if we no remove di needle, if e crack dat needle we put thread we dey sew, our sewing, our stitching no go fine at all." +This is why we take out the needle.,Na im make us dey remove di needle. +"But for someone who happens to have gone to school, if they're pedalling forward, we just do a bit of work on them.","But person wey be sey e go school, e dey pedal come front, na small work na im we go do for dat person body." +We'll just take that pedalling work...,We just take dat pedaling work. +"Just, if they're someone really, really smart, we, uh... teaching them the pedalling work... takes maybe a week.","Just, if na person wey clever well, well, we, eh to teach am pedaling work, maybe a week." +"But someone who is not schooled, uh... after a month we'll still be teaching them to pedal.","But who no go school, eh a month, we go still dey teach am how to pedal." +"Like with a kid who's just starting to grow, you'll be teaching him how to eat uh... solid food.","Be like pikin wey newly dey grow, dey teach am how to eat ehn solid food." +"Not milk, not custard anymore.","No be milk, no be custard again." +So let's see...,So meh we see... +That's what makes us ask for someone's level of education before we know how to get into the details with them on our fashion design work.,Na im make us dey ask di level wey di person go school reach before we know how to go in detail wid am for dis our fashion work. +"But if they know how to pedal, that means that we will give them cement paper, or brown paper, we will thread the needle so they can sew with a needle.","But if e don sabi pedal now, na be sey we go give am cement paper, or brown paper, we go put am for needle meh e take dey sew wid needle." +"If they're sewing in a straight line, you know that if you give them cloth as a sample, they will be able to sew straight.","If e dey sew straight, you go know sey if you give am cloth as sample, e go fit sew straight." +"But if they don't sew straight, you'll know that if you give them cloth, or pieces, that they should sew on it, they won't be able to sew very well.","But if e no sew straight, you go know sey if you give am cloth, or pieces sey make e take sew, e no go fit sew well." +"So, that's the thing.",So na im be di thing. +"Ladies, good afternoon!","My women, una good afternoon o." +I hope you have a safe delivery.,I wish una safe delivery. +I want to talk to you about immunization.,I want talk to una about immunisation. +Don't get angry.,Meh una no vex o. +I will take some of your time.,I go take part of una time. +I want to tell you about immunization because there are women here.,I wan tell una about immunisation because some women dey here. +"It's in the village, that's where they are.",Na village na im dem dey. +They will go to the farm.,De go go farm. +They don’t know what they call immunization.,De no know wetin dem dey call immunisation. +But it's good we let you know what immunization is.,But e good make we let una know wetin be immunisation. +"Immunization is when you give birth to a child, you take it to the hospital, to be given an injection.","Immunisation na when you born pikin, you carry am go hospital, go give am injection." +"If we look at our world nowadays, if you have a baby and you fail to get it vaccinated (for instance, BCG is the first one you will take), if you fail to get it a BCG shot, another person will not be able to carry it, apart from you alone.","If we will look our world wey we dey nowadays, if you born pikin, you never give am immunisation (like BCG now, na im be di first one wey you go first take), if you never give am BCG, anoder person no go fit carry am apart from only you." +"But if you get it BCG, everyone else will be able to carry it.","But if you don give am BCG now, every other person go fit still carry am." +That's the first one you'll give it right after birth.,Dat one na di first one wey you first give am just after you born am finish. +"Then, there's another one that will be given again a month later.",Den e still get di one wey de still give her again after one month. +"After a month, they will give it in its hand.","If e don complete one month, you go give am for im hand." +"That one, it will be given to it in its hand.",Dat one you go give am for hand so. +"If any sicknesses come, the child will be able to resist them.","If any sickness dey come, di pikin go fit withstand am." +"Because all this immunization we're talking about, if we don’t get it for our children, that’s what makes some people give birth and say that after a while the child died.","Because all dis immunisation wey we dey talk so, if we no give our pikin, na im make am some go born, dem go say after some time, di pikin die." +They don’t know what killed the child.,Dem no know wetin kill di pikin. +"All these ones, that is what is...","All dis one, na im be wetin dey..." +All this is what makes us say it's good to get our children vaccinated.,Na all dis na im be wetin make us say e good make we immunise our pikin. +"If we look at this immunization, children get vaccinated before they are nine months... one year.","If we look dis immunisation, pikin dey take immunisation go reach nine months, a year." +Even uh... this uh... polio which is getting around which makes a child... you will give birth to a child and it won't walk on time!,"Even ehn dis ehn polio wey e dey waka wey be sey pikin go you go born pikin, e no go quick waka!" +"You will give birth to a child, and he'll look like an imbecile.","You go born pikin, e go be like imbecile." +It's the advantage of...,Na advantage of... +"When you immunize... immunize our children, all these diseases won't get close to your child.","When you go immunize, immunize our pikin, all dese sickness no go near dat pikin." +That's what I want to tell you all.,Na wetin I wan tell una be dat. +Thank you.,Una do well. +Okay.,Okay. +"Uh... first and foremost, right, I was born in Abuja.","Ehn first bah, na for Abuja de born me." +I was born In Wuse General Hospital.,De bin born me for Wuse General Hospital. +"And that was like... that, that was like... around uh... nineteen ninety, yes.","And dat was like, dat, dat, na like around eh nineteen ninety era ehen." +"And since then, I have been in Abuja.","And since den, na Abuja I dey." +I did...,I did... +"I had all my education in Abuja, from primary school to secondary school up to university.","All my school na Abuja from primary, secondary to university." +"Personally, I don't like travelling.","Personally, I no dey like travel." +I don't like being on the road.,Road no be someting wey I dey like like dat. +Uh... but flying... I'm scared of heights.,"Ehn but flight, I'm scared of height bah." +I'm scared.,I dey fear. +"If I climb on anything high, I get really scared.","If I climb anywhere wey high, I dey fear well, well." +"But if I get into an airplane, it used to be fun.","But if I enter aeroplane, dat one dey sweet." +So it looked as if I liked that kind of thing.,So e be like sey I dey like dat kind ting. +But I've been staying in Abuja forever.,But na Abuja I dey troughout. +"So even S-... uh... for my Youth Service program, I did that as well.","So even S, ehn Youth Service sef, na Abuja I do dat one, join." +Uh... we don't really speak Pidgin English in my house.,Ehn Pidgin English no be someting wey we dey speak like dat for my house. +"Actually, we don't speak Pidgin English that much.","Actually, we no dey too speak Pidgin English like dat." +Uh... my mom and dad and everyone... English or... we speak our native language which is... which is Wepawanu.,"Ehn mumsy, pupsy, everybody, English or, our native language wey dey, wey be Wepawanu." +"Because we are from Edo State, Etsako East Local Government, uh... I-... Iyukui, close to Aginnigbode.",Cos na from Edo State I for come Etsako East Local Government ehn I-... Iyukui close to Aginnigbode. +People who travel know the road.,For people wey dey travel de go know di road o. +"Aginnigbode is more popular, you know.",Aginnigbode popular pass ehen. +So those kinds of things.,So dat kind tings. +Bu-... bu-... we don’t really speak Pidgin English.,Bu-... bu-... no be like sey na Pidgin English we dey speak. +"Funny enough, I speak Pidgin English more than any other person in my house.","Funny enough, na me speak Pidgin English pass for house." +"And that's, that's because I joined Wazobia.","And na, na because sey I join Wazobia." +"In fact, when I joined uh... I could speak English more than the others here in Wazobia.","When I actually even come sef, ehn na me speak English pass for Wazobia." +"But later, I had to find a way of blending in.","But later, I gats con fine tune enter di ting." +Uh... I studied history in school.,Ehn na history I study for school. +"So, it wasn't journalism I studied.",So no be actually sey na like journalism I read. +"But later, I started reading up on it.","But later, I con dey read up on am." +And I was taking other courses related to journalism.,And I dey take oder courses wey relate to journalism. +But since I studied history... it's a common saying that history is the mother of all courses.,"But since na history I read, de say history na moder of all courses." +So that one... it's easy to blend history with other courses.,"So dat one, e dey easy for person to take blend history wit any oder course." +So that's why it was easy for me to go with the flow.,So na why I just flow enter di matter like dat. +"Then, research is something I like.","Den, research na someting wey I dey like." +"So most times, I like to read on so many things, places, people, events and things.","So most times, I dey like read up on plenty, plenty tings, places, people, events, and tings." +So it is... it's really helpful.,"So e dey, e dey really help." +"And about this job, well, it... it's really fun.","And for dis kind job, e, e dey funny sha." +"When you come across some vocabularies in English, you will try to translate it into what people who speak Pidgin will understand.","When you dey see big, big English, you go try con translate am enter di Pidgin wey people go fit understand." +"Actually, that's the hardest part when we are trying to explain something very important.","Actually, dat na di hardest, hardest part wey we dey try explain someting wey dey very important." +But you'll try to make people who don't know much about it understand and not misinterpret it.,"But you go like make people wey no too know about am, make de know am, and make de no come misinterpret am." +Just like English where one word can mean five different things.,Just like English wey people go get like one word for five different tings. +"For instance, we were talking about 'Theater' today.",Like today sef we dey talk theatre. +We have 'Theater of War' for those in the military; 'Theater' where they watch movies; 'Theater' where they act.,"We get theatre of war for military people, theatre wey de dey watch film, theatre wey de dey act." +Uh... we will even talk about the 'Gallery'.,Ehn we go even talk gallery. +A gallery is an upper floor in a building where people can look down.,Gallery na upstairs for building wey people would fit look down. +"Yes, a gallery is a place where someone can look at pictures.",Ehen di gallery na where person fit go look picture. +"Yes, so just like that, words have different meanings in Pidgin English.","Ehen so just like dat, Pidgin English get different meaning." +"You can say, ""uhuh?""",Person fit talk ehen? +"""Uhuh, uhuh!""","Ehen, ehen!" +And it's the same 'uhuh'.,And na still one ehen wey di person talk. +"But that 'uhuh' means different things, depending on how you use it.",But dat ehen means different tings depending on how you take use am. +So all those things are what you'll look into.,So all dose tings na wetin person go look. +"Then also, uh... speaking of the working hours, this is a child friendly hour.","Den also, ehn giving di time belt wey person dey work now, dis na children friendly hour." +It's the office hour.,Na office hour. +So there are some things you can't say on air around this time.,So de get some kind tings wey person no fit talk on air around dis type of time. +But there are some sensitive topics someone would like to talk about.,But de get some kind sensitive topics wey person go like treat. +"But you have to be mindful of the time you're talking about it, and what people want to hear from that topic.","But you gats dey mindful of di time wey you dey treat am, and wetin people wan hear from dat topic." +"Then there are some words you... you will need to come up with words because just like you coin words in English, when you can uh... pick one word and use it the way you can.","Den de get some kind words wey you, you go con form because just like English wey get coinage wey you fit eh pick one word and use am di way wey you fit." +They say everyone is their own...,De say everybody na im own. +"Uh... you're the creator of your own English, right, but in Pidgin, if you create a word, you have to be very careful because there's a limit to how you can use it.","Ehn you be your own creator of your own English ehen, but for Pidgin, if you create one word, you gats dey careful because de get how you go use am reach." +"Before you know it, someone will start using it.","Before you know, person go start dey use am." +People will start using it in scripts.,People go start dey use am for script. +"Before you know it, that word which you think will... is not acceptable may later turn into something else.","Before you know, dat word wey you tink sey go, e no sell later, e fit con turn anoder ting." +"So uh... that's it and uh... since Wazobia can be referred to as the people's station, most popular station in Nigeria (and not just Nigeria, even here in the North), right, people... people listen to us a lot.","So ehn na di ting and eh since Wazobia na like di people station, most popular station in Nigeria, and not just Nigeria, even in di North here, ehn people, people dey listen to us well, well." +"So some, some words we coined have turned to lingo in the streets, everybody uses them now.","So some kind, some kind words wey we don start don come turn lingo for street, everybody don dey use am." +So all those things are inclusive.,So all dose tings still take follow join. +"Yeah, but in Pidgin English, the version we speak here in Abuja is different from the one you'll hear in Port Harcourt, the one you'll hear in the western areas.","Ehn but for Pidgin English sha, di one wey we dey speak for Abuja here different from di one wey you go see for Port Harcourt, di one wey you go see for di western side." +"Like most versions of Pidgin English here in Abuja, you will hear most of the things which...","Like most Pidgin for Abuja here, you go dey hear most tings wey..." +"For instance, if someone wants to use exclamation words, you want to like... what you'll say is ""kai!""","Like if person wan talk exclamation now, you wan like, you go say na kai!" +"But that's... that's a Hausa word because we're in Abuja, yeah.","But dat's, dat, na Hausa word because sey na, na Abuja we dey ehen." +"But in other places, they can use maybe Yoruba words, or they infuse some Igbo words to make it exciting.","But for oder places, de fit use maybe Yoruba, or infuse small Igbo make di ting dey for sweet bottom." +That’s how we speak it here.,Na so we dey take speak am for here. +"Yes, I do travel.",Yes I dey travel. +I won't say I travel the most.,Make I no talk sey na me travel pass o. +I don’t like the road.,I no like road. +"Ah, we don’t have an airport which will lead to my village directly.",Ah we no get airport like dat wey go lead to my village so. +"Even from, from Garki to Gwagwalada also, I'll sleep the whole way, not to mention Abuja to Benin, I mean... or Edo State.","Even from, from Garki, to Gwagwalada sef, I go sleep throughout, talk more of Abuja, to Benin, ehn or Edo State hm." +"So... but I do travel, like once in a while.",So but I dey travel like once in a while. +"For instance every year, at least... I try to, at least, once I get to... I get to my state, I spend something like two weeks... three weeks before I X leave.","Like every year, at least, I dey try sey at least once I dey enter, I dey enter state like two weeks, three weeks before I X comot." +"Well, they...","Well, de..." +"Okay, myself, I'm... I'm someone who likes to get into lots of things because I don’t believe you're supposed to just uh... be on just one thing in life.","Okay me I be, I be person wey dey like put hand inside plenty tings because I no believe sey person just suppose ehn dey one ting throughout your life." +There's a saying that the average billionaire has more than five jobs.,De talk sey eh di average billionaire get more dan five job wey im dey do. +"And myself, I'm still young.","And me, I still young." +"So if the average billionaire has five jobs, then I wanna have six or seven jobs.",So I go like get like six to seven wey I dey do if average billionaire fit get five. +It'll be good to have seven or eight.,"E go good if I get like seven, eight." +"So I won’t be average, you know.",So I no go dey average ehen. +So it'll be good to get involved in lots of things.,So e good to chook hand inside plenty tings. +But I've been into entertainment for a long time.,But entertainment na di ting wey I don dey into since. +Even though I've been involved in the arts.,Even dough na arts I dey. +"Actually, I wanted to study fine arts.","Before sef, na even fine art I be wan read." +But because I was sluggish that particular year.,But because dat year I dey draw. +"Later, from there, I went into the commercial class.","Later from dat one, I come enter commercial class." +I had wanted to be an accountant.,Na accountant wey I for wan like be. +"But mstchew, that did not work out.",But mtschew dat no come work out. +So I'm a historian.,Na historian I come be. +"But all these things revolve around what has been going on since my secondary school to the university, to becoming an MC, master of ceremony, and a comedian.","But all dese tings still dey revolve around wetin dey from talking from secondary school, to inside university, to becoming an mc, master of ceremony, compare comedian." +All those ones are also included.,All dose ones still take follow join. +But I realized that all these things are pushing me towards my destination.,But I come realise sey all dese tings dey push me towards where I still dey go. +"So at the end of the day, artist management... talent management... they are things I enjoy.","So at di end of di day, artist management, talent management, na someting wey I really dey enjoy." +"Event consulting and management and also event planning, those are things I also enjoy.","Event consulting, and management, and also setting up events, dat na wetin me, I dey also enjoy." +"I also enjoy editing, I al-... also enjoy movies.","I also enjoy editing, I dey al-... also enjoy movies." +I'm someone who really loves watching movies.,"I be person wey like film well, well." +There's no movie I don’t like watching.,"De no get film wey (if I see), wey I no like watch ehn." +And I like talking about it.,And I dey like talk about am. +So I'm good.,So I dey. +Anything that revolves around entertainment is something I like getting involved in.,"Anyting wey revolve around entertainment, na someting wey I dey like put hand into." +"From inst-... from fashion to music, to dance, comedy... as long as it's entertainment, I'm supposed to be involved.","From inst-... from fashion o, music, dance, comedy, as long as sey na entertainment, my hand suppose dey inside." +That’s what I believe.,Na wetin I believe. +So I must be involved.,So my hand must dey inside. +"Then, I also love to talk.",Den I dey also like talk. +I don’t like talking for no reason.,I no dey like talk for talking sake. +Everyone has a purpose in life.,Everybody get purpose for life. +And I try to make sure that anything I pull out from... whatever comes out of my mouth must impact someone.,"And I dey try make sure sey anyting wey I comot from, anyting wey go comot from my mouth must impact person." +There's a saying that there's something useful in a seemingly useless thing.,"De dey talk sey in everyting wey, wey no serious, seriousness dey." +It is said that there is sense in all nonsense.,"De say in every nonsense, sense dey." +I like making more sense than nonsense.,I dey like meh my sense dey pass in nonsense. +"So at least, if someone listens to you once, the impression they will have of you... because they say a first impression lasts forever, so I like to make sure that my first impression is a good one.","So at least, if person hear you once, dat impression wey di person go get, because de talk sey first impression, na im dey last pass, so I dey like meh my first impression be good impression." +Good morning!,Una good morning o! +I'd like to say hi to you this morning.,I say make I greet una dis morning. +"I am Awa Olowookere, Assistant Co-Commander; the Unit Commander of Isolo, for the Federal Road Safety Corps.","I be Awa Olowookere, Assistant Co-commander di Unit Commander Isolo for Federal Road Safety Corp." +"Road Safety Corps members are the people who stand on the road, who you see on the road, who get you pissed off if you notice that they stopped you on the road.","Road safety na dose people wey dey for road, wey una dey see for road, wey una dey vex if una see dem dey stop una." +"But now, that's not the only thing we do.","But now, no be di only ting wey we dey dey do." +Our duty in the Road Safety Corps is to teach road users.,Our work for road safety na to teach people wey dey use road. +And we are all road users.,And na everybody dey use road. +So we make sure that we get from the office to the churches and mosques.,"So we see sey we dey go from office, to churches, to mosque." +We go talk to people about safety on the road.,We dey go talk to people about road safety. +We tell people all the things they're supposed to do... which they need to do in to make sure that their vehicles are ready to drive on the road.,"We dey tell people all di things wey dem suppose do, wey dem need to do to make sure gbe sey deir motor e ready for road." +Because not all vehicles are road worthy.,Because no be every motor person suppose carry to enter road. +You could have abandoned a vehicle for some time; the vehicle is just parked there while you travelled.,"You go don leave motor for some time, di motor dey dere, you park am, you travel." +"When you come back, you walk up to the vehicle, wash it, turn the engine on and off you go.","When you come back, you just come, you wash am, you on your engine, you move." +"When you get to so-... the road, the vehicle will stop and you will start complaining.","When you reach so-... road now, di motor go stop, you go begin complain." +That's what we are talking about.,Na wetin we dey talk be dat. +"So before you move your vehicle in the morning, you're supposed to check it out.","So before you move your motor for morning, you suppose check." +There are some things you're supposed to check.,Some tings dey wey you suppose look. +"You're supposed to check the radiator, check the water level in it.","Suppose check di radiator, check di level wey your water reach." +You'll check the oil.,You go check your oil. +"You should check if the vehicle is due... if it's due for servicing, or if the oil is still... (there's uh... something we call viscosity) you will feel the, the, the viscosity of the oil to know if it's still high enough to use your vehicle.","Make you look wheder dat motor even due, if e don due for service, or wheder di oil still (e get ah wetin we dey call viscosity), wheder di, di, di oil still soft wey you go feel dey carry you." +Because if you don’t check all these things...,Because if you no look all dese things... +Check your tires.,Check your tyre. +You know something?,Una know one thing? +The tire is the only part which makes contact with the road.,Di tyre na dat thing wey only im dey touch di road. +"As you sit in the vehicle, the tire controls the vehicle, it makes it move.","As you dey inside dat motor, na tyre dey control di motor wey dey make am move." +"Because, you know, motor vehicles are made of iron.","Because you know, motor na iron." +The iron parts alone cannot move.,"If you leave only di iron, e no go move." +So we're telling you that you need to check your tires.,So we dey tell una sey you need to check your tyre. +"Before you buy tires, look at the manufacturing date.","Before you buy tyre, look di date of manufacture." +You won't see an expiration date on tires.,You no go see expiry day for tyre o. +It's the manufacturing date... the day the tire was made.,"Na date of manufacture, di day wey dem make dat tyre." +"So when you look at the day, you wit-...","So when you look di day, you wit-..." +The first two numbers on the tire...,Di first two number wey dey for dat tyre... +You'll see four numbers but the first two numbers are for the week that the tire was produced.,"Na four number you go see, but di first two number na di week wey dem produce dat tyre." +Then the last two numbers will tell you the year.,Den di last two number go tell you about di year. +"So if you see a tire which was made... which you... that says one one fourteen, that means the tire... that tire was produced in the eleventh week of twenty fourteen.","So if you see tyre wey dem make, wey you, wey dem write one one fourteen, dat means sey na in di eleventh week of twenty fourteen na im dat tyre, dem make dat tyre." +So you will add four years.,So you go count four years. +That will tell you the expiration date of that tire.,Dat go tell you when dat tyre go expire. +So you need to be checking your tires.,So you need to dey check your tyre. +"Don’t just look at the physical appearance of the tires to decide that uh... it's in good shape, this tire is still road worthy, it's a good tire.","No just take eye look tyre say ah di teeth still sharp, dis tyre clean well, well, na good tyre." +No!,No! +Check your tires!,Check your tyre! +"And when you go, if you want to uh... check your tires, look at your car door.","And when you go, if you wan eh check your tyre, look di body of your door." +"If you open the door, you will see the side of the door.","If you open your door, you go see di side of di door." +An iron which is called metal is right on the door.,E get one iron dere wey dem dey call metal. +You will see the pressure expected to be in each of your tires there.,You go see di tyre pressure wey each of your tyre suppose carry. +And that limit is what you're supposed to inf-... pump air into... pump your tire to.,"And na dat limit you suppose inf-... put air for inside, pump your tyre." +"So if you inflate your tire within... with the limit indicated on those instructions, it will be good for you.","So if you pump your tyre within, with limit wey dey for dat instruction, e go help you." +"So you won't have the problem of your tire being over... you over-inflating your tire, meaning that there is too much or too little air in it.","So you no go get case of sey your tyre over-... you overinflate your tyre, sey air too plenty inside, or e too low." +"Because if there is too much air in a tire, there is...","Because if air too much for tyre, e get..." +"Ah, you know how it is with a balloon.","Ah you know as blow, blow dey be now." +"If you blow it up... blow it up... blow it up and you just touch it with a sharp object... any sharp thing, what will happen?","If you blow am, blow am, blow am, if you just carry sharp object, sharp thing touch dat blow, blow, wetin go happen?" +It will burst.,E go burst. +"And then we will be shouting, ""ah, the tire has burst, the tire has...""","Naim we go dey shout ah tyre don burst o, tyre don..." +"Something made the tire burst because as the tire is moving on the road, it gets heated up.","Na something make dat tyre burst because as e dey move for road, e dey hot." +And the road gets hot too.,And di road dey hot. +Our weather affects it as well.,Our weather again dey affect am. +"So putting all these things together, and when you go into a ditch, pah!","So all dese things put togeda, and when you go enter gallop, pah!" +"Little do you know that this tire is no good anymore, you will go a little ways more and it will burst.","You no know sey dis tyre don get mark, but when you reach front, e go burst." +So in the... you need to put the tire... inflate the tire to the correct level.,"So in di, you need to put your tyre, put air for di tyre wey go measure up." +"And again, if your tire's deflated (that's what we call under-inflation)... under-inflation also affects tires.","And again, if your tyre don less (na one wey we dey call underinflation inflation), underinflation too dey affect tyre." +"It disturbs tires because when you put loads into your car and you enter into the tire... the car, it will press on the tire.","E dey worry tyre because when you carry load, when you enter inside di tyre, di motor, e go press dat tyre." +"And you, you see that the tire is coming apart on both sides.","And you, you see sey di tyre dey chop for di two sides." +"If you blow too much air into it, it will come apart in the middle, but if you...","If you blow am too much, e go dey chop for di centre but if you..." +"You know the air... if there's not much air in the tire, it will be coming apart in the, the...","You know di air, di air inside no plenty, e go dey chop for di, di..." +"If you notice that the two sides of your tire are getting smooth, you will say, ""imagine, I just bought this tire and it's getting smooth.""","See sey di two sides of your tyre go dey smooth, you go say aha dis tyre, I just buy am, e just dey smooth." +The air in your tire is not up to the correct level.,"Di air wey dey inside your tyre, e no reach." +So you're supposed to check your tire so it doesn't over-inflate or under-inflate.,"So you suppose check your tyre make e no overinflate, or under-... inflate." +"Another thing we tell people is if you must drive, if you have to drive a car (you have bought a car and you have a license), don't drink alcohol, alcohol, all brands of distilled liquor, all these drinks which are being sold by the roadsides.","Anoda ting wey we dey tell people, if you must drive o, if e be sey you must drive motor (you don buy motor, you get licence), make you no take alcohol alcohol, all dis ogogoro, all dis tings wey dem dey sell for road." +Because those drinks contain things which have different effects on the human body.,Because dose things get things wey dey affect person for body. +"If you're... if you drink alcohol, your vision will be different from somone who isn't under the influence.","If you are, if you take alcohol, di way you go dey see go different from person wey no dey under any influence." +It will affect you.,E go affect you. +"You could be looking straight ahead and see nothing, even though someone has come out in front of you.",You fit dey look front now say noting dey whereas somebody don enter your front. +A bicycle has... someone riding a bicycle has caught up with you.,"Bicycle don, person don ride bicycle enter your front." +You won't see them because you've drunk something that stops you from seeing clearly.,You no go see am because you don take something wey dey prevent you from seeing well. +"And if you are driving, you're supposed to... you... you...","And if you dey drive, you suppose, you, you." +"We, we do have a saying.","We, we dey get wetin we dey say." +"You drive with your eyes, and see with your mind.","You drive with your eye, and see with your mind." +"If you're driving a car, you are the one... you are seeing [with your eyes] but it's your mind that's calculating everything.","If you dey drive motor, na you you dey look o, but na your mind you take dey calculate everyting." +"This one, they call it Igue Festival.","Dat one, de dey call am Igue Festival." +Igue Festival is what they call it.,Na Igue Festival de dey call am. +"So, it's the Edo people.",So na di Edo people dem. +They're the ones who do this festival.,Na dem de do dat festival. +"It's towards the end of the year, after Christmas, between Christmas and the New Year, around the twenty seventh, twenty eighth of December.","Na towards di end of di year, after Christmas, between Christmas, and New Year, dat kind, twenty seven twenty eight of December." +Uh... that’s when they do the festival.,Ehen na dat time de dey do di festival. +"So, all the Edo people who have moved to different places, everybody will head back home.","So all Edo people wey don travel go different, different, different places, everybody go con travel come back." +"This festival, they do it to thank the gods of Edo land for all the good things they've done, for the good harvest, for bringing the people peace, giving the people good health, you know.","Dat festival, de dey use am take dey tank di gods of Edo land for all di good tin wey de don do, for good harvest, for sey de give di people peace, de give di people good health you know." +"So they have to do that festival every year, to thank the gods.",So de must do dat festival every year to tank di gods. +"So, many things happen before the festival.","So many, many tins dey happen before di festival." +"Ah, a lot of preparation goes into it.","Ah many, many preparation." +It's no small thing.,No be small o. +"Everybody will go to the market, buy food, fill the house with food.","Everybody go go market, buy food, full house." +Rice.,Rice. +Goat.,Goat. +"In fact, it's goats we slaughter for that festival.",Infact na goat na im we dey kill for dat festival. +Yes now!,Yes now! +"For that one, mostly, it's the children who eat rice.","Dat one, na children mostly go eat rice." +But the main food is pounded yam.,But di main food na pounded yam. +"Pounded yam, and egusi soup.","Pounded yam, and egusi soup." +"A hot, hot one.","Hot, hot one o." +"Ah, pounded yam, that's the main food.","Ah pounded yam, na im be di main, di main." +"So, before the festival, everybody will start to cook.","So before di festival, everybody go begin prepare." +"People whose house, has... all the paint has fallen off, we paint our houses again.","Dose wey deir house don, all di paint don spoil, we con paint our house again." +"Then we'll wash everywhere in the house, uh... clean up the whole place.","Go con wash everywhere inside di house, eh clean up di whole place." +It'll be spotless everywhere.,Everywhere go dey shine. +"Then we'll buy new clothes, and new shoes for the kids.","Den we go buy new clothes, and new shoe for children." +"Even if the adults couldn't buy anything so far, they'll buy for the children.","Even if adult no fit buy, so far, we go buy for children." +"Then, before the day of the festival or so, there is a particular leaf.","Den before di day of di festival like dis, e get one leaf." +"That leaf uh... where it is in the bush, in fact, only God who knows where that leaf is.","Dat leaf eh, for where e dey inside bush, in fact, na only God know where dat leaf dey." +"There are some people who go far, far inso... into the bush.","E get di people wey dey go far, far inso-... into di bush." +They call the leaf Ewere leaf.,De dey call di leaf Ewere leaf. +"That leaf... that leaf, they say it represents peace.","Dat leaf, dat leaf, de say e signify peace." +So the uh... Benin people consider it a leaf that represents peace... which shows peace.,"So di eh Benin people dey look am sey na leaf wey signify peace, wey dey show peace." +"So they will go and pluck that leaf, cut it into very small pieces, put it into a calabash, pour water on it.","So de go go pluck dat leaf come, con cut am into small, small, small, small pieces, con pack am put for inside calabash, pour water inside di leaf." +"Then, the Oba of Benin will pray on top of that calabash.",Den di Oba of Benin go con pray on top of dat calabash. +"So on the day... the, the, the... early in the morning of that festival, even before we wake up, around four or five, so peo-... some people will carry the leaf around the whole of Benin from house to house.","So on di day, di, di, di, di early morning of dat festival, before we go even wake up sef, dat kind four, five, so peo-... some people go con carry di leaf enter di whole of Benin from house, to house." +"Any house, any compound which they get to like this uh... they will start knocking.","Any house, any compound wey de reach like dis eh, de go begin dey knock." +"If there is a gate, they will start knocking on the gate.","If de get gate, de go begin dey knock di gate." +They will be singing as they come.,De go dey sing dey come o. +There will be a band playing.,De go dey play band. +Let me sing the song for you.,Make I sing di sing for you. +Ah! I like that song!,Ah I like dat sing eh. +"When I was a little kid, ah! That song was great.","When I be small pikin, ah dat sing dey trip." +I'll tell you.,I go tell you. +Wait first!,Wait first! +Just listen first!,Just dey listen first! +That’s how they'll be singing it when they're coming.,Na so de go dey sing am dey come. +"Once you hear that song uh... no matter how deep you're sleeping, or how you dream, you just have to wake up.","Once you hear dat sing eh, e no get how di sleep deep, or how di dream be eh, you go must wake up." +You will open the gate for them.,You go open di gate for dem. +"They say, ""ah, Ewere is coming!""",De say ah Ewere dey come o! +"""Open the gate to...""",Make you open gate for... +"""Open your door to Ewere.""",Make you open your door for Ewere. +"You know that that the Ewere leaf is, is peace.","You know sey dat Ewere leaf na, na peace." +That’s what it means.,Na im e mean. +So you must open up.,So make you open. +Peace is coming to your house!,Peace dey come your house o. +"Open up, let peace come in!","Make you open, make peace enter." +"So they sing, praising the god of peace.","So de dey sing, dey praise di God of peace." +"So as you open your door to let them in, it's like you accept peace, and you accept the God of peace, and peace will be in your house.","So as you open your door meh de enter so, e be sey you accept peace, and you accept di God of peace, and peace go dey your house." +"So for the following year, you have already settled your peace.",So for di following year so you don ready settle your peace. +So everybody will quickly open their door.,So everybody go quick dey open door. +"They will come inside, start sprinkling the water from the leaf.","De go come inside, begin sprinkle di water di leaf." +So you'll be trying to make sure that at least one drop of the water touches your body.,Na so you go dey hustle make at least one drop of di water touch your body. +You will bring out all the children.,You go dey carry all di children come. +They will be sprinkling the water.,De go dey sprinkle di water. +"The leaf, everybody will (even if you got only one)... will hang it on their door where all the evil spirits will see it.","Di leaf, everybody go (even if na one you see), go hang am for your door where all di evil spirit go dey see am." +"So when they come and see the Ewere leaf like this, they will run away saying, ""guys, this house is a no go area!""","So when de come, de see di Ewere leaf like dis, de go run comot say mehn dis house na no go area o." +"Different... different people, will carry ca-...","Different, different people now, de go carry ca-..." +"You know that Benin is big, right?",You know sey Benin big now? +Uhuh!,Ehen! +"There are different... different areas, yeah.","Different, different area ehen." +"So, maybe people from the palace or... they will come, they will be spreading the thing.","So maybe people from di palace or, de go come, de go dey spread di thing." +So it is very interesting.,So e dey very interesting. +That one is in the very early morning of the day of the festival.,Dat one na di very early morning of di day of di festival. +"Then there are some rituals which the Oba will perform in the palace, you know, by noon... in the afternoon.","Den e get some rituals wey Oba go perform for palace (you know) by noon time, by afternoon time." +"So, everybody will start slaughtering their goats.",So everybody go con begin kill deir goat. +"They have some kinds of incantations, some kinds of thing they will do.","E get some kind incantation, some kind ting wey de go do." +"They start slaughtering the goats, then they begin pounding yam.","Begin kill di goat, den begin pound pounded yam." +They will then begin serving the food.,De go con begin serve food. +"That one, to me, is the sweetest part.",Na dat one dey sweet me pass. +"They start serving the food, taking some to relatives, giving some to friends, neighbors.","Con begin serve food, carry go give relations, go give friends, neighbours." +"And you know, when we were young, any child who brings food to your house like that, you must give him money.","And you know, dat time wey we small, any pikin wey carry food come your house like dat, you go must give am money." +"So we really liked doing it because the number if houses you take food to, you will...","So we dey like to do dat one well, well because di number of house wey you carry food go you go..." +It means that the amount of money you'll collect that day won't be small.,"Na im be sey, di money wey you go collect dat day no be small." +"So, there will be plenty of food.",So food go berekete. +We will eat really well.,"We go chop well, well." +"And relatives who have come from different places, you know, will be around.","And relations wey come from different, different places (you know), de go dey around." +The music will be loud.,"Music, e go dey blow." +"We will be dancing, you know.",We go dey dance you know. +It is very interesting.,E dey dey very interesting. +"Then the Oba of Benin will, will address the people, those who went to the palace.","Den di Oba of Benin go, go address di people dose wey go palace o." +"He will address them, you know.",Go address dem you know. +"He will tell the people how to... how we should behave, even the kinds of things we will do so that uh... the gods will not get angry with us.","Tell di people how to, how we go take behave, even di kind tins wey we go do so dat eh di gods no go dey angry with us." +"You know, all those kinds of things.","You know, all dose kind things." +That period uh... no markets will be open!,"Dat period eh, no market go open o." +Nobody will... nobody will...,"Nobody go, nobody go..." +"In fact, it’s even against the law to open the market, to sell a single thing.","In fact, na even against di law sef sey you go go open market, sey you dey sell one thing." +"All shops, everywhere, will close down, yes, so that it wants to... you want to respect the gods during that period.","All shops, everywhere, e go close down yes so dat e want to, you want respect di gods for dat period eh." +"But these days now ah, the Church has been preaching against all those kinds of things o.","But dese days now ah, Church don dey preach against all dose kind tins o." +Uhuh.,Ehen. +The Church has been preaching against it.,Church don dey preach against. +"They say all those kinds of things are... are rituals, are the Devil.","De say all dose kind tins na, na ritual, na Devil." +People use all those kinds of things to worship him.,Na im people dey use all dose kind tin dey serve. +"So as people are becoming Christians now, the festival doesn't carry as much weight as before.","So as people don dey become Christian now, so di festival no dey carry like dat again." +But they are still doing it!,But de still dey do am o. +They are still doing it.,De still dey do am. +"Every year, they have to do it.","Every year, de must do am." +"So that's how the festival is, very, very, very interesting.","So na so di festival be very, very, very interesting." +"Ah if, if you... if, if, if you want to witness it uh... around the twenty seventh, twenty eighth, just come to Benin.","Ah if, if you, if, if, if you want witness am eh, during dat kind twenty seven twenty eight, just come Benin." +Come and see the festival.,Make you con see festival. +Very interesting.,Very interesting. +"Even the masquerades, they are coming out.","Masquerade sef, de dey come outside." +Hey now!,Eh now! +"You will... you can come now, no problem.","You go, you fit come now, no problem." +Masquerades will come out.,Masquerade go come outside. +Ah they will be dancing.,Ah de go dey dance. +But women don’t get close to masquerades!,But women no dey near masquerade o. +They sure don't!,No o. +"If you get close to masquerades in Benin lands, as a woman, they could flog you.","If you near masquerade for Benin lands, as a woman, de fit flog you." +So it's taboo for women to go.,So na taboo for woman to go. +So it's from a distance that... that women look at them.,"So na from distance na im, na im women dey look dem." +"Uhuh, but men can get close to them.",Ehen but men fit go near dem. +Because they see those uh... masquerades as uh... the representatives...,So because de dey see dose eh masquerade as eh di representative... +They see them as spirits.,De dey see dem as spirit. +They see them as the god... the spirits which the gods sent to bless us.,"Eh de see dem as di god, di spirit wey di gods send come con take bless us." +So we can't just go near them.,So we no fit just go near dem. +"Ah, they respect them very well.","Ah de respect dem well, well." +"So once the masquerades dance out like that, you will see how people throw money at them.","So once di masquerade dance come out like dat, you go see people go dey throw money give dem." +They throw money at them.,De trow money give dem. +"As they are throwing money at them, as if they are asking for prayers, they are asking for blessings.","As de dey throw money give dem so, e be sey de dey ask for prayer, de dey ask for blessing." +"There was one lady, she just went into the shop.","E get one lady, hm she just enter inside shop o." +Then she said she wanted to do facials.,Naim she say she wan do facials. +"I now told her ""okay ma'am, you need to steam your face.""","I con tell her sey okay madam, you need to steam your face." +"She said ""ah! what do you mean steaming?""",She say ah wetin be meaning of steaming? +"It's where we use a bath and get into it, put her face inside, uh... put her face inside.","Shey na di one wey we go use ehn bath take enter inside, ehn put her face inside." +It's a shame for that woman!,Na wa for dat woman o! +Where is she from?,Where she comot from? +I don't... I don't know.,"I no, I no know." +Which village is she from please?,Na which village she comot from abeg? +I don't know where she came from.,I no know where she comot from o! +Mstchew!,Mstchew! +Then I took her to the spare room.,I con gast carry her go di spare room. +"Then, I explain to her ""see how the machine is, it will steam your face.""","Come explain to her sey see how di machine be, you go steam your face." +"She said, ""ah! Why?""","She say ah, why?" +"She hasn't seen steaming, uh... the way they do facials on television?","She no dey watch steaming ehn, di way dem dey facial for inside television?" +She hasn't seen it.,She no dey watch am o. +It's a shame.,Na wa for her o. +So I showed her that this is how smoke will be coming out.,Naim I con show her sey okay see smoke go dey. +"She said ""ah, you! Do you want to burn my face?""","She say ah dis one, you wan burn my face?" +"I said, ""ma'am, no. It's just...""","I say madam, no be so, na just..." +It's an extractor.,Na extractor. +You didn't tell her it was an extractor?,You no tell her sey na extractor dat ting be? +"Haha, I told her... I told her the thing was an extractor.","Haha I tell, I tell her sey na extractor di ting be o." +It's a shame.,Na wa for her o. +Which level is she now?,Which level she dey now? +Now I explained to her.,I con explain to her. +Now she said let...,Naim she con say make... +"Then I told her to calm down because the smoke is just steaming, the thing will just steam her face.","I con tell her sey make she calm down, sey di smoke na just steaming, di ting go just steam her face." +It's to remove all that dirt on her face now.,"Na to comot dose yama, yama wey dey her face now." +"Yes now, it...","Ehen now, na, na..." +It's a shame.,Na wa for her o. +Mstchew.,Mstchew. +"Then I explained, explained, explained.","So naim I con explain, explain, explain." +I used the best English I could.,I use all di whole grammar wey dey dis life o. +Must she even do the facial now?,Must she even do di facial now? +Is it to show off?,No be yanga she wan do? +It's pride for her husband now.,Na yanga o for her oga now. +It's a shame.,Na for her o. +"So her husband will see that her face is bright, that kind of thing.","So dat her oga go just see her say her face dey bright, dat kind ting." +Her husband will leave all those small small girls he follows right?,"Her oga go leave all dose small, small girl wey e dey follow abi?" +That is what we do and do it.,"Naim we sha do, do, do am." +"Then I explained everything I could, I used my best English every which way.","I con speak all di whole grammar, grammar, speak all di English upside down." +"Turned it, turned it, turned it.","Turn am, turn am, turn am." +Hey!,Hey! +"At last, she agreed.","At last, she con gree." +Let me give you the gist about what happened with me today.,Make me con gist you wetin happen for my own side today now. +What happened?,Wetin con happen? +"The day I was doing nails, one girl came from the village.","Di day wey I dey do nails, one girl come from one village." +She was pretending to be a city girl.,She con dey form sey she be city girl o. +Sit down and let me do your nails for you!,"Sit down, make I do your nails for you!" +These girls were snubbing me now.,Dis girl con dey form level for me o. +Aha!,Aha! +"I now told her, ""lady, which style do you want to do now?""","Naim me con tell her sey babe, which level you dey now?" +Then she showed me this one type of manicure on Instagram she wanted to do.,She con show me one nail for Instagram say na dat nail she wan do. +Do you know who did the nails?,You know who do di nail? +Who did them?,Who do am? +Tonto Dike.,Tonto Dike. +Hee!,Hi! +"She said she liked the nails, she was into that long one.","She say she no, she like di nail, na friendship for dat long one." +"Then I told her, ""lady...""",I con tell her sey babe... +A very long one!,A very long one! +Then she was looking at me like I don't know nails.,"She con dey look me like sey eh me, no sabi di nails." +"Then I told her, ""lady, I know hairdressing, I know this work. I wasn't hired to do this work today.""","I con tell am sey babe, I sabi dis hair, I sabi dis work o, no be today dem don employ me for dis work." +"So, when I told her that, she said okay, I should do the manicure for her.","So as I con tell her dat talk, she con tell me sey okay, make I do di nails for her." +Now she was bargaining.,She con dey price o. +"A manicure that we do for two thousand, she said she was going to pay eight hundred for.","Nails wey we dey do two thousand, she con tell me sey na eight hundred she go pay." +I said oh yeah?,I now say shu! +Oh yeah?,Shu! +Where are you from now?,Where you comot from now? +"Lady, we don't do that kind of manicure in this shop.","Babe, we no dey do dat kain nail for dis shop o." +Don't you know that our shop is a standard one?,You know sey our shop standard. +Uhuh!,Ehn! +"Then she said that she doesn't have enough money, this is what she has.","She con talk sey toh she, she no get money o, na wetin she get be dat." +"Then I said, ""okay, since you don't have the money, go and see my management, because I don't have the right to reduce the price for you.""","Naim I con tell am sey toh unto sey you no get money o, go meet my management because me, no get right to reduce price for you." +Aha!,Aha! +That was how we talked.,Na so we be yarn. +We went on and on talking.,"We be yarn, yarn, yarn, yarn" +Until the lady went to meet the management.,Sotay di girl con go meet management. +Then they reduced the price for her.,Dem con reduce money for her o. +She tried.,She try o. +"When they finished the hair, she liked it.","When dem con finish di hair, na so she con like am." +Is that so?,Shu! +Now she was li-... behaving as if she were a big celebrity.,She con dey do li-... feel herself like sey she be celebrity too much. +"She was bringing her nails here, I saw her shouting hallelujah.","She con dey carry her nails for here, I dey see her now dey shout hallelluyah." +"She was... she was doing selfies, Skyping, everything, everything.","Con dey, she con dey do selfie, dey do, dey do all dese Skype, everything, gbogbo ti gbo gbo." +That girl... that lady was no good at all.,"Dat girl, dat babe, no try at all." +That's how it all came to an end.,Na so di matter take end. +Hm.,Hm. +"So as it is now, the manager knew.","So as e be now, manager con know." +"I also told her, ""okay, you don't have enought money, do the one you can afford, do the one that you can afford.""","Me too, I con tell her sey okay o, you no get money, do di one wey your money reach, do the one wey your money reach o!" +"Then she said no, she's not doing that; the one she wants is the one she needs to do.","She con say so she, she no go do dat one o, na dat one wey she, she want, na im she, she must do." +Then management told her we don't do manicures for eight hundred in this shop.,Management con tell her sey we no dey do nails of eight hundred for dis shop o. +That was how she agreed to pay two thousand naira.,"Na so she con gree, she con tell me sey okay she, she go pay two thousand." +Hm!,Hm! +"Even the two thousand as well, she said she didn't have enough money and she'd come back and pay the balance.","Even di two thousand sef, she con say she never even get money to con balance, sey she go come balance us be dat o." +You can imagine.,You can imagine. +That was how she sat down... sat down to finish the nails.,"Na so she con sit down, sit down, do di nails finish." +Aha!,Aha! +"When I finished the nails, I was wondering where the girl came from.","As I con finish di nails, I con dey wonder sey where dis girls comot from?" +"So I asked her, ""sister, excuse me, where are you from?""","I con ask her sey sister, abeg no vex o, where you comot from?" +She said she was from Ibadan.,She say na Ibadan she from. +"I said ""aha! It's a shame! It's a shame!""","I say aha oga o, oga o!" +Haha.,Haha. +She said...,She say... +"I said ""which part of Ibadan?""",I say which part of Ibadan? +Ibadan!,Ibadan! +She said ah.,She said ah. +She said it's a kind of...,She say na one kind... +"Challenge, all those uh... Molete people.","Challenge, all dose eh Molete people." +"She, she said a kind of... a kind of name that I just don't...","She, she con call one kind, one kind name like dat." +I just didn't...,I no just... +Or is it Iwo road?,Abi na Iwo road? +"All, all those people are bush people.","All, all dose people sef, dem be bush people o." +You should see the kind of fake nails she was wearing.,As in con see di kind knuckles wey full di girl nails ba! +Haha!,Haha! +She has bleached [her skin] completely.,She don bleach her life finish o! +"Hey, I can imagine.","Hey, I can imagine." +Her hands were bony!,Knuckles full her hand! +She was like uh... coke and fanta.,"E be like ehn coke, and fanta." +Jesus!,Jesus! +"No, it was like burnt plantain.","No, e be like burn plantain." +"You know like burnt plantain, that's what her hand is like.","You know as plantain wey dey burn dey, na so her hand dey." +Hmhm!,Hmhm! +"Oh babe, that's why I said look at this girl!","Oh omo, na so I say dis girl!" +Haha!,Haha! +I wanted to take a picture of her nails.,I wan snap her nails o. +"That was how she told me that ah, I should not take a picture of her nails.",Na so she con tell me sey ah meh I no snap her nails o. +"She said if I shoot her nails, her knuckles will be showing.","She say meh I no snap her nails o, sey if I snap her nails, her knuckles go dey show." +"I now said ""babe, I'm taking a picture of the nails because if I don't, my customers that are coming won't see my work.""","Naim I con say babe, me I dey snap nails o, but I no snap nails, my customers wey dey come, dem no go see my work o." +That was how she...,Na so she come... +"I told her not to worry because my phone, the kind of camera I have on my phone, the camera will clear all the knuckles, all the all the defects that she has on her hand.","I con tell her sey make she no worry, di camera wey I get for my phone, di camera go clear all di knuckles, all di yama, yama wey she get for her hand." +All the defects on the nails.,"All di whole yama, yama wey dey di nails." +So she agreed.,Na so she con gree o. +"I finished and she posted it on Instagram, Facebook, Whatsapp, everywhere.","I finish, she con post am out for Instagram, Facebook, Whatsapp, Everywhere." +Just look at the nails!,Just dey see di nail! +She was just feeling proud that day.,She just dey feel herself dat day o. +"Babe, it's no small thing.","Omo, no be small thing." +So her friend said she liked the nails.,Na so her friends ma follow talk sey she ma she like di nails. +Hm!,Hm. +Then she came to do it.,She ma con do am o. +"Her, she didn't have any money, so I should also do the manicure for eight hundreed naira for that one, that day.","Her own, she no get money so dat I should do eight hundred naira nails for dat one dat day." +Eight hundred?,Eight hundred? +She can't agree to... mstchew!,She no fit mstchew! +mstchew!,Mstchew! +Please!,Kai! +A manicure that we do for one thousand five hundred I did for her eight hundred!,"Nails wey we dey do one five hundred, I do am for am eight hundred." +"Just to maintain a relationship with the customers, mstchew.",Base on sey make we just maintain relationship for customer level o mstchew. +Hm!,Hm! +"Man, that's how the matter is.","Omo, na so di matter be o." +It's a shame!,Na wa o! +"So, as it is now, the thing has...","So as e be now, matter don..." +Management told her... told me that she had come before!,"Management con tell her sey, tell me sey she don come before sha!" +"So, that was how she kept bargaining.","So na so she price, price, price, price." +"In fact, the day she came to fix her hair, that was how she paid.","Infact di day she con fix her hair, na so she price o." +Hm!,Hm! +"She can haggle, she is the best haggler in Africa!","She dey price o, dey price for Africa." +As if!,As in! +Paying five hundred naira for a haircut!,Dey price hair five hundred! +Can you imagine?,Can you imagine? +"They say that in Lagos, that under a bridge, they do hairdressing for five hundred.","De say na Lagos, sey under bridge, de dey do hair five hundred." +Aha!,Aha! +Can you imagine?,Can you imagine? +What kind of girls are those?,Which kain girls be dose ones? +They are Jews.,Na Jew girls. +Ah!,Ah! +"You know that those Jew girls, they are the ones who pretend they are Jews.","You know sey dose Jew girls, na im de form sey dem be Jew girl." +Jews?,Jew? +"They'll pretend they're city girls so that you know, when they enter a big place like this, they'll know that they're babes.","De go do like sey de be city girls so dat you know when dey enter big place like dis ba, dem go know sey ah na babe be dis." +They won't know that nothing can fix them.,Dem no go know sey na noting gum dem. +Nothing can fix them.,Sapain no gum dem. +One naira won't fix their butts like this!,One naira no gum deir yansh like dis! +"Mstchew, hm!",Mstchew hm! +"Good afternoon, my countrymen!","My country people, una good afternoon!" +"This is the one o'clock news coming to you from Bronze FM, one O one point five in Benin City.","Dis one na tori for one o'clock wey dey reach una from Bronze FM, one O one dot five for Benin City." +"And this is Allen Ujewa, bringing you the news.","And na me, Allen Ujewa wan give una di tori." +Edo State Government has told bus drivers to park first at Oba Akenzua Cultural Centre so that the passengers won't suffer.,Edo State Government don tell bus drivers to dey park first for Oba Akenzua Cultural Centre so dat people wey dey enter motor no go dey suffer. +"At the time the Chief of Staff, Oga Taiwo Akerele, was speaking to journalists in Robota Hall, saying that the government knows people are walking long distances to board busses.","Di time di chief of staff, Oga Taiwo Akerele dey talk to tori people for Robota Hall, e con talk sey government know sey people dey trek long distance o before de fit take bus." +But he then said that they have been doing everything to create permanent bus stops.,But e con talk sey dem don dey do everything to create permanent bus stop. +"The Curator in the National Museum in Edo State, Mr Theophillus Omogbai, told the Federal and State Governments to rearrange the museums in the country to make sure that they can meet world standards to help boost tourism in the country.","Di curator for National Museum for Edo State, Oga Theophilus Omogbai don tell Federal and State Government to rearrange museum for di country to see sey e fit meet world standard so dat e go boost di tourism for di country." +"Mr Omogbai said this while he was talking to Radio Nigeria during this year's International Museum Day, which was held on the eighteenth of May.",Oga Omogbai talk dis one di time e dey talk to Radio Nigeria for dis year International Museum Day wey dem do for May eighteenth. +Mr Omogbai said that Nigerian people don't visit museums.,"Oga Omogbai wey con fit talk sey people for Nigeria, dem no dey patronise museum o." +"That's what is causing the poor economic situation of the tourism sector in Nigeria, unlike other countries.",Sey na wetin be sey dey cause di poor economic matter for tourism sector for Nigeria unlike other countries. +"The National President of the Nigerian Union of Women Journalists (NAWOJ), Comrade Ifeyinwa Omowole, called on women to be at the forefront in the socioeconomic development of the country.","National President Nigerian Union of Women Journalists, NAWOJ, Comrade Ifeyinwa Omowole, e don call on women to dey di forefront for di socioeconomic development of di country." +Comrade Omowole said this during the programme called Newsmaker on Bronze FM in Benin.,Comrade Omowole talk dis one for di programme wey dem dey call Newsmaker for Bronze FM for Benin. +"On this matter, she said that no nation will develop without women getting involved in the country.","On top dis matter, she con talk sey no nation go develop without women no dey involve for di country." +"A seventy four year old man, Mr Habibu Ogiator, who was kidnapped when he was going to his farm in Etsako East Local Government Area, has been released.","One seventy four year old man, Oga Habibu Ogiator wey dem be gbab hide di time e dey go farm for Etsako East Local Government Area, dem don release am." +"According to Mr Ogiator, he said (at the time he was telling this story), he then said that he had been in the custody of these people who kidnapped him for two days before they released him at last.","According to Oga Ogiator, e say (di time e dey talk dis story), e con talk sey e be dey di hand of dis people wey kpaki am hide for two days before dem con free am last, last." +"He then hailed the people of Ujendu Community for the way they handled the matter, which made them release him.",E con still hail di kins men of Ujendu community for di way dem take handle di matter o wey come make dem fit release am. +And he then used the opportunity to beg the police and other security personnel to improve the security in the area.,"And e con use di opportunity take beg police people dem, and oder security people sey make dem abeg improve for security matter for di area." +"My countrymen, this is where the one o'clock news will end, coming to you from Bronze FM, one O one point five in Benin City.","My country people, na here tori for one o'clock reach, and e reach una from Bronze FM, one o one dot five for Benin City." +My name is Allen Ujewa.,My name na Allen Ujewa. +Good afternoon.,Una good afternoon! +"Alright, good morning, my beautiful countrymen.",Alright una good morning my beautiful country people. +How are you doing?,How una dey? +"Yes, this is the hot new segment on the Good Morning Naija Show, which I brought to you this beautiful morning.",Yes na di papapa informate on top di Good Morning Naija show I don carry come for una this beautiful morning. +My name is Ajibike Ogunlade.,My name na Ajibike Ogunlade. +"From the very first story, we heard that President Muhammadu Buhari has said that since they have found uh... these eighty two Chibok girls, that they have rescued them and that this is a gift to commemorate their second anniversary to all our countrymen.","Ontop of very first story now, we don hear sey Presido Muhammadu Buhari don commot tian say dis one wey be sey de don eh find dis eighty two Chibok girls, sey de don rescue am, sey dis one na second anniversary gift to all we obodo people." +"Now since Mr Buhari, um... Mr Buhari said so yesterday, in the Presidential Villa, during a small reception which was organized for the rescued Chibok girls.","Now dis one wey be sey Oga Buhari, ehm Oga Buhari bin yarn so, na for inside presidential villa yesterday, and during one small reception wey be sey de bin organise ehm because of di Chibok girls wey be sey de rescue." +"And in fact, after they were rescued yesterday, they were all taken to Abuja, um... to meet with the President and other important figures.","And in fact, yesterday, after de bin rescue de, na so de carry all of dem go Abuja, ehm make dem go meet Presido, plus oda, oda important, important people." +"On this, Mr Buhari has said that he is very happy that the girls have been released.","Ontop dis one now, Oga Buhari don yarn sey im dey very, very happy sey de don release dis girls." +"And in fact, he has promised all of us in the country that his government is very determined to make sure that the remaining girls who are yet to be released and all other persons who have been kidnapped by (uh... that these, these militants have kidnapped), and kept in their stronghold, will also regain their freedom.","And in fact, e don comot promise all we obodo people sey im government dey very, very determine to make sure sey di remaining girls wey be sey de never release so, sey de must to release dem, plus all oda of we obodo people wey be sey de don kolobi, ehn dis, I no go gree, people don kolobi put inside deir own stronghold." +"Meanwhile, we have heard that the eighty two rescued Chibok girls... (yes, you have heard about it), that they have been treated well, that they have discussed and have met with the Chief of Staff to our President, Mr Abaki Harry.","Meanwhile, we don hear sey di eighty two rescued Chibok girls now o (yes you don hear), sey de don do better, sey don discuss, and de don meet with the Chief of Staff to we Presido, Oga Abaki Harry." +"Apart from that, one of them also said that they have received very good medical attention from the medical team uh... of the Department of State Services.","Apart from dat, one also say de don do better, better assessment with the medical team ehn of di Department of State Services." +"Now, the person who they spoke with the people who shared the story after this, they've had a discussion.","Now person wey be sey dey discuss with tori people after dis, de don discuss." +"So it was the Chief of Staff, Staff himself, Mr Abaki Harry.","So na di Chief of Staff himself, Oga Abaki Harry." +"As he was explaining that they have assessed all the girls, they have carried out appropriate examinations on each and every one of them.","As im, e dey explain sey de don assess all di girls, de don do better correct examination on top each, and every one of dem." +"And in fact, he said all of them are in good condition right now.",And in fact sey all of dem bin dey inside good form right now. +"Also, he said that it looks like they have noticed some injuries on two of the girls.","Also e bin yarn sey e be like sey de bin see some kind small, small injury on top two of di girls." +"And in fact, he said that these injuries have no connection with the way they were reportedly rescued.","And in fact sey dis injury so, e no get any kind connection wit di way wey we say de rescue dem." +"Also on this, we hear that the way... in fact, the rescue operation carried out on these girls was done in a professional way, and there were no errors.","Now on top dis one also, we bin dey hear sey di way, in fact di rescue operation wey bin sey de do on top dis girls, sey di thing bin go very, very professionally, sey no comma dey on top am." +"Now, we heard that the Director of the DSS [Director of State Services] Medicals, Ann Okorafor, has also promised all of us in the country that these girls are in safe hands.","Now we hear sey di director of di DSS medicals, Ann Okorafor sef don comot promise all we obodo people sey dis girls so, sey de bin dey inside di safe hands." +"And in fact, she said that they will receive the best medical care available anywhere in the world.",And in fact sey de go receive the best medical care available anywhere inside obodo the world. +"Now, we heard that our President himself, President Buhari, is supposed he has started packing his bags, getting ready to go to London for follow-up medicals with all his doctors over there.","Now we don hear sey we Presido imself, Presido Buhari suppose e don dey pack im kaya, e don dey get ready to go London make im go do follow up medicals with all im doctors wey be sey e dey dere." +"Now, we heard that one of um... these uh... the sources said that Mr President's Spe-... Special Adviser on Media and Publicity, Mr Femi Adesina, announced this yesterday, in Abuja.","Now we hear sey dis one wey be sey, ehm dis ehn informate so sey na Oga Presido spe-... special adviser on top media, and publicity, Mr Femi Adesina na im yarn dis one yesterday for inside Abuja." +"Now, according to Mr Femi as well, he has been trying to explain that the duration... the period of time which Mr Buhari won't... will stay back in London... he said that only his Doctor can talk about that right now, but that this will not affect the smooth running of things in the country because the government will continue normally under the able leadership of our Vice President.","Now according by Oga Femi also, e be dey explain sey di duration, di length of stay wey be sey Oga Buhari will, go stay inside London, sey na only im doctor na im fit talk that one right now, but sey dis one no go stop any kain waka wey be sey dey sele inside we obodo because of sey government go dey continue normally under di able leadership of we Vice Presido." +"Still on this, also, Mr Femi Adesina has said that Mr Buhari is very grateful to all those who have been praying for him and for all the good wishes which people have been sending him.","Still on top dis one also, Oga Femi Adeshina bin yarn sey Oga Buhari bin dey very, very grateful to all di people wey be sey bin dey pray for am, plus all di good wishes wey bin sey people bin get, and people dey express for am." +"And in fact, he has said that he's hopeful that as we say, they are praying for him, and that in the same way, they will be praying for the peace and unity of our country.","And in fact im bin yarn sey e dey hopeful sey as di way wey we say, de dey pray for am, na so de go dey pray for di peace and unity of we obodo." +"And we also heard that in January, Mr Buhari travelled to London for a similar check-up, and he came back... and he returned on March tenth, after fifty one days in London.","And we hear sey for January so, Oga Buhari bin travel go London for a very, very similar checkup, and im bin come back, and im bin return for March ten after fifty one days in London." +"Now uh... it's been brought to our attention that the association of the people handling aviation matters in our country, (uh... now they call themselves the Nigerian Civil Aviation Authority), they have come out to warn passengers who get angry over minor issues.","Now ah we don hear sey di joinbody wey be sey dey handle things on top aeroplane matter inside we obodo (eh de dey call demself the Nigerian Civil Aviation Authority now), de don comot dey drag ear, dey warn all dis passengers wey be sey dey ginger any small thing, dey just dey vex, dey just dey vex." +"And when they're angry, they also beat the ones who work with airplanes, uh... maybe the cr-... crew members.","And as de dey vex so, na so de dey beat di people wey be sey de bin dey work inside aeroplane o, ehn maybe di cr-... crew member o." +Or they go looking for trouble and beat the people working behind the desks.,"Abi de go find small wahala, bin beat people wey be sey dey, eh dey work behind di desk." +They said anyone who takes part in this kind of misbehavior should put an end to it right away.,"Sey all dis people wey be sey de dey do dis kind badness, sey meh de stop am now, now, now." +"If not, they said they will sue them all.","If not, sey de go carry all of dem go court." +"Now, this warning in the statement above is such that the General Manager of the association (uh... the... in charge of the media section of public relations), uh... Mr Sam Adurogboye, said so.","Now dis dragging of ear wey be sey de dey drag ear give dem so, na inside dis statement on top be sey di General Manager of di joinbody, ehn di on top di media section public relation, ehn Mr Sam Adurogboye dey yarn so." +"Now, according to Mr Sam also, he's been saying that this warning is a result of the reports they were getting that these uh... airline staff are making reports that some people... some people will just get angry with them for things they have no control over.","Now according by Mr Sam also, im be yarn sey dis one wey be sey de don dey drag ear, dey warn dis people, na because of di report wey be sey de dey get sey dis ehn aeroplane people dey report sey some people, some people go just dey vex with dem on top things wey be sey de no get power over." +"Now, Mr Sam has said that the airline staff being attacked is a very embarrassing thing.","Now Mr Sam bin yarn sey dis one wey be sey de just dey attack ehn airline staff, sey dis one na very, very embarrassing something." +"And in fact, he does not have uh... it's not sensible.","And in fact sey e no get ehn, e no get brain at all, at all." +"And in fact, that people... that customers take things into their own hands, especially when things don’t favor them.","And in fact sey make people, make customers no go dey carry di law put on top deir hand especially when things no dey favour dem." +"And he also advised all airlines operating in our country that they should... should uphold... they should strongly enforce the commissions they have; the terms, and conditions, and contracts on all the...","And also e bin dey, dey advise all dis airlines wey be sey dey operate inside we obodo sey make, make de uphold, make de hold strongly all di commission wey be sey de bin get, di terms, and condition, and contract on all di..." +"And in fact, they should put it on all the passenger's tickets at all times, so that people will read it, they will see what they're supposed to do and what they're not supposed to do when they have any issues.","And in fact make de put am on all di tickets of passengers at all time so that people go dey read am, go see wetin de suppose do, and wetin de no suppose do when de bin get any kind issue at all." +"Moving on to stories on small businesses, we've heard that the Rice Farmers' Association in Kaduna State said they have come out asking for loans, they want to borrow money.","Moving on into small business story now, we don hear sey di Rice Farmers Association inside Kaduna State now, sey de don comot to dey ask for loan, sey de wan borrow money." +They said that they want to use the loan to enhance the production of rice for members of uh... their association for the twenty seventeen farming season.,"Sey dis money wey be sey de wan borrow so, sey de wan use am take enhance di production of rice ehn for people eh wey be sey dey inside deir joinbody for di twenty seventeen farming season." +"The Secretary of the association, Ishaya Audu, said this yesterday in Kaduna.","Na di sece of di joinbody so, Ishaya Audu na im yarn dis one yesterday inside Kaduna." +I said they should explain all the things they use in the production of rice.,I say meh de explain say all di things wey be sey de dey use inside dem to produce rice. +That the things... some of them don’t have any of them.,"Sey di things, some of dem, de no get any of dem." +Some of them don’t have some of the materials again.,"Some of dem, de no get some of di materials again." +"And in fact, all these things have been reducing the production of rice in that state.",And in fact sey all dese things don dey reduce di way wey be sey de dey produce rice inside dat state. +And in fact his... um... the number of um... the bags of rice they produce is going down because they lack some of these materials.,"And in fact sey im, em di number of, em di bags of rice wey be sey de dey produce, sey di thing don dey reduce because of sey de no get some of dis materials." +"Now um... according to Mr Audu, he's been trying to explain that most of the farmers now produce at a loss because some of them don’t have fertilizers; some of them don’t have um... um... pesticides which they need to use to chase away all these um... animals that eat their produce.","Now ehm according by Oga Audu, im bin dey explain sey most of di farmers now, sey dem dey produce at a loss because of sey some of dem no get fertilizer, some of dem no get ehm ehm pesticide wey be sey de go dey use take dey, dey pursue all dis ehm animals wey be sey dey chop, chop deir food." +"And in fact... and all this... he said please, he said they should loan them some money to improve production, to organize all the things they need to use for uh... to make sure that the rice they produce is up to standard, so that they'll be able to produce food for the people of our country.","And infact, and all dis one so, sey biko, sey make de borrow dem money to use ehm to upgrade their situation, to use take package all di things wey be sey de go use take eh make sure sey dis rice wey be sey de dey farm so, so di thing go dey very, very well, very, very good so dat de go dey fit to produce food for we obodo people." +"And moving on to my last story, we have heard that in France, yes, the pro European candidate, Emmanuel Macron... yes, we have heard that huge celebrations are going on in France at the moment because he won the French Presidential election um... by between sixty five to sixty six percent of the vote.","And moving on into my last story now for We Don Hear Sey, for inside France, yes the pro-European candidate, Emmanuel Macron, yes we don hear sey na better jubilation dey inside France now as im don win di French presidential election ehm sey by between sixty five to sixty six percent of the vote." +"Now, we heard that Macron will be the youngest President that France has ever had, and in fact that he beat the National Front leader, Marine Le Pen after a very, very tough contest.","Now we hear sey Macron, na im go be di youngest ever president wey be sey obodo France don ever get, and in fact sey im bin beat the far right National Front leader, Marine Le Pen after one very, very strong contest wey be sey bin sele." +"Adding to this, we've heard that Le Pen said that she conceded, that she has agreed that, yes, it's Macron who defeated her.","And on top dis one also, we hear sey Le Pen say she don concede, she don gree sey, yes na Macron na im chopulate am." +"And in fact, she congratulated him on his victory.","And in fact sey she don call am, congratulate am on the victory." +"Adding to this, she has told her fans in Fr-... France that Fren-... uh, the French now have chosen their own president.","Now on top dis one also, she bin dey tell her fans inside eh Fr-... France sey Fren-... em, obodo France now, sey de don choose deir own Presido." +They have chosen their leader.,De don choose deir own leader now. +"And in fact, it's worth noting that they voted for continuity because they liked the guy's... the guy's plans for their country.","And in fact sey de bin dey vote for continuity because of sey de bin like wetin di guy's, di guy's plan bin dey for deir obodo." +"Now, we heard that so many people uh... voted for the far right leader.","Now we hear sey plenty, plenty people ehn bin vote for the far right leader." +"But right now, everything is up um... to Emmanuel Macron as he got sixty five... sixty six percent of all the votes cast during the election.","But right now, everything is up ehm to Emmanuel Macron as e now chopulate dis sixty five, sixty six percent of all the vote wey be sey de bin cast on top di matter." +"Alright, um... and that’s the news we brought your way again today.",Allright ehm and dat na di informate we don bring for una again today. +"Yes, and of course, I won't forget to tell you that for any other news on Wazobia TV, our website is here - www dot Wazobia TV dot TV.","Yes and of course I no forget say on top any oda kind informate for Wazobia TV, our website dey dere, www dot Wazobia TV dot TV." +Let's go into our weather studio.,Make we enter our weather studio. +Let's see what's on the weather forecast this morning.,Make we see how weather go be for us dis beautiful morning. +My name is Jibike Ogunladi.,My name na Jibike Ogunladi. +"That do-... lecturer Agude, that man gives us so much stress.","Dat do-... lecturer, Agude, dat man dey give us too much wahala." +What did he do again?,Wetin e do again? +All...,All... +"I heard that from year one to year three, nobody passes his exam.","I hear sey from year one to year three, none dey pass im exam." +What kind of a man is that?,Which kind man be dat one? +Haha.,Haha. +Is it babe?,Na babe? +"That man, that's how his life is.","Dat man, e get as im life be o." +"Wait, have you only heard of it?","Wait, na hear wey you hear?" +Do you still hear about it?,As in you still hear? +Do you still hear about it?,As in you still hear? +Did you see it clearly with your eyes?,You never see am clear with your eye? +Is it babe?,Na babe? +Is it babe?,Na babe? +It landed right on my face.,Di thing don land gbam for my face o. +"Me, I don't uh...","Me, I no ah..." +They failed it.,Dem dey fail am. +Fai-...,Fai-... +They don't look back.,Dem no dey look back. +"I'm not scared, I'm not afraid.","I no dey scare sha, I'm not afraid." +I know that God is right behind me.,I just know sey Oluwa dey my back. +I can pass it.,I go fit pass am. +"Whatever it takes, I will pass.","No how, no how, I go pass am." +I'm praying for God to stand by me.,I dey pray make Baba God stand by me o. +Or me I... me I... me I will never fail.,"Or me I, me I, me I never wan fail." +I don't want repeat...,I no wan ca... +"You see, repeating (a class), I don't want it to leave traces in my...","You see carry over, I no wan make di thing, I no wan make di thing smell for my..." +It's no small thing.,No be small thing. +How can you bring the results home to give to your parents?,"How you go carry dat result go, go, go house, go dey give your parents?" +Mstchew!,Mstchew! +What will I tell my old man?,Wetin I go tell my p-man? +"Well, that's how it is.",E get as e be o. +"Nah, it's fucked up now, you understand?",Nna na fuck up now you understand? +It's no small thing.,No be small thing. +I wanna eat.,I wan chao. +You wanna eat?,You wan chop? +"As I'm sitting here, my stomach is calling me.","As I dey here, my belle dey call me." +"My friend, it's no small thing.","Nna bae, im no be small thing." +The canteen is beyond me.,Canteen dey leave me. +Ah no problem.,Ah no wahala! +What are we going to eat?,Wetin we go chop? +Or is there abacha there?,Abi abacha dey dere? +Abacha?,Abacha? +You'll use Pepsi to dilute it.,You go use Pepsi dilute am. +Why do you like abacha?,Why you like abacha? +"Man, that's what I want to eat.",Nna na wetin I wan chop o. +What will I do?,Wetin I go do? +Why do you like abacha?,Why you like abacha? +It's chea-... it's cheap.,Is chea-... is cheap. +"It's what I can afford, it's what I want to eat.","Na wetin I go fit afford, na wetin I wan chop." +"Man, please, eat better food!",Nna abeg come chop better food! +Eat akpu instead!,Meh you mount akpu now! +What are you saying?,Wetin you dey talk? +Eat good food!,Chop better food! +What are you saying?,Wetin you dey talk? +What are you saying?,Wetin you dey talk mstchew? +Stop talking like that.,Make you no dey talk dat kind thing. +"Please, no.",Abeg no! +"You're fucking up, you're disappointing me.","You dey fuck up o, you dey fall my hand." +"If you put it over, now add fish, Oduazu, ah, you'll really like it.","If you put am over, con put fish, oduazu, ah you go like am wella o." +"Babe, you're disappointing me!","Babe, dey fall my hand." +It's no small thing.,No be small thing. +I swear to God!,I swear to God! +"Babe, you're discouraging me!",You dey fall my hand. +Ah!,Ah! +Hm.,Hm. +Have you heard from Malu?,You don hear from Malu? +"I mean, Peace said that Malu is coming today.",I mean Peace say Malu dey come today. +That woman too eh!,Dat woman too eh! +And she gives us expensive things to buy.,And e dey give us expensive things to buy. +What kind?,Which kind? +Every time she will be giving us textbooks to buy for one [thousand] five [hundred].,"Everytime, im go give us textbook make we go buy am one five." +Doesn't she know we're students?,Im no know sey na student we be so? +Aha!,Aha! +But the thing is not too expensive.,But di thing no too cost o. +"If you go to Ise, it's three thousand!","If you enter Ise, na three k gbam." +They don't hesitate.,De no dey look back. +They don't hesitate.,De no dey look back. +"Babe, I can only afford what I can.","Babe, na where my hand dey I go fit afford." +"I don't have that much, I don't have it.","I no get dat one, I no get am." +But the way...,But di way... +You know wh-... you know wh-...?,You know wet-... you know wet-... ? +It's not the money that annoys me.,No be sey di money dey vex me. +Do you know what annoys me?,You know wetin dey vex me? +He doesn't teach well now.,E no dey teach wella now. +Wait first!,Wait first! +"She gives us a book, uhuh, and says we should summarize the whole thing by tomorrow.",She give us book ehe dey talk sey make we summarise di whole thing within tomorrow. +Are we ghosts?,We be ghost? +Will we turn to witchcraft?,We go chop witch? +"It is not sm... haha, it's not a small... it isn't a bit of witchcraft.","No be sm-... haha no be small, no be small witch." +Ah!,Ah! +"Nah, babe!","Nna, babe!" +I don't know.,I no know. +Let her just adjust herself.,Make she kukuma just arrange hersef o. +"Man, when Peace told me that thing, it was like if I put my own plaster on the wall, it would have fallen.","Nna when Peace tell me dat thing, e be like sey make I carry my own plaster for wall, for fall." +I don't understand.,I no understand. +Haha.,Haha. +Haha.,Haha. +It's no small thing,No be small thing. +"Where is Peace even, that, that class rep?","Where Peace dey sef dat, dat una class rep?" +It's like that girl is playing funny.,E get as dat girl dey behave o haha. +It seems like she's gone with... she's run away with her crush.,"E be like sey she don follow, she don follow am crush waka." +Haha.,Haha. +"She's going with her crush, haha!",E go book am crush haha. +So she's following her crush?,Im dey follow una crush? +No problem.,No wahala! +Ha!,Ha! +Oh God!,Oh God! +"Okay, my name is Bassey.",Okay my name na Bassey. +People call me Skata.,People call me Skata. +"Um... I like to drink uh... beer, but not all beers.","Em I like to drink ehn beer, but not all beer." +"I like to drink uh... Stout, but today, I just decided to drink uh... Gulder.","I like to drink ehn Stout, but today I just decide to drink ehn Gulder." +"We have uh... Stout, we have Gulder, we have uh... Origin, we have uh... Star, we have uh... different brands of beer.","We have ehn Stout, we have Gulder, we have ehn Origin, we have ehn Star, we have ehn different type of beer." +But I like drinking Stout because...,But why I like to drink Stout is dat... +"The, the reason I like drinking Stout is because Stout doesn't...","Di, di reason why I dey like to drink Stout is because Stout no dey..." +"When you drink Stout, you don't need to go piss, piss all the time.","When you drink Stout, you no go dey go piss, piss all di time." +Because... and it will also keep your belly full.,"Because, and e will hold your stommy also." +"If you want to go a long way, you don't need to go to the bathroom every now and then.","If you wan go long distance, you no go dey go toilet every now and den." +Stout will keep your belly nice and full.,"Dat Stout go hold your bele well, well." +That's why I like Stout.,Dat is di reason why I like Stout. +But uh... many people prefer the other brands as well.,But ehn many people like oda branches also. +And I like to come to this uh... place because their drinks are not expensive.,And I like to come to dis ehn place because deir drink no dey cost. +You will go to some places and they will tell you the Stout is four fifty a bottle... five hundred.,"E get some places wey you go, di Stout, de go tell you four fifty for one bottle, five hundred." +"But in this place, you can buy it for three thou-... three hundred and fifty naira here, and drink.","But dis place, you can buy three thou-... three hundred and fifty naira here, and drink." +"And beer also, though it's good, it's not very good for young people... for children.","And beer also, though it is good but e no dey good too much for young people, for children." +Someone who has... who is not uh... eighteen years or older yet is not supposed to be drinking beer.,"Person wey don, wey no dey reach ehn eighteen years above, e no suppose dey drink beer." +"Because if they start drinking beer, it will affect them negatively.","Because, if dem start to drink beer, e no go do well for dem." +They won't behave well at home.,De no go dey behave well in di house. +"Even in school, they won't concentrate.","Even for deir school, dem no go concentrate." +So it's good for someone to be over eighteen before they can start drinking uh... beer.,So is good for someone to grow above di age of eighteen before e can start to dey take ehn beer. +But beer is very good because it will help you.,But beer is very good because e would help you. +It will make you know... I mean feel bold.,"E would make you know, I mean feel bold." +It will make you feel bold at all times.,E go make you to dey feel bold at all time. +"Apart from that, I also come in here to eat, most of the times because here, their food is good.","Apart from dat, I come here also most of di time to chop because deir food here is good also." +It's uh... hygenic.,Is ehn hygienic. +It's clean.,Is clean. +They prepare it... they cook it the way everybody likes it.,"De prepare it, de cook it di way wey everybody like it." +They are from Calabar.,De are Calabar people. +"As we all know, Calabar people are the ones who know the most about how to cook.","As we know, Calabar people na dem dey sabi cook food pass." +So I always come here to eat with them.,So I always come here to chop with dem. +"They have... they've got edikaikon here, they have epankwokwo, the have garri (eba), and soup; they have uh...","De have, de get edikaikon here, de get epankwokwo, de get garri, and soup, de get eh..." +"About the soup, they have uh... afiaifere, ebot; they have uh... otong, they have uh... ogkuoafan, they have uh...","For di soup, de get ehn afiaifere, ebot, de get ehn otong, de get eh ogkuoafan, de, de get eh..." +"At times, they also have diedesi here, they have iwuhabia, they have ozobuko.","At time, de get diedesi sef here also, de get iwuhabia, de get ozobuko." +"In fact, they have all kinds of food here.",In fact de get all type of food here. +They also have pepper soup.,De get pepper soup also. +"They have uh... cowtail pepper soup, they have fish pepper soup too.","De get ehn cowtail peppersoup, de get fish pepper soup also." +So everything is here.,So everything is here. +They have everything someone can eat and enjoy here.,De get everything here dat someone can eat and enjoy. +"Uh... myself, most of the times... a lot of the time when I come here, I, I like to eat afiafherebo, yeah, and auzomahbiah.","Ehn mysef, most of di time, many time, when I come here, I, I like to chop afiafherebo, yeah and auzomahbiah." +"For auzomahbiah, they prepare it with uh... yam.","For dat auzomahbiah, dey use eh yam to make it." +They pound the yam.,De pound di yam. +The whites call it pounded yam.,Oyinbo people call it pounded yam. +"But with afihafereboh, they add uh... goat meat in it, and they prepare it in such a way that they don't put any...","But dat afihafereboh, de put eh goat meat dere, and de prepare it in di way dat de don't put any..." +They cook it in the... in the way where they don't add vegetable leaves to it.,"De cook it in di, in di way de don't put leaf dere." +The soup is peer... pure white.,"Di soup na peer, pure white." +Just white like that.,Just white like dat. +I have finished now.,I don finish now. +My name is Bukola Ayaniyi.,My name na Bukola Ayaniyi. +I'm an authority in soap making.,I be ogbonge madam for soap making. +"I make soap because I don't wanna steal, and I don't wanna be a liability to my husband.","I dey make soap because I no wan steal, and I no wan be liability for my oga." +"I'm just making the soap, I'm not the one who invented the soap making process.","And as I dey do di soap, no be sey na me originate di soap before." +"A long time ago, I had a shop where I sold basic products.","Before, before I get shop where I dey sell provision." +"But later on, things went bad.","But later on, tings do as e wan do." +"And myself, I can't just sit idle.",And me I no fit siddon idle. +That's why one of my friends whose name is Mama Funmi (she is my best friend)... so she told me that her brother was taught how to make soap in their church.,"Dat'S why one of my friend wey im name be Mama Funmi (na my better friend) naim come tell me sey im broda, de don teach am soap for deir church." +"So since he was taught about it, he gave me the manual to read.","So as de come teach am, e come carry di manual give me say make I go read." +"When I finished reading it, I went to buy the ingredients.","After I read am finish, na so I go buy materials." +So the ingredients for making soap starts with sulphuric acid.,So di material for making soap start from sulphuric acid. +The second one is Texapon.,Di second one na Tezapen. +The third one is s-... uh... caustic soda.,Third one na s-... eh caustic soda. +The fourth one is ST-... STPP.,"Di fourth one, na ST-... STPP." +"Soda ash, nitrosol, perfume, liquid gel, or foam booster, or formalin, with colour, and perfume.","Soda ash, Nitrosol, perfume, liquid gel, or foam booster, or formalin, wit colour, and perfume." +That was how I started mixing soap.,Na so I start to dey mix soap. +"And I thank God that even though I haven't had as much business I wanted, at least I'm putting some bread on the table for my children.","And I thank God sey even dough de never dey patronize me as I want, but at least, I still dey put something for table for my children." +And I don't...,And I no... +That my clothes won't get dirty and the whole house won't be smelling.,No be sey all my cloth go come dirty for house wey house go dey smell. +I wash as I like.,I dey wash as I like. +My children wash too.,My children dey wash. +We're clean.,We dey clean. +"Even my scent, my scent is fantastic because I add an exotic perfume to it.","My odour sef, my body odour na correct one because I dey put am correct perfume." +The perfumes I put into it range from Ambi Pur.,Di perfume wey I dey put start from ambipur. +"I put in lemon fruit, I put in uh... flavor, and some other perfumes.","I dey put lemon fruit, I dey put eh banana flavour, and so oda perfume like dat." +"This means if anyone opens up my soap and sniffs it, they will ti-... they will know it's a good one.","Wey be sey if anybody open my soap, smell am, e go ti-... e go see sey dis one na correct one." +"And my soap doesn't ruin clothes, it doesn't wash the color off clothes, it makes clothes better.","And my soap e no dey spoil cloth, e no dey wash cloth, e dey make cloth beta." +You can wash ankara and jeans with it.,"You fit use am wash ankara, wash jeans." +You can wash any kind of clothing with my soap.,"Any type of cloth, you fit use my soap wash." +And I make it in different colors.,And I dey do different types of colour. +"I make it in lemon, pink, blue, and green, so that it will entice my customers.","I dey do lemon colour, I dey do pink, I dey do blue, I dey do green so dat make e dey entice my customers." +"Or if they see it... ah, what color is this one?","Or if de see am, ah which colour be dis one?" +Sometimes I even use orange.,"Even at times, I dey do orange colour." +That's it!,Na so o! +So soap making is a good business!,"So soap making, na correct business o!" +Any woman who doesn't want her husband to mistreat her all around the house should find herself a bit of work... she should do something.,"Any woman wey e no want im husband make e dey take cloth dey knock im head for house, make e engage imsef for petty work, make e dey do o!" +It's not good to be idle.,E no good make person dey idle. +That's it!,Na so o! +"First of all, if I want to do like fifty liters, I will buy two liters of sulfuric acid.","First of all, if I want do like fifty liters, I go buy sulphuric acid, two liters." +"And the two liters go for one thousand, eight hundred naira.","And dat two liters, at di rate of one thousand, eight hundred naira." +A liter is nine hundred.,One liter is nine hundred. +I will buy Texapon for six hundred naira.,I go buy Tezapen six hundred naira. +"When I have bought all those things, I will...","If I buy all dose tings, I go..." +"First of all, I will mix sulfuric acid with Texapon.",First of all I go mix sulphuric acid wit Tezapen. +"I will stir the mixture very well, so that everything will dissolve.","I go stir well, well make everyting melt." +Because sulfuric acid is a very strong acid.,"Because sulphuric acid, e dey hot well, well." +"So when I have stirred it very well, in order to dissolve it...","So if I don stir am well, well make e melt, I go put my st-... caustic soda for water." +"Because for fifty liters of soap, I will use ten spoons of caustic soda.","Because for fifty liters of soap, I go use ten spoon of caustic soda." +I will soak it in three liters of water.,I go soak am for three liters of water. +"So when it has dissolved completely, I will pour it in.","So if e don melt well, well, I go pour am." +"When I have poured it in with, with the stuff I've mixed earlier (that sulfuric acid, and Texapon), I will pour the caustic soda into it.","If I pour am wit, wit di ones wey I don mix dat sulphuric acid, and Tezapen, I go pour dat caustic soda." +I will stir it very well.,"I go stir am well, well." +"In fact, as you are stirring it, you will notice smoke coming off of it because the mixture is really hot.","Even as you dey stir am, you go dey see di smoke wey go dey come out cause di tin dey hot well, well." +"So afterwards, I will also mix in my soda ash.","So after dat one, I go still mix my soda ash." +I will pour it into three liters of water.,I go put am for three liters of water. +I will mix that too.,I go mix dat one too. +"When it has dissolved completely, I will pour it in.","If e don disolve well, well, I go pour am." +I'll stir it very well.,"I go stir am well, well." +"After that sulfuric... after uh... the soda ash, I will add the STP-... STPP.","After dat sulphuric, after em soda ash, I go put STP-... STPP." +I will put that into three liters of water because I don't like my soap to be watery.,I go put dat one for three liters of water because I no dey like make my soap dey watery. +"So when I've done all that... all those things, then I'll add three liters of water at intervals till it gets to the uh... perfume.","So if I don do am like dat, all dose tings, na so I go dey put am three, three liters of water till e go reach eh perfume." +"When I've mixed everything in that order, if the water doesn't get to the measurement I wanted, I can add more water to it because if the soap is really thick, people will buy it.","If I don mix everyting like dat, if water no come reach di amount wey I wan make e reach, I fit add am water because if soap tick well, well, people go buy am." +"If it's too watery, it won't lather very well.","If e too watery, e no go dey foam well, well." +So that's how I do mine.,So na so I dey do my own. +And I thank God for my life because I am not a liability to my husband.,And I dey tank God for my life because I no be liability for my husband. +People are buying it!,People dey buy o! +"Even this sister of mine, she uses my soap to wash clothes.","Even dis my sista, na my soap im dey use wash cloth." +All the people in my compound buy soap from me.,All of my compound people dem dey buy soap for my hand. +They are buying it.,Dem dey buy am. +"Even the people on the street, they buy it because they know that my soap okay.","People for street sef, dem dey buy cause de know sey my soap dey okay." +I can bring out one for you to smell.,I fit carry one make you perceive di odour. +The thing is really great.,"Di ting dey okay well, well." +"You can use it to wash plates; you can use it to wash clothes, you can use it to wash your toilet, mop your kitchen.","You fit use am wash plate, you fit use am wash cloth, you fit use am wash your toilet, mop your kitchen." +"Anywhere, anywhere; you can use it for anything, anything.","Anywhere, anywhere, anyting, anyting, you fit use am do." +Nothing wrong with it.,Nothing do am. +No problems at all.,No shaking. +"So, I am alright.",So I dey kampe. +Should I start?,I should start? +"Okay, in this year twenty eighteen, man, I'm praying for God to help me.","Okay at dis year twenty eighteen, omo I dey pray make God help me, helep me." +"Help my business, help everything I do, even my de-, de-, destiny, even my father, even my dad, even my sister, even my future wife, even my girlfriend.","Helep my business, helep everyting I dey do, even my de-... de-... destiny, even my fader, even my papa, even my sister, even my future wife, even my girlfriend." +"Oh eh, God, dear God, help me in whatever I do.","Om-... eh Omo God, Baba God, helep me in anyting I do." +"Help me, hm... even in Enugu where I'm living.","Help me, hm, even dis Enugu wey I dey." +"Help me, even my boss, even whatever, whatever I put my hands on.","Help me, even my boss, even anyting I, anyting wey I put my hand." +"God help me, help me, help me.","Omo help me, help me, help me." +This is my... this is my prayer.,"Dis is my, dis is my prayer." +Okay.,Okay. +"Okay, from now until...",Okay from now to... +"From thi-... from this, uh... January, till after January, I want...","From di, dis eh January, till continue, from January, I wan..." +"From the... from January... from January to, for some... from January to February, God, help my, help my mom.","From di, from January, from January to, for some, from January to February, God, help my, help my mum." +"From February till March, help my father, from March to April, help my girlfriend, from April till December, help my boss.","From February till March, help my dad, from March to April, help my girlfriend, from April to till December, help my boss." +"Uhuh, in this country of ours, Nigeria, I am fed up with this Nigeria.","Ehen for dis our country, Naija, dis Nigeria don tire me." +I wanna move.,I wan travel out. +I wanna go to Malaysia.,I wan go Malay. +"You see this, all the gu-... guys in Malaysia, uh... mtschew, I want to meet up with them.","You see dis, all di Malay ga-... Malay guy ehn, mtschew I wan meet dem dere na." +These guys in Malaysia are really making some money there.,"Dis Malay guy, de dey make am dere now." +I wanna go there.,I wan go dere. +"The guys in Malaysia, I want... I want...","Na Malay guy I wan, I wan..." +I really want to be a Malaysia guy.,I wan be Malay guy now. +I wanna make money in Malaysia.,I wan make money from Malaysia. +Malaysia's where I wanna be.,Na Malaysia I want. +I'm tired of this country.,I don tire for dis country. +"In fact, if I... if I... if I leave this country uh... mtschew, I'm not coming back.","Infact, if I, if I, if I travel out from dis country ehn, mtschew I no go come back again." +I'll stay there forever.,I go stay dere for ever. +This is...,Dis is... +"In fact, I'll marry a white girl.","Infact, I go marry Oyinbo girl." +"I'd even marry a Malay girl, a Malaysian girl.","I go marry even Malay girl, Malaysia girl." +"They are... they're fi-... they, they, they’re fine you know.","Na dem, na dem fi-... na dem, na dem fine pass ehn." +"They, they're even better looking than Nigerian girls.",Na dem f-... fine pass Nigeria girls. +"Even all this hardship in our country has started affecting our, our girls.","Even all dis hardship wey dey for our country, im don dey affect our, our girl." +Okay.,Okay. +"So Malaysia, Malaysia re-... Malaysia remains my top option for now.","So so Malaysia, Malaysia re-... Malaysia remain my option country now." +I don't have any other country apart from Malaysia.,I don't have any oder country apart from Malaysia. +"I want to go to Malaysia, I need Malaysia, I need Malaysia's money, I need Malaysia, everything from Malaysia, even a Malaysian car.","I want to go to Malaysia, I need Malaysia, I need Malaysia money, I need Malaysia, everyting from Malaysia, even Malaysia motor." +I'm tired of Nigeria.,Nigeria don tire. +Almost everything in Nigeria is bad.,Anyting from Nigeria is almost bad ting. +I don't need Nigeria anymore.,I no need Nigeria anymore. +Thank you.,Tank you. +"Yeah, I don't need Nigeria anymore.",I don't need Nigeria anymore yeah. +Nigeria is crappy country.,"Nigeria is a, Nigeria is wowo country." +A crappy country.,Wowo country. +I'm tired of Nigeria.,Nigeria don tire me. +Everything in Nigeria is bad.,Anyting from Nigeria na wowo. +"Noth-, nothing is good in this country where we're... nothing is good, not even the cars.","Not-... noting dey good for dis country wey we dey, noting dey good even di vehicle." +"When it comes to celebrations, we can't pu-... have any?","If e come to festivity, we no fit pu-... produce am?" +"When it comes to hospitals, oh!","If e come to hospital, oho oh!" +"That one, we've suffered too much.","Dat one, we don, hm we don die patapata." +We've...,We don... +Nothing is good in Nigeria.,Noting good for Nigeria. +"Nigeria is, it's a bad country.","Nigeria una, na bad country." +It's a bad country.,Na bad country. +I'd be better off if I went... I'd be better off if I go and die in China than stay in this country now.,"Better mey I go, e better mey I go die for, for China dan to stay in dis country now." +Yeah.,Yeah. +Nigeria's no good anymore.,Nigeria no dey good anymore. +"This time around, Nigeria's prophets are too tough!","Dis time around, Nigeria prophet dey too hard o." +Uh...,E... +"When we... when we... when we get to the New Year, yeah, Nigeria's prophets, they're way too bad.","When we, when we, when we come to New Year ehn, hey, Nigeria prophet, de dey too bad o." +All of them will continue to predict.,Eh all of dem dey continue dey predict. +"All of them, all of them will continue to predict.","All of dem, all of dem de continue dey predict." +And predict.,Dey predict. +"Afterwards, they will tell us God told them.",After de tell us sey na God told dem. +What is it?,Na wetin? +It's not God who told them.,No be God told dem o. +I can't see any God there.,I no see any God dere. +Can God tell some...?,"Can God tell, tell some... ?" +Can God lie?,Can God lie? +How many gods do we have in this world?,How many gods do we have in dis world? +How many prophets do we have?,How many prophet do we have? +This prophet will tell you this.,Dis prophet go tell di oder one. +Another prophet will tell you that.,Anoder prophet go tell you di oder one. +Ah!,Ah! +This kind of prophet is too much!,"Dis kind of, eh dis kind of prophet dey too much o!" +This thing is... this thing is just a Nigerian prophet.,"Dis ting is, dis is just a Nigeria prophet." +It's not God that told them.,No be God ehn told dem. +Mtschew.,Mtschew. +"Uh, I don't want, uh, I don't... I, I don't care for these uh... Nigerian... uh... prophets.","Ah I don't want, eh I don't, I, I don't care for dis eh Nigeria ehn prophet." +They are a lot of trouble.,De dey too much. +They are just using it to make money.,"De just dey use, use am dey make money." +Wh-... what no...,We-... wetin no... +God didn't... God didn't tell them anything.,"God no, God no tell dem anyting." +"Next year, even if there is nothing to fear, nothing to fear, they'll keep going.","In a year, if, even if no fear, no fear now, de go continue." +There's uh... a prediction for twenty nineteen.,Twenty nineteen na ehn prediction. +"Uh... twenty ninety, nineteen, a prophecy, twenty eighteen, a prophecy.","Ehn twenty ninety, nineteen, prophecy, twenty eighteen, prophecy." +That means God only comes once a uh... once in a... in a year.,"Dat means God dey come only once in a, ehn once in a, in a year." +God can tell them gu-... anything once a year.,God dey told dem gu-... anyting once in a year. +God tells this one one thing.,God dey told dis one anoder ting. +God tells a different one another thing.,God dey tell di oder one anoder ting. +Hm!,Hm! +That means God is g-...,Dat means God dey g-... +How many gods do we have?,How many God do we have? +Seriously.,Ehen na. +"Uh, in this country where we, this white oho.","Eh in dis country wey we dey, na white oho." +What uh...,Wetin ehn... +"Light is, light is...","Ehn light na, light na..." +They're giving us...,De dey give us... +"Sometimes, they bring the... they... they bring the light up to one hour, to almost thirty minutes.","E dey time wey bring de, wey de, wey dem bring light up to one hour to close to thirty minutes." +"If they bring it, it is not full voltage.","If de bring am, ehn no full current." +"This country is difficult to live in, the country is very difficult to live in, it is really very hard.","Dis country dey hard o, dis country dey very hard, im dey very, very hard." +"My friend, to tell you the truth, this country is not working.","Nna to tell you di truth, dis country no work." +This is a terrible country.,Dis country na wowo country. +We need another country.,We need anoder country. +"If I go-... if... if it is possible, we should give Nigeria a new name.","If go-... if, if it is possible, make we change dis eh Nigeria to anoder name." +We should turn Nigeria into America.,Mey we change Nigeria to America. +It would be better.,E go better. +"In fact, we should change Nigeria, Nigeria into Biafra.","Haha infact, mey we change Nigeria, Nigeria to Biafra." +Biafra is the best country now.,Na Biafra di best country now. +"Nigeria is, Nigeria is past its prime.","Nigeria don, Nigeria don expire." +Nigeria's not even a country anymore.,Nigeria no be country anymore. +We need another country.,We need anoder country. +"Yeah, we need another country, right?","We na, we need anoder country right?" +"In f-... in fact, we need to change Nigeria into America.",Inf-... infact mey we change Nigeria to America sha. +It would be better that way.,Im go better like dat. +"If you change America to... if you change Nigeria to America, I'm praying fo-... I'm praying for America, American gifts to come to Nigeria.","If you change America to, if you change Nigeria to America, ehen I'm pray fo-... I'm pray so dat America, American gift go come to Nigeria." +American gifts will come to Nigeria so that we...,American gift will come to Nigeria so dat we... +We should try to make our country a good one.,Mey we try make ehn our country dey good. +Okay.,Okay. +"Uh... one time I was with my mom and dad in the village, after I was grown (I was like eight), and my grandmother came to visit us.","Ehm di time wey I dey with my moder, my fader for village, after I con grow (I con dey like eight years), my grand moder con come visit us." +She wanted to take me to go and train me.,Sey e wan carry me go meh e go train me. +"Because at my dad's, we could only go to the farm.","Because for my fader village sef, na only farm, farm, farm we dey go." +"At the time, I was small and could farm really well.","Dat time sef, I dey small, and I sabi do farm well, well." +"My grandmother said this farm, this farm work was no good for me.","My grand moder say dis farm, say dis farm no go good for me." +That I should go to school first.,Meh me a go for school first. +So I went to my grandf-... grandmother's.,Con go my grand f-... moder place. +I was schooled there for four years.,"I dey dere o, I school o, setay four years." +"After those four years, my mom said the work had become too much for her to do alone.","After dat four years now, my moder con say di work alone don dey too much for am." +That I should come help her for a while.,Make me I con help am for some times first. +"I was there, helping her.","I con dey dere, con dey help am." +I kept farming.,"Dey farm, dey farm." +I farmed for almost five years.,I farm almost five years. +I didn't go back to school.,I no go back to school again. +I stayed there,I con dey o. +"Ha! Even for money to buy things, you won't see any money.","Ah to see money to buy tins self, you no go see money." +"For any little thing you do, though, you will make money quick.","But any small tin weh you do, you go quick get money." +"Finding something to do, that was the hard part.","But to see am do, na im con dey hard." +Until there were a lot of us.,Sotay we come plenty o. +"So my friend and I, we started to work together for people.","Me, and my friend, we con dey do work for people together." +"Then, at the end of the year, they would come give us our money.","Den, ending of di year, de go con dey pay us our money." +"We would use it to buy clothes, anything we wanted.","We go use am, go buy cloth, wetin we wan." +We used it to take care of ourselves.,"Dey use am, dey take care of ourself." +"Then we did ""waye"" work again, we got the money and shared it","We con do waye work again, we con get di money, we con share our money together." +All of us said we wanted to go to school.,All of us say we wan go school. +We wanted to go back to school.,We wan go back to school. +"So, then I went to school until two thousand and eight.","So I con go school o, con reach two thousand and eight." +Then I finished primary school there.,I con finish primary school dere. +"I told my father, well, I want to go to the city to go see how the school is.",I tell my fader sey toh me I wan go city mah go see how di school be. +That I was tired of school in the village.,Sey me I don tire for village school. +"My father said okay, he will get money to register me anywhere I want to go to start secondary school.",My fader say okay im go find money wey im go go register me anywhere weh me I wan go start secondary school. +I said okay.,I say okay. +That's what we did.,Na so we con do o. +"My father said it wouldn't be until after December, around January, that he would get me registered.","My fader say after December, January time, before im go go register me." +"So, right then, that my uncle came from Abuja.","So dat moment, na im my uncle con come from Abuja." +He came to construct a building for one of our uncles.,Con do one building for one of our uncle like dat. +He then came.,E con come. +When he was leaving he said I should be ready for him to take me to Abuja.,"E say if im dey go, sey meh me I dey ready, sey im go carry me go Abuja." +"I said ""alright.""",I con say okay. +"""Do you want to take me to Abuja?""",Eh you wan carry me go Abuja? +"He said ""yes.""",E say eh. +"I said ""okay, but uncle, I want to go to school.""","I say toh but uncle, I wan go school o." +He told me not to worry.,E say meh me I no worry. +"If he takes me, I'll go to school.","Sey if e carry me go dere, me I go go school." +So I said okay.,Naim I say okay now. +The time came when we wanted to leave.,Con dey o reach di day weh wan go. +So the two of us got on the bus for Abuja.,Two of us con enter motor come Abuja. +"When I got to Abuja, I stayed there.","As con come Abuja, I con dey." +"At that time, I couldn't... I couldn't speak English fluently but I was getting by.","Dat time self, I no, I no sabi speak English like dat but I dey manage." +"So, then my uncle came.",So my uncle con come. +I was there for like a month.,I con dey like one month. +Now I could speak.,I con sabi dey speak. +Then my uncle said we should go to school.,Naim my uncle say meh we go school. +I then went to school to register.,I con go school go register for school. +It was from there that I started school.,"Na dere I con start school o, con start school." +I went to school and then came back home to stay.,"I dey go school, and I dey come back dey stay house." +I told my uncle I could not stay at home any longer.,"I tell my uncle sey uncle, me I no fit stay for house again o." +"If I come back, if I am back from school, I should find a job to learn.","If I dey come back, if I don come back for school, mah go dey find work weh I wan learn." +My uncle asked what my problem was and why I wanted to learn a trade.,My uncle say wetin be my problem meh me I wan learn work? +"I said uncle, the problem is, nobody knows what the future will bring.","I say uncle, di problem be sey now, nobody know how tomorrow go be." +Maybe I can finish the junior WAEC.,Maybe I fit con finish junior WAEC now. +I don't have any money to go back to school.,I no see money to go back to school again. +"Or look at how, uh... money is now, it doesn’t flow like before any more.","Or e see as eh money now, no dey come like dat before again?" +"So my uncle said ""okay.""",My uncle con say okay. +What did I want to learn?,Sey wetin me I wan go learn now? +I told him I wanted to learn to cut hair.,I tell am sey I wan go learn barbing salon. +"He said okay, I should go for it.",E say okay mah go now. +Then I went to meet a guy I knew.,I con go meet one man wah I know. +I told him I wanted to learn a job from him.,I con tell am sey I wan learn work for im hand. +"He said okay, I should go call my uncle.",Di man say okay meh me I go call my uncle come. +"I told him okay, before I go call my uncle, he'll tell me what to bring","Naim I tell am sey okay before I go go call my uncle come, e go give me wetin, and wetin we go bring." +"Before I go tell my uncle, let me know what he meeds to bring.","Before I go go tell my uncle, meh know wetin e go bring." +He said okay.,E say okay. +"We'll get crates of soft drinks, and some cookies, and money.","Sey we go buy crate of mineral, and some biscuit, with money." +"Since he knows me, we'll bring eight thousand naira.","Sey as e know me, meh we bring eight thousand." +I said okay.,I say okay. +I went to meet my uncle.,I go meet my uncle. +"So my uncle said okay, tomorrow morning, before he goes to work, I'll take him there.","Naim my uncle con say okay tomorrow morning, before im go work, meh me I carry am go dere." +So we went there and met the guy,"We con go dere, we con meet di man." +"He told the guy that he would bring al-, everything he had listed.",E con tell di man di day weh e go bring al-... everytin weh di man talk. +"The man said okay, I can start learning today.",Di man say okay meh me I start to dey learn work today. +I then stayed there learning the trade.,I con dey dey learn work o. +Then my uncle brought everything.,Naim my uncle con bring everytin come. +The man said I'd stay with him for five years to learn the job.,Di man say na five years me I go dey im hand meh me I learn di work. +"I then told him ""well, but what if I master the skills before the five years, I can go open my own shop, right?""","I con tell am sey toh but if I sabi before dat five years nko, I fit go open my own shop right?" +He said yes but I will graduate first before I go open my own shop.,E say eh but I go do freedom first before I go open my own shop. +"I said ""okay, if that's it, no problem.""","I say okay if na dat one, no problem!" +So I continued working on and on and on.,"Con dey work, dey work, dey work, dey work o." +Until the time came that I wanted to write the junior WAEC.,Con reach when I wan write junior WAEC. +I already mastered the job and was making money.,"I con sabi di work now, and money." +"I then realized that in this country of ours, things were starting to become difficult.","I con see sey dis our country, tins go con dey hard now." +"I then told my boss ""Well, there is this job I found.""",I con tell my oga sey toh e get one work weh me I see o. +"""Let me go do it and they will pay me.""","Mah go do, and dem go pay me money." +"""So if they pay me, I will get the money for my graduation.""","So dat if de pay me di money, mah see money wah go con do freedom." +"My boss said ""okay"", I should go.","My oga say okay, meh me I go now." +"As long as place I was going was good, I should be careful there.","Sey as far as di place weh me I dey go good, meh me I dey careful for dere." +"I said ""okay.""",I say okay. +I was there.,I con dey o. +I went to work.,Con go dey work. +"After I worked and the woman paid me, I started completing the junior WAEC.","After I work wey di woman dey pay me my money, I come from dere finish my junior WAEC." +"Before I could get the money, my uncle gave me some.","Before I con go find money, my uncle con give me some money." +I went to register for senior high.,"I go register for secondary, senior secondary school." +"From there I went to school until the last year, two thousand and sixteen, when I wanted to write the WAEC.","Na dere I con dey go school, dey go school till last year, two thousand and sixteen wah wan write WAEC." +"Even sometimes, to pay tuition, I would, I wouldn't have the money to pay on time.","Sometime sef, to pay school fees, I go con, I no go see money to pay quick." +So they would send me home.,De go con dey pursue me dey come house. +I didn't go to school for like a week.,"Like some one week, I no go go school." +I said let me go and get a manual job.,I say mah go find labourer work. +Maybe I would get something to pay my tuition so my uncle could help me with the rest.,Maybe I go fit get school fees wey a go pay so dat meh my uncle dey support me for di remain one wey I no get. +I was working.,I con dey do. +Until the time we wanted to write the WAEC.,Reach di time when we wan write WAEC. +I couldn't make money.,I no con get money. +And my uncle didn't have any money either.,"And my uncle, e no con get money." +One of his in-laws was even sick.,And one of im inlaw dey sick sef. +"All the money he had, he used for his hospital bills.","All money wey im get, e con carry am go pay im hospital bill." +"From there, one day, I told my uncle ""look at the WAEC, the WAEC is here.""","And from there, I con tell my uncle one day sey see WAEC now, e don come now." +People had started registering.,People don dey register. +I never registered.,"Me, I never register." +So how will I take the exam?,How me I go take write now? +"My uncle said well, if I didn't do it this year, I shouldn't get angry, I should go get a job and he too would try his best.","My uncle say toh if me I no write dis year, meh me I no vex sey I go go find work do, and im too go try im best." +"The following year, I might be able to take the exam.",Till next year me I fit go write. +"I told my uncle ""okay, let's see what God can do.""",I tell my uncle sey okay now moh dey see how God go do. +I was there hoping.,I con dey. +I had no job.,Work no dey o. +I kept looking for a job.,"I find work, find work, find work." +There was no job.,Work no dey. +"For almost half a year, I didn't find any job.","Complete almost half a year, I no see any work do." +"One day, my uncle told me he'd seen a place.","One day, my uncle con tell me sey im get one place wey im see." +I should let him take me there to work.,Meh im carry me go dere mah go work. +I went.,I con go dere. +"After working for a month, at the end of the month, the woman should pay me.","After work one month, month don end, meh di woman pay me money." +The woman said she didn't have the money.,Di madam say money no dey im hand now. +I should wait a few weeks.,Meh me I wait for some week. +"I repeated ""a few weeks?""",I con say some week? +"She said ""yes.""",E say eh. +"Years had passed, and the WAEC was coming up.","And dat time, years don dey, time of WAEC don dey reach." +"I said ""okay, no problem.""","I say, okay no wahala now!" +I waited.,I con wait o. +Until the day the woman wanted to pay me.,Con reach di day weh di woman wan give me money. +"She paid me and said well, I couldn't keep working.",E give me money say toh me I no fit continue work again. +"I said ""hey! What's the problem?""",I say ah wetin be di problem? +She said she couldn't keep owing me money.,E say e no fit dey owe me money again. +"That even for the work I just did, paying me was difficult.","Sey di one weh me I work now, to pay for me, e dey hard for am." +"I said ""okay, no problem!""","I say okay now, no problem!" +That was how I went back.,Naim I con go back. +This year I'm going to take the WAEC exam again.,Con reach dis year again to go write WAEC. +This year is the worst.,Na dis year own ma con worse pass. +I haven't had any work this year at all.,I no see any work do throughout dis year at all. +Even getting by is by God's grace.,"Even to succeed sef, na by, na by God grace." +Now I am managing.,Now I take dey manage. +"Then I said ""well, uncle, can't I take the WAEC exam this year?""","I con say toh my uncle, dis year again o, I no go write WAEC again?" +"My uncle said ""well, he doesn't have any money.""",My uncle say toh money no dey im hand. +Taking the WAEC exam costs thirty eight thousand naira now.,"Sey WAEC now, na thirty eight thousand de dey write o." +"I said that before I take the WAEC, I need almost fifty thousand.","I say before me I go write WAEC now, de go hold almost like fifty thousand." +Let me register for the NECO and WAEC together.,"Sey meh me I register NECO, and WAEC togeder now." +Everything will cost a lot of money.,Everytin go be big money. +"I said ""okay.""",I say okay. +"He said ""what we will do is, at the end of the year, I will go for coaching classes.""",E say di tin weh we go do be sey if year don dey end me I go go for lesson. +Let me go and take classes.,Meh me I go take lesson. +"I said ""okay.""",I say okay. +"There came a time, two months ago, when they were sitting for the JAMB.","E con reach one certain time, last two month weh de dey write JAMB." +"I told my uncle ""Well, the JAMB is here, can I go take it too?""","I tell my uncle sey toh JAMB don come, I fit follow dem go write o?" +"My uncle said well, I could go take it.",My uncle say toh me I fit go write. +"But he asked what I wanted to study there, since I did not know what it would be like.",E say but wetin me I wan go read dere now wey me I never see how di tin go be. +"I said ""well, I know a bit about computers.""","I say toh me I sabi operate computer small, small." +"But before they start, they will teach us how to go about it and so we went there.","So anyhow weh be before de go start, de go teach us lesson, how we go take do, how we con go dere." +My uncle said I should go ask how much registration would cost.,My uncle say okay meh me I go ask how much for di registration. +I went.,I con go. +"They told me it is five, five, that is how they do it.","De con tell me sey na five, five na im dem dey do am." +Then I went to meet my uncle and told him the price.,I con meet my uncle sey see di money weh de say de dey pay o. +"My uncle said okay, I should go.","My uncle say okay now, meh me I go." +"I should come, he would go borrow the money to give me.","Meh me I come, meh im go borrow di money give me." +I came and he borrowed the money.,"I con come, e con borrow di money." +Then he gave it to me.,Con give me. +I went to register.,Con go register. +"After I registered, I took the JAMB exam.","After register, con, I con write di JAMB." +"After I took it, I was biding my time.","After write di jamb now, I con dey now." +"So then, one day, my uncle asked about the result, and if I passed, where I would want to go afterwards.","So my uncle con ask me one day sey dis result now, e say if me I collect now, where me I wan go now?" +Would I go to a university or would I go...?,"Sey me I go go university, or I go..." +"I said ""well, even though I will go to university, I do not have my WAEC results yet.""","I say toh even though I go go university, I never get WAEC result o." +"""I can't go like that.""",I no fit go like dat o. +"He said ""okay.""",E say okay. +There was no money for the WAEC.,Sey money now no dey to write WAEC. +I want to go to university.,Na university me I wan go. +"I said ""well, then let us see what God will do for us.""",I say toh moh dey see wetin God go do for us now. +"Especially, with the way our country is at the moment, we don't have anything anymore.","And dis one wey our country now, notin dey at all again." +"Even people who are working for the government, they're complaining about not having any money either.","Even people weh de dey work for government sef, de dey complain now sey de, money no dey deir own hand too." +"Alright, sports fans, welcome to another wonderful morning on Sports Radio, eighty eight point nine, Brilla for real, ah... an outstanding station in the nation; a station that brings the whole country to a standstill when it comes to sports!","All right, sports fans, una welcome to anoder wonderful morning for sports radio, eighty eight point nine, Brilla for real, ah one station too much for di nation, one station wen dey hold di full country to ransom for di world of sport ah." +"And I tell you, if you're not here, you're lost.","And I tell you if you no go, you no know." +Testimony time is not meant for the dead and dumb!,Testimony time no be for deaf and dumb ah. +"Let me take you straight to France uh... where Paris St Germain Captain, Tiago Silva, said that what is happening to Edinson Cavani and Javier Pastore is not good for the French giants uh... as they continued to leave them on the bench uh... Cavani and Pastore were not on the squad list as Paris Saint Germain reached the Cup de La Cupa semi finals, courtesy of their two - zero victory over Famyes uh... on Wednesday, following their late return to training.","Make I begin dey take you straight ah to France ah where Paris Saint Germain captain, Tiago Silva don come out talk sey di kind matter wen dey waka leave Edinson Cavani, and Javier Pastore no dey good for di French giant ah as de continue to leave dem for bench eh Cavani, and Pastore wen waka lost for di squad ah as Paris Saint Germain reach di Cup de La Cupa here semifinal courtesy of deir two zero gbege wen dem knack put Famyes dem head ah wen sele on Wednesday after di two waka lost leave party follow body as de no come back to training on time." +"And from there, let me tell you another one from France.",And from dat one make I dey knack you anoder French one ah. +"From there to England, you don’t need a passport, you don’t need a visa.","From dat one to England, you no need passport, you no need visa." +Just follow me on my bicycle.,Just follow me for my keke. +"Let me tell you that Antonio Conte has told Chelsea that it's better for them to discover how to score goals again uh... after they were held to a mid-week zero - zero draw by Everton, that was four days from the one in Norwich.","Make I let you know sey Antonio Conte don tell Chelsea sey make de better come con discover how de take dey score goal again ah after de chop zero, zero draw for Everton head for di mid week wen sele four days from di one wen dem chop wit Norwich eh." +"As they play goalless ties, he has come out to say that we will not continue this way.","As de play goalless draw, di man don come out talk sey we no go continue like dis." +Are you planning to go higher by these means?,Na dis leg you wan take waka travel go obodo Oyinbo? +"You need to make sure that with your playing style, you begin to score goals, otherwise, the issue will get out of hand.","Una need to come make sure sey with way wey una dey play, una begin score goals, oderwise matter go leave us loss ah." +And let me take you straight to the top stories in the world of sports.,And make I take you straight to kepukepu wen dey fly for di world of sport ah. +"And let me inform you that Everton uh... has joined the race to sign Arsenal forward, Theo Walcott.","And make I let you know sey Everton ah, de don join di race to sign Arsenal forward, Theo Walcott ah." +The boy is twenty eight years old.,"Twenty eight years, na im di boy don be." +"The Englishman is also wanted by his former club, Southampton.","Di English man dey wanted by former club, Southampton ah." +While the Gunners are also asking for thirty million pounds uh... for the boy.,Wey di Gunners also dey ask for thirty million pounds ah for di boy. +"And let me tell you that RB Leipzig in Germany uh... has informed Guinean international midfielder, Naby Keita, that he will join Liverpool this month.","And make I tell you sey RB Leipzig for Germany eh don tell Guinea international midfielder, Naby Keita sey im go join Liverpool dis month ah." +The Reds have already agreed to sign the twenty two year old in the summer at a sum of forty eight million pounds.,Di Red don already agree to sign di twenty two years old for di summer for forty eight million pounds ah. +They have stated that if they add fifteen million to twenty million pounds in January uh... the boy can leave as soon as possible.,"De don tell am sey for January, if de add fifteen to twenty million pounds ah, di boy fit make di waka as e dey hot ah." +"The Republic of Ireland's head coach, Martin O'Neill, is getting set to take charge of Stoke City as he is speaking with the manager who lost his job when he was sacked by an SMS telling him, ""Mr Man, you have done enough.""","Republic of Ireland coach lala, Martin O'neill don dey set to take over Stoke City matter as e dey hold talk wit di manager wen waka loss for di job when dem sack am wit SMS tell am sey bros, di one wey you work don reach eh." +And let me tell you the last story coming from Arsenal.,And make I give you final tory wen dey come from Arsenal. +"Let me inform you that the former Arsenal Striker, Ian Wright uh... has asked Messi's agent to make sure that if the guy moves to Manchester United, he will perform very well.","Make I let you know sey former Arsenal striker, Ian Wright eh don come out tell di agent ah of Messi to see sey e go do very well if di guy waka go Manchester United." +He said Ozil who had no issues at the end of the season uh... the German international playmaker is closing on a new signing deal to let Alexis Sanchez out of Emirates Stadium.,"E say Ozil wen no get matter for di end of di season ah, wey di Germany international play maker dey closing on a new signing deal to allow Alexis Sanchez out of Emirate Stadium too follow join body." +"The twenty nine year old who has worked with Jose Mourinho while at Real Madrid uh... has announced that if he moves to Manchester United, he will perform very well because the kind of mentality they have uh... and the level of players uh... on top of the league uh... are different from what you get from the youngsters uh... running up and down in Arsenal's jersey.","Di twenty nine year old wen don work wit Jose Mourinho for im time wen de sit down for Real Madrid ah don come out talk sey if dis boy waka go Man U, e go do very well because di kind of mentality wen dem get ah, and di level of players ah wen de press dey put on top of di League ah dey different from wetin you dey see for small children ah wen sit down dey run up and down inside Arsenal jersey." +"And let me inform you that in Spain uh... a man named Zinedine Zidane has said that his new contract does not ma-... is of no concern to him at all following his side's two matches, with a draw at home with... against the second tier side, Numancia.","And make I let you know sey for Spain ah, one man wen de dey call Zinedine Zidane don come out talk sey im new contract no ma-... concern am at all, at all after im side play two, con do draw for home wit, against second tier side Numancia." +"Concerning the Copa del Rey which came up on Wednesday, Madrid settled for a five - two aggregate uh... with their first three - zero victory over the kids to ensure they got through to the next stage uh... of the competition.","For di Copa del Rey wen sele on Wednesday, Madrid wen waka go for five two aggregate ah wit deir first three zero gbege wen de knack put for di small boys dem body take make sure sey de waka go di next stage ah of di competition ah." +"My people, this is where I will call it a day this wonderful morning, so don't worry.","My people, na here I go hold brake dis wonderful morning make e for no loss." +My name remains Apostle of the Comedy Kings on the microphone.,My name remain Aposu over di comedy king upon di microphone ah. +"I say as things unfold this morning, stay in charge!","I say as e dey be dis morning ah, hold your side well!" +"If you drink, do not drive; if you drive, don’t drink!","If you go drink, no drive, if you go drive, no drink!" +"If you really have to drink something, let it be cold and pure water.","Even if you go drink someting, make e be cold, pure water." +"Thank you, my people!","My people, una do o!" +"Uh, the day...",Eh di day... +"I want to talk about uh, the... how I spent my Christmas last year.","I want talk about em di, how I spend my Christmas last year." +"Well, it was nice.",E sweet sha. +"Me, I don’t kno-... I don’t know how to go out at Christmas.","Me ma, I no sab-... I no sabi go out for Christmas." +"Every Christmas, I like staying at home.","Every Christmas, I dey like stay for home." +It was my sister who started it.,Na my sister wey cause am. +"Even she, she didn't know how to go out at Christmas.","She ma sef, she no sabi go out in Christmas." +What would she do?,Wetin she go do? +"On the twenty fifth, we would cook.","Twenty fifth, we go cook." +"After cooking, we would eat.","After cooking, we go eat." +"After eating, we would stay at home, watch movies, drink, do whatever.","After eating, we go stay for home, watch film, drink, do everyting." +"But this last Christmas, my cousin said no.","But dis last Christmas, my cousin say no." +She said I needed to relax and go out.,"Sey I must cool, and go out." +I told her okay.,I tell am sey okay. +She said I should go and get ready.,She say meh I go prepare. +I finished getting ready.,I con prepare finish. +I was just putting on makeup.,I just dey draw makeup o. +The first time I ever wore makeup was that last Christmas.,Na di first time wey I wear makeup be dat last Christmas. +So she told me I should sit down.,So she con tell me sey mey I siddown. +"Then she applied my makeup, ha!",She con do me makeup ha. +I was no longer myself.,I no be myself again. +I didn’t even...,I no even... +"Even the picture I snapped myself, the picture, I don’t...","Even di picture wey I snap ma sef, di picture, I no..." +"Uh... If I look at the picture, always think that I can't be that good looking girl.","Eh if I see di picture, I no say na me fine reach dat one." +"So, we got going.","So, we con begin go." +"I asked her, ""where are we going?""",I tell am sey where we dey go? +"She told me I should get on the bus first, and we'd go.","She tell me sey mey I enter bus first, we go go." +I told her okay.,I tell am sey okay. +Then we got to the bus.,We con reach bus. +She snapped pictures.,She con snap picture o. +Then she told me...,She con tell me... +She posted them on Instagram.,She con post am for Instagram. +"Then she said, ""my cousin who never goes out, thank God I took her out today.""","Con say my cousin wey no dey go out, tank God sey I carry am go out today." +Hah!,Heh! +"Then I asked, ""what will I do?""",Con tell wetin I go do? +She said I wasn't going to do anything.,Sey I no go do anyting. +So I relaxed.,I con relax. +"So, we went.","So, we con go." +We went to Ogui Road.,We con go Ogui Road. +I didn’t know it was New Berries which is... or there was a place like that.,"I no know sey na New Berries wey dey, abi na dat place dey." +That was the first time I went to New Berries.,Na first time wey I dey go New Berries be dat. +"So we reached Ogui, then stopped and walked to New Berries.","So we con reach Ogui, con stop, trek go New Berries." +"When we got there, there was a lot of people because it was Christmas.","When we reach, people plenty now because sey na Christmas." +So there were so many people.,So de go plenty. +They were looking for...,De dey find... +They were selling tickets.,De dey sell ticket. +"So we went to buy tickets, bought tickets before going.","So we go buy ticket, buy ticket come." +"But, well, it was fine.",But e fine sha. +Because I wasn’t going alone.,Because no be only me go. +"I was with one of my sisters, and uh, that cousin of mine.","I go with one of my sister sef, and eh dat my cousin." +We ate and ate and ate.,"We eat, eat, eat." +"So we met people, they bought us food, and then bought us drinks.","So we con meet person, de con buy us food, con buy us drink." +"We exchanged numbers, did everything.","We exchange number, do everyting." +"We ju-, we just went home around... around... like after eight, before nine.","We ju, we just went home around, around, like after eight, to nine." +That's when we left New Berries.,Na im wey we comot for New Berries. +Then they said they wanted to do a video chat on the road.,De con say de want do video chatting for road. +"They took my phone and were snapping pictures, shouting in the street, ""merry Christmas, merry Christmas.""","De con carry my phone dey snap picture, dey shout for road sey na merry Christmas, merry Christmas." +"Then I told them, ""stop that!""",Con tell am sey mey una stop di ting wey una dey do. +You're embarassing me while I'm following you.,Sey una dey disgrace me mysef wey follow una. +So we hopped on a bus.,So we con enter bus. +"We waited for the bus mstchew, for about thirty minutes before we saw one, then we started heading home.","We wait for bus mtschew like about thirty minutes before we con see bus, we con begin go home." +"They got to another bus stop, then they started doing this thing.","De con reach anoda bustop, con begin do di tin." +"Then I told them ""please, I'm really sleepy, let them... let's go now.""","Den dey tell dem sey abeg, na sleep wey dey catch me, mey de do f-... mey we go first." +"Then we left first, got home.","Den we con go first, con reach home." +That was how we took...,Na so we take... +"Uh, uh... well, that was how I celebrated Christmas.",Eh eh na so I take do di Christmas sha. +It was very nice.,E dey very sweet. +"Um... for me, to move Nigeria forward, we need to understand ourselves.","Ehm for me, to move Nigeria forward, na make we understand ourselves." +Um... so many things are dividing us as Nigerians.,Ehm plenty tings dey separate Nigerians dem. +"And we will not be able to move forward until we get united, when we work hand in hand and come together.","And na until we unite wesef, na when we come put hand togeder, join body togeder na im we go fit move tings forward." +What I'm I trying to say is that when an Igbo man will not see himself just as an Igbo man; when a Yoruba man will not see himself only as a Yoruba man; where a Hausa man will not see himself as a Hausa man; when an Itsekiri man will not see himself as an Itsekiri man; when someone from Rivers State will not see himself as h-... someone from Rivers State.,"Wetin I dey try talk about, when Igbo man no go see imsef just as Igbo man, when Yoruba man no go see imsef as Yoruba man, where Hausa man no go see imsef as Hausa man, when Itsekiri no go see imsef as Itsekiri, when Rivers person no go see imsef as h-... Rivers person." +"Let everyone see themselves first as a Nigerian, before making reference to their tribes.",Make everybody see demsef as Nigerian first before deir tribe. +"Until we get to that level, moving ahead will be difficult.","Den until we get dat level, e go hard for us." +Because how will you...?,Because how you go... ? +"You'll hear young people from a certain area saying, ""no, you are... you're not from our tribe, so you need to leave this area.""","You go see youths dem wey dey certain area go talk sey no una be, una no be our people, una must comot for our side." +It doesn’t make sense.,E no make sense. +"Because if you look around, there's nowhere in this country where you have people of one tribe only.","Because if you check, no place wey dey for dis country, wey no one tribe enter." +Do you want to talk about Lagos?,Shey na Lagos you wan mention? +Or is it Abuja?,Abi na Abuja? +You will see people of all tribes in these states.,You go see all di tribe dem for inside dis state. +"If you go to Enugu, it's the same thing; if you go to Lagos it's the same thing; if you go to Rivers State, it's the same thing; or in Calabar, it's the same thing.","You enter Enugu, di same ting, you enter Lagos, di same ting, you enter even Rivers, di same ting, abi na Calabar, di same ting." +What binds us together is this country.,"Di ting wey join us togeder, na di country." +"And we're in the country together, right from Imo River.",And we don dey inside the country togeder right from Imo river. +Until we're able to take the dirt away from us...,Na until we fit comot dat dirty from o. +And just a few people whose selfish interests make them ruin the process; they just don’t want the people to make progress.,"And na just some people dem wey be sey because of deir selfish gain, wetin de gain selfishly, na im dey make dem meh dem dey put sand, sand, no just want make people dem develop." +And... but the funny thing is that social media has opened the eyes of so many people.,And but di funny ting be sey social media wey don dey ground now don open eyes of plenty people dem. +Some may get enlightened in a good way while others may get enlightened in a bad way.,"Some may open deir eyes in di right way, some may open deir eyes in di wrong way." +"Because these people with selfish interests also understand that if they don’t keep up with social media, they say that all the people who are under their control will be lost.","Because dese people dem wey be sey de get selfish gain, dem mahnsef understand sey dat social media, if dem mahnsef no jump ontop am, de say di people dem wey be sey, de dey control go loss." +So they come onto social media for their campaigns.,"Naim de enter inside social media, don begin dey do some kind campaign." +"You will notice on Whatsapp,",You go see WhatsApp. +Someone will just...,Person go just... +"They'll write a stupid post, spread it, make everyone hear about it.","E go compose one kind nonsense post, spread am, make everybody hear am." +People reading it will not take time to confirm it.,"People wey be sey dey read am, de no go take time confirm." +"They'll just read it at face value, start spreading it all around as uh... rumor mongers that we have now, they will start uh... sh-... uh... sharing it from one person to the other, planting the seeds of evil in the minds of uh... different people.","De go just read am like dat, begin spread am up, and down as eh amebo rumour mongers dat de is now, begin dey eh sh-... eh share am from one person, to di oder, just dey plant evil seed inside eh different people dem." +"Before you know what is happening, someone will start developing hatred for a fellow human being who happens to be from another tribe.","Before you know anyting, person go just see im fellow human being wey come from anoder tribe, e go begin vex for am." +What for?,Sake of wetin? +Because they're not from the same tribe.,Sake cos sey de no be from di same tribe. +"But for us to move ahead, the youth will have to understand that when they come and say if an election comes up, take this, go vote for me, disorganize things, and steal ballot boxes... until we realize that we are mortgaging... (when I say mortgage, that's not clear), we are selling our future.","But for us to move forward, na for di youth dem to understand sey, dat one tin wey be sey de dey give dem say okay if election come o, take go vote for me, take go scatter dis, take go thief ballot box, until we realize sey we dey mortgage (when I say mortgage, na grammar), we dey sell we future." +"We need to understand that the future is now, not tomorrow.","We need to understand sey di future, na now, no be tomorrow." +"All those things they're telling us about the future... the youth are the leaders of tomorrow, no!","All dat one wey de dey tell us sey di future, di leaders of tomorrow, na di youth dem, no o." +The youth are the leaders of today.,Di leaders of today na di youths. +Not tomorrow.,No be tomorrow. +Take France for example!,Take for example France! +Or what country should I mention?,Abi na which country I wan begin dey call? +Very young people are getting into seats of power.,"Young, young people don dey enter inside power." +The old people should start serving as advisers while the young people are working.,"Meh di old people dey advice, meh di young people dem dey work." +"Yes, we know that we need the elderly because they have seen it all, and people do say that you can't claim to be experienced in something you have not experienced.","Yes we know sey we need di old people dem because de don see am, and de talk sey you no fit get experience without seeing am." +They can advise while the young people are working.,De fit dey advice while di young people dem dey work. +That’s the only way we can move forward.,Na di only way we fit move forward be dat o. +"Well, the issue of uh... restructuring and... where some people are saying that some others are outsiders in their communities, they're not supposed to be there.","Well di matter of eh restructuring, and wey some people dey talk sey some people na stranger for deir community, de no suppose dey dere." +"If you check, some of the biggest investments in some areas...","If you check, some of di biggest investments, for some areas..." +"Let me draw examples from Kogi State where I had my secondary school education, Eda, to be precise.","Make I take example for Kogi State wey I do my secondary school, Eda to be precise." +"At that time, one of their biggest boutiques where they sell clothes and other things people wear, was owned by someone from the Igboland.","Dat time, one of di biggest boutiques wey dem get, wey dey sell cloth, and oder, oder tings dem, wey person dey wear for body, na Igbo person get am." +It was not owned by someone from that tribe.,No be person wey be sey na from dat tribe get am. +"Until we understand that yes, whatever is in our vicinity is ours!","Until we understand sey yes o, we get we own!" +But we cannot do everything together.,But we no fit do everyting togeder. +"Take a look at the motor cars, the whole process of manufacturing was not done by the company who assembled it.","As motor take be reach, no be di same company wey dey do di car do everyting." +It must work with other people in order to complete all the necessary things.,E must join body with oder people dem to fit complete wetin de need. +"The electrics, the mechanics, the oil.","Di electrical, di mechanical, di oil." +"They can't be producing the oil they use but they will meet and partner with the ones producing oil, so that they can work together.","De fit no dey produce di oil, but de go meet people dem wey be sey de produce oil, join hand togeder." +Take farming as an example.,Take for example farm mahnsef. +"If a farmer plants uh... cassava and the cassava grows and he digs it up, will he carry it on his head when going to the market?","If farmer plant eh cassava, cassava grow, e comot am for ground, e go carry am for head go market?" +He will get in a car.,E go enter motor. +It may be that the car is not his own.,E fit be sey no be im get di motor mahnsef. +Someone else drives the car.,Na anoder person dey drive di motor. +It may so happen that the driver is not from his tribe.,E fit be sey di person wey dey drive di motor no be im tribe person. +"Until we understand all these little things, that when we get connected in little ways, we eventually achieve what we find.","Na until we understand dese little, little tings dem say na small, small na im we fit join body togeder take achieve wetin we dey find." +"We can't just be, be, just be... be pretending that okay, we will do it; we will make it ours.","We no fit just dey, dey, just dey, dey form sey okay, we go do am, we go do am we own." +No island...,No island... +"I mean, no man is an island.",Abi no man be island. +"You need your brother as much as you need your sister; and likewise, you need your mother and your father to move on.","You need your broder as you need your sister, and likewise as you need your mama, and papa to take move forward." +"So all those verbal attacks of calling others strangers, strangers, are lies.","So all dat talk of sey stranger, stranger, na lie." +Who is the richest man in Africa now?,Who be di richest man now for Africa? +Is he not a Northerner?,No be Northerner? +We know that all the...,We know sey all di... +"There are so many other wealthy people around, but they don’t publicize it.","E get some oder people dem wey be sey de get money, but no dey loud am." +"Until we decide that yes, this person... if we have noticed that they can help us develop our land, then we should accept them, they help develop the land and we benefit from it.","But until we decide sey yes o, dis person, if we don see sey im fit help us develop we land, den we accept am, e develop di land, we gain for inside am." +They themselves will benefit from the venture.,Im mahnsef gain for inside am. +So many investments by the investors.,Plenty investment by people dem wey be sey de invest. +"Take Dangote, the richest man in Africa, as an example.","Check for example Dangote now, di richest man for Africa." +Is he not planning to build a refinery in Lagos?,No be Lagos now e don dey plan to build refinery? +Did he think of his homeland?,E tink of im side? +Are most companies not in Lagos?,Most of im company no be Lagos? +Because he has discovered that the necessary capacities are not available over there.,Because e don see sey di capacity no dey dat side. +Nearness to raw materials may be the reason for building it over there.,"E fit be sey because of nearness to di raw materials, e build am for dat side." +"He can't say that okay, because uh... you are rich, you will build a refinery in the desert, right?","E no fit talk sey okay because now eh you get money, you want build refinery, you carry am go build for inside desert?" +How do you access the oil?,How you wan take collect di oil? +"You will go to the people who own oil reserves, talk to them, enter into agreement with them, and then move forward.","You go go di people dem wey get di oil, talk to dem, do agreement wit dem, den move forward." +"But due to the events of the past, so many people felt that oh, because uh... some people want to take over the resources on their lands, they refuse to dialogue with them or compensate them.","But because of wetin don dey happen for past, plenty people don feel sey oh because eh some people wan come collect wetin dey deir land, de no settle down gist to dem compensate dem." +"Even if they put it on paper, they don’t put it in...","Even dough sey dem put am for paper, de no put am for..." +"Some of the people who go to represent them will fail to speak out in favour of their people, instead, they pocket some money and keep quiet.","Some people wey be sey de even go represent dem, when e reach where de suppose talk, de go just carry small change put for deir back pocket." +"They will say, ""ah, mstchew, he has done his best.""",De go say ah mtschew e don try. +The keep their mouths shut.,De close mouth. +So these are the things we need to do.,So na all dese tings dem we need to do. +Reorientation.,Reorientation. +Start teaching the people so they understand... until we reorientate all the youth.,Begin dey teach di people make de understand until we reorientate di youth dem. +"Talk to them saying, ""this is it... this is it.""","Tell dem sey see as e be, see as e be!" +Really make them understand.,Make de understand really. +Not that they will be brainwashed.,No be di one wey be sey de brainwash dem. +Tell them the honest truth.,Tell dem di honest truth. +"Then, we will move forward.","Den, we go move forward." +All the talk about strangers will be pushed aside and they will allocate what is supposed to be for Mister A to Mister A.,"All di talk of stranger, dey go push go one side, and allocate wetin suppose be for Mista A meh e be for Mista A." +What is supposed to be for Mister B will be given to Mister B.,"Wetin suppose be for Mista B, meh e be for am." +And not steal what belongs to Mister B for Mister C.,"No be when you carry Mista B own go tief, go give Mista C." +It doesn't work that way.,E no dey work like dat. +"Now, Radio Sapientia, ninety five point three FM, Onitsha, you are all enjoying yourselves this beautiful evening as five of the crew uncles are already seated inside.","Now, Radio Sapientia, ninety five point three FM Onitsha, una just dey flex dis kajad evening as five of crew uncle don already balance inside." +"Today is Wednesday, the tenth, two thousand and eighteen, and my name is Jovia Uchena.","Today na Wednesday tenth two thousand and eighteen, and my name na Jovia Uchena." +The National Examination Council has released the two thousand and seventeen November December Senior School Certificate Examination results.,National Examination Council don sama two thousand and seventeen November December Senior School Certificate examination result. +"Another one here says the Independent National Electoral Commission has brought out guidelines, and also a schedule of activities relating to the elections.","Anoder one here dey yarn sey Independent National Electoral Commission don bring guidelines, and join schedule as e concern election parole." +And they asked all the political parties to quickly go and collect forms for all elections.,And de con tell all of dem political parties to kpakpakpa go collect forms for all election. +"That this should be done before August twenty fourth, two thousand and eighteen.",Sey make de do am before August twenty fourth two thousand and eighteen. +The Joint Admissions and Matriculation Board has fixed February sixth as the final deadline.,"Joint Admissions and Matriculation Board don fix February six say na im go be last, last." +They will sell the registration forms for this year's Unified Tertiary Matriculation Examination.,Dem go sell registration form for dis year Unified Tertiary Matriculation Examination. +"And another report here says that the Delta State's Commissioner for Information, that is Mister Patrick Ukah, congratulates all the twenty three Chairmen of Local Government Councils.",And anoder one here dey yarn sey Delta State Commissioner for Information (dat na Mister Patrick Uka) come jinger all dem twenty three chairmo. +They just got elected in the Local Government Councils.,Dem just elect for local government council. +He said that they should not act disgracefully because the people who voted them into power have the utmost faith in them that they will try as much as possible to fulfil all the promises made during election campaigns.,"Sey make dem no come dey fall hand say as people wey elect dem believe dem die, sey dem go try wella do every dem dey promise during election campaign." +And the last one here is from abroad and it's from uh... Zimbabwe.,"And final, final one here na from obodo Oyibo, and den na from ehn Zimbabwe." +"The Anti Corruption Agency has been probing into whether or not the former First Lady, Grace Mugabe, obtained her doctorate degree in a fraudulent manner.","Anti Corruption Agency don dey torchlight everything to know wheder di before, before First Lady, Grace Mugabe don go do wayo, wayo knack doctorate." +Remember that she was awarded an honorary doctorate just after she gained admission into the university in two thousand and fourteen.,"Remember sey dem sama am award PhD just months after im, im go inside university for two thousand and fourteen." +"And even before anyone can get a doctorate degree, they must have put in many years of full time research.","And even as before person go get doctorate, im go do full time research for plenty years." +"And this is where I will call it a day and take a break as you continue to enjoy the programs on Radio Sapientia, ninety five point three FM, Onitsha.","And na here I go close my mouth, drink small water as una dey here dey gbadun di parole on top Radio Sapientia, ninety five point three FM Onitsha." +"My people, that is today's five o' clock news flash.","My people, na short, short story as e take concern five o'clock today be dat." +This is the end of the story.,I don remove for di tory. +My name is Jovia Uchena.,My name na Jovia Uchena. +"Do remember that big eyes do not guarantee good sight, nor does having a big head translate to being in control.","Remember sey ogbolo eye, e no be open eye, and again, big head, e no be senior." +Good evening.,Una good evening inside dis evening. +"Mama, good evening, ma.","Mama, good evening Ma." +Good evening my daughter.,Good evening my daughter. +"Mama, I like this egg of yours.","Mama, I like dis your egg." +How much are you selling it for?,How much you dey sell am? +Fifty naira.,I dey sell am na fifty naira. +Fifty naira?,Fifty naira? +Uhuh!,Ehen! +Ah!,Ah! +That's expensive.,E cost o! +Let me give you thirty naira now.,Meh I give you thirty naira now. +"My daughter, my daughter, it is the egg that's expensive... it is the egg that's expensive now?","My daughter, my daughter, na di egg na dear, na di egg cost now." +So the egg is expensive?,So di egg cost? +"Ahah, please.",Ahah abeg now! +Let me buy it for thirty naira.,"Mah, make I buy am thirty naira." +"I try, I try, I try.","I try, I try, I try." +"You try, you try.","You try, you try." +"Please, go a bit lower.","Abeg, try small now." +Reduce more?,I try again? +That's why I should...,Dat'S why na make... +I'm selling it for fifty naira.,I sell am fifty naira. +Eheh!,Eheh! +I have reduced the price.,I try. +It's a shame.,Na wao! +I can only take fifty naira off.,Na only fifty naira can come out o. +"Okay, let me buy it now.",Okay make I buy am now. +Make an effort!,Try now! +Buy it!,Buy am! +"This one, what is this?","Dis one, wetin be dis?" +"This is... this is Indomie, my daughter.","Na, na indomie my daughter o." +Indomie!,Indomie! +How do they cook it?,How de dey cook am now? +I don't know how they cook it.,I no know how de cook am o. +That's how they cook it.,Na so de cook am. +"When they open it, they'll put it in a pot, and put in onions.","When de open am, de go put am for pot, and put am onions." +You see what it is.,You see wetin dey. +Uhuh?,Ehen? +Ehn?,Ehn? +So everything's inside this thing?,"So everything dey, do, dey inside dis thing?" +"Uhuh, everything!",Ehen everything! +"Hey, this thing is fine!",Hey dis thing fine o! +"It's fine, my daughter.",E fine o my daughter. +Ehey!,Hey! +It's not food for children?,No be children food? +Is it food for children?,Na children food? +Hm!,Hm! +"Hey, let me buy it for my children!",Hey make I buy am for my children o! +Buy it!,Buy am o! +It's good for them?,E good for dem? +It's good!,E good o! +Everyone buys it from here.,Na everybody dey buy am for here o. +Hey!,Hey! +What will I put in it again?,Wetin again I go put am? +"Look at it, look at it.","See am now, see am." +It's plenty.,E plenty. +It's plenty?,E plenty? +It's plenty.,E plenty. +It's plenty.,Hey e plenty. +"Or should I buy one carton, so that I can keep it for a month.",Abi make I buy one carton self so dat de go keep am for one month. +Look at the carton inside the shop.,See di carton for inside di shop now. +Hey!,Hey! +You have a lot!,You get am plenty o. +X.,X. +I'm coming.,Make I go come. +I'll buy fifty.,"I go buy, buy am fifty now." +Uhuh!,Ehen! +Do you have a plastic bag to put it in?,You get nylon make you go put am? +Can you put it in a plastic bag?,You fit put am for nylon? +"Uhuh, I have a plastic bag.",Ehen I get nylon. +It's leather.,Na leda. +Uh... and what's this one?,Eh wetin be dis one too? +"This is, is, is s-... is, is... s-... is, is wool for a stove.","Dis one na, na, na s-... na, na s-... na, na thread for, na, na stove." +Oh oh!,O'Oh! +Uhuh.,Ehn. +"So, stoves use wool?",So stove dey use thread? +Eh.,Eh. +Uhuh!,Eheh! +"When they put it... when they put it on the stove this way, then they'll put in kerosine.","When dem put am, when dem put am for stove like dis, dem go con put am ehn kerosine." +Then you'll...,You go con... +Ehey ah!,Eheh ah! +Hm.,Hm. +"If I buy this one now, I'll go buy kerosine again?","If I buy dis one now, I go go buy kerosine again?" +Uhuh!,Ehen! +That's it.,Na im. +Ah!,Ah! +"If you don't buy kerosine, you won't...","If you na, if you no buy kerosine, you no go..." +I won't be able to cook?,I no go fit cook? +Uhuh!,Ehen! +Uh... what will they eat tonight?,Eh wetin de go eat dis night now? +I don't have money for kerosine.,I no get money for kerosine now. +You'll try.,You go try. +I have kerosine that I can give you half of.,I get kerosine wey I go give you half. +You'll give me... give me kerosine on credit.,"You go give me, give me kerosine for credit now!" +Tomorrow I'll pay you.,"Tomorrow, I go pay you now!" +I don't sell on credit.,I no dey sell credit. +You know everything.,You know everything. +You don't sell on credit?,You no dey sell credit? +"If you give people things, they'll buy it and take it away, they won't remember to bring my money again.","If you give people, people go buy am, dem go carry am go, dem no go remember bring my money again." +"I'll look for it, I'll look and look. I'll say ""my daughter bought kerosine and I can no longer see it!""","I go find, I go look, look, I go say ah my daughter buy kerosine, I no see am again." +Hm.,Hm! +And my money is gone.,And my money don go. +Heh!,Heh! +Your money has gone.,Your money don go? +My money has gone.,My money don go. +"But I'll keep my promise, I'll bring you your money.","But I, I go keep my promise now, I go bring money for you now." +What will you give me?,Wetin you go give me now? +I'll bring money in uh... two weeks.,I go bring money ehn two weeks. +Isn't that good?,E no good? +"Two weeks, that's far away.","Na two weeks, e far now." +"This one, I'll look, look, and look; I'll search for it, I won't see it.","Dis one, I go look am, look o, I go look am, I go find am, I no go see am." +It's not far.,E no far. +"It's gone, you've run away with my money.","E don go, you don carry my money run." +Let me write down my phone number for you.,Make I write my phone number for you. +"If you don't see me, you'll call me on my phone.","If you no see me, you go call me for phone." +Wait!,Wait! +How do they call the phone?,How dem dey call di phone? +I don't... I don't... I don't know a thing.,"I no, I no, I no sabi one, two, three now." +You don't know one two three?,"You no sabi one, two, three?" +"Okay, uhuh.",Okay ehen. +What do we do to it now?,Wetin we go do am now o? +I dunno.,I no know. +"Okay, let me go and borrow money.",Okay make I go borrow money. +Uhuh.,Ehen. +I will go borrow money to come pay you.,"I go go borrow money, con pay you." +Let me go borrow money to pay you.,"Make I go borrow money, con pay you." +"Go borrow money, go borrow money!","Go borrow money, go borrow money!" +I'll go borrow money.,I go borrow money. +"Borrow money, come.",Borrow money come. +"I'm here, I'll sell it to you.","I dey here, I go sell am for you." +You'll sell it to me?,You go sell am for me? +Okay!,Okay o! +Let me start checking.,Make I dey check. +What will I buy again?,Wetin again I go buy? +It seems like I saw bobo here.,E be like sey I see bobo here. +My daughter likes bobo.,My daughter dey like bobo. +There's plenty of everything.,Everything plenty. +"See this one, plenty for soup.","See dis one, plenty for soup." +You've got plenty of it?,You get am for plenty? +Plenty of everything.,Everything plenty. +This one for soup?,Dis one for soup? +Soup?,Soup? +"Okay, if you make it... if you... if you make it like, like this... like this, use it to cook soup, it will be fine.","Okay if you make am, if you, if you make am like, like dis, like dis, take am cook soup, e go fine, it's fine" +Okay let me just write my...,Okay make I just write my... +Hm.,Hm. +It's sweet.,E dey sweet. +It's sweet,E dey sweet. +I didn't know I'd see one.,I no know sey I go meet am. +"You'll eat and eat, your stomach will get big.","You go chop, you go chop, your belle go con big." +Ehey!,Ehe! +"Eh, thank God!",Eh thank God o! +Let me go look for money.,Make I go find money. +"I'll come back, mama.",I go come back mama oh. +"Go, go go.","Con go, go, go." +Thank you.,Thank you. +I'll come back.,I go come. +You come back quick!,"You, come back quick!" +"Me, I wanna go to a meeting.","Me, I wan go meeting." +"Okay, I will... I'll go.","Okay I go, I go go." +Hm.,Hm. +Thanks Ma.,Thanks Ma o. +Uh... you've become my customer today.,Eh you don become my customer today o. +"Bye, my daughter.","Bye, bye my daughter." +Oh.,Oh. +"Please, always come buy from Mama.","Abeg o, dey come dey buy from mama o." +I wanna buy everything for the house.,I wan dey buy everything for di house. +"I'll come, I'll buy.","I go dey come, I go dey buy." +Always come to buy from Mama.,Dey come dey buy from mama. +Thank you.,Thank you. +"Bye-bye, Mama.","Bye, bye mama o!" +Bye!,Bye! +Bye!,Bye! +Bye-bye!,"Bye, bye!" +"Uhuh, there are two ways he used to cook Egusi.","Ehen di method wey e take cook egusi, na two." +"Step one, method one, is this.","Step one, method one, na im be dis." +You will f-... you'll have ground your pe-...,You go f-... you go don grind your pe-... +"When your pepper is ground, keep it!","Your pepper wey don already grind, keep!" +You understand?,You understand? +"Now, the pepper is kept to the side.","Di pepper now, e dey one side." +"Your fish, everything, you will wash it and keep it like that.","Your fish, everyting, you go wash am keep like dat." +"And your Maggi [seasoning] (you'll have already crumbled the Maggi), keep it!","And your maggi (you go don already crumble di maggi), drop am!" +"Then you will (on your stove), put it on the burner... put your pot on the burner.","Den you go (on your gas) put am for fire, put your pot for fire." +"When you have set your pot on the burner, uh... pour in palm oil.","If you put your pot for fire, eh you add up red oil." +"When you've poured in palm oil, you will let it mstchew... let it heat up a little.","If you add red oil, you go allow am, mtschew go allow am hot small." +"When it's heated up a little, just pour in your onion.","If e don hot small like dat, you just put your onion." +"After you have poured in your onion, pour in your pepper.","After you put your onion, you pour your pepper." +"When you have poured in your pepper, stir it.","If you pour your pepper, you stir." +"After stirring, then you'll pour in water, add your Maggi, add your fish, put in everything.","After you stir, you go con pour water, put your maggi, put your fish, put everything." +Put in all your okporoko [stockfish].,Put your okporoko dem. +Put it in!,Put am! +"After you've put it in, cover it so that it can boil a little.","After you put am, you cover am make e boil small." +"When it's boiled, then put in your egusi.","If e boil, you go con put your egusi." +"The egusi you have already ground and put aside, you will add it.","Di egusi you don already grind keep, you go con put am." +"But if it has... if you want it be lumpy, you will do something like press it.","But if e get, if you wan make e do seed, seed, you go like press am." +Press the egusi so that oil will come out.,Press di egusi so dat oil go comot! +"If oil comes out, you will start putting it in the sauce as if you are making crumbs in the sauce, like that.","If oil comot now, you go start dey put am for di soup like sey you dey make crumbles inside di soup like dat." +"When you've put it in the sauce like that, you will cover it for a period of ten to fifteen minutes.","If you don put am inside di soup like dat, you cover am for like ten to fifteen minute." +"When it's done, you will put in your ugwu [fluted pumpkin], or waterleaf.","After e don, you go con put your ugwu, or waterleaf." +"Whatever leaf vegetable you have, just put it in.","Any leaf wey you just get, you just put am on top." +Leave it for a minute or so.,Leave am for like one minute or so. +"The egusi sauce, it is ready.","Di egusi soup, e don ready." +That's step one.,Dat's step one. +"That's step one, method one.","Dat one na step one, method one." +"Another method to you cook egusi sauce your egusi, it will...","Anoder method wey you dey carry cook egusi soup, your egusi, e go." +"The ground egusi, you will make it... turn it into paste.","Di grounded egusi, you go make am, turn am to paste." +You will add water.,You go put water. +Just a little water!,Small water o! +"Just a little water like that, you will add it that way.","Dat kind small water like dat, you go put am like dat." +"Like you will stir it, stir it, stir it.","Like you go stir am, stir am, stir am." +Keep it on the side!,Keep am for one side! +You will put oil in a pot.,You go put oil for pot. +"Instead of putting pepper in directly, like in the other method, this time around, it's the egusi you will pour directly into that oil which is already hot.","Instead of putting pepper direct like di oder method, dis time around now, na di egusi you pour direct for dat oil wey don hot." +"Now, as that oil has heated up, and since you have poured in your egusi, you will just be stirring it.","Now, as dat oil don hot, now wey you don pour your egusi, you go just dey stir am." +You will be stirring it till it starts to burn.,You go dey stir am till di ting burn. +You will see that the thing is well fried.,"You see sey di ting don fry well, well." +"In fact, it is starting to burn.",E don dey even burn sef. +"Then, you will pour in water.",You go con pour water. +You will pour in water and you will add your pepper.,"You pour water inside, you put your pepper." +"Now, you will pour in your ingredients, your pepper, your fish, your, your stock, your okporoko.","Now, you go con, you pour your ingredient, your pepper, your fish, your, your stock, your okporoko." +"If you like, you can put in bitter leaf.","If you like, you fit put bitter leaf." +"When you've added it and you've added your Maggi, you will cover it so it can boil.","After you put am, you don put your maggi, you cover am if e boil." +"When it's boiled, then put in your leafy vegetable.","Sey e don boil, den you put your leaf." +"When you have put in your leafy vegetable, and you notice that it's done, bring it down!","When you put your leaf, sey e don do, bring am down!" +Your egusi's ready.,"Your egusi, e don ready." +Then ogbonno.,Den ogbonno. +Ogbonno sauce.,Ogbonno soup. +"Ogbonno sauce is very easy to cook, you know.","Ogbonno soup dey very, very easy to cook you understand." +"In fact, ogbonno... like some people... some people will be frying their pepper before they do the ogbonno.","Ogbonno sef, like some people, some go dey fry deir pepper before de do di ogbonno." +"But the method which everyone uses, well, around here, in this area of ours... you'll put water on the burner.","But di method wey everybody dey use sha, for dis side, for dis our area, you put water for fire." +"When you've put water on the burner, you'll add your pepper, your Maggi, your stockfish, your crayfish, your ponmo, everything.","After you put your water for fire, you put your pepper, your maggi, your stockfish, your crayfish, your ponmo, everything." +"Uh... you know your assorted meat, you'll add it all.","Eh you know your orisirisi, you go don put am." +"When you've put it all in, you'll put in your Maggi, and cover it.","After you put am, you put your maggi, den cover am." +Leave it to boil.,Allow am make e boil. +"Then your egusi... your ground ogbonno... sorry, your ground ogbonno, you will mix it with oil.","Den your egusi, your grounded ogbonno, sorry your grounded ogbonno, you mix am wit oil." +You'll mix it until it's like a paste.,You go mix am to like paste. +"Get out your oil, then you will put it in that... the water.","Withdraw oil, den you put am inside dat, di water." +"It will boil, it will dissolve in the water.","E go boil, go scatter for inside di water." +"When it's boiled, you'll notice that...","When e boil, you see sey..." +"Because when it's boiled, it draws, everything will be normal.","Because when e boil now, e start dey draw, everyting go just normalise." +"Then, your ugwu, or your...","Den, your ugwu, or your..." +"Yes, your ugwu which has been washed already, you will add it.","Yes, your ugwu wey e dey washed already, you go con put am." +"Just after a minute, bring it down.","Just after one minute, you bring am down." +Your ogbonno is ready.,"Your ogbonno, e don ready." +That's all.,Dat is all. +"Me, my name is Joseph Aseginmba.","Me, my name na Joseph Aseginmba." +I come from a family of five.,I comot from family wey na five of us. +Two are girls.,"Two, na women." +Then the other three are boys.,Den di three na boys. +"But later on, well, one of the girls she... she... died.","But, later on, one of di female sha wan, wan, don die." +Though only one of the girls remains here.,Though na only one female con remain here. +"And I come from uh... Plateau State in Nigeria here, which is in the Middle Belt.",And I comot from eh Plateau State of Nigeria here weh dey Middle Belt. +Uh... that's where I come from.,Ehn na dere I comot from. +"And uh... in the long run, my father... my mother was the first to die, then my, my mother followed suit.","And eh at di long run, my papa con, my mama first die, my, my mama con follow." +You understand?,You understand? +So... and I am... then I... then I...,"So and I dey, I con, I con..." +"After my National Diploma, I got a job at the National Open University.","After my national diploma now, con get work for National Open University." +"That's where you get the chance to hustle, they, they do some sign things.","Na dere person dey get hustle dey, dey do some sign tings." +"They use it for school, in fact, they use it to help other families.","Dey use am dey do school, dey use am dey help oder family sef." +That's the hustling method.,Na di hustling method be dat. +Abuja is a very good place to stay.,Abuja na very good place to stay. +"But the, the cost of living of the people in Abuja now, it's, it's high.","But di, di level wey people dey live for Abuja now, na, na high level." +It's not a low standard.,No be low level. +But there are some ghetto areas.,But di ghetto area dey o. +It's not like there are no ghettos here.,No be sey di ghetto area no dey. +"But, yet, the ghetto area is just like the city in my... in the place where I come from.","But, still at dat, di ghetto area, e just dey like di city for my, for where me, I comot from." +You understand?,You understand? +"So... but staying in Abuja is, is the best... is the best thing to do.","So but staying in Abuja, na, na di best, na di best ting to do." +Everybody wants to be in the Federal Capital City.,Everybody wan make e dey Federal Capital. +You understand?,You understand? +But life in Abuja is very expensive.,But life for Abuja is very expensive. +"Housing, transportation, food are very expensive.","House, transportation, feeding, e dey very expensive." +And it's because of my father's death.,And na di dead of my papa o. +"The m-... my own... the... my mother's death is not painful to me because in her case, she, she, she was sick for a long time.","Di, m-... my own, di, my mama own sef, e no even pain me because dat one, she, she, she sick for long time." +She co-... then she died.,She co-... she con die. +"But in my father's case, he was not sick.","But my papa own, e no sick." +Nothing was wrong with him.,E no do anyting. +He just went out in the morning.,E just comot for morning. +He just came back.,Just come back. +He was not feeling well.,E no dey feel well. +We took him to the hospital.,Carry am go hospital. +"Before you knew it, he was dead.","Before you know, e don die." +So I was really surprised.,So e con dey very suprising for me. +"Mstchew then I realised that anything, even what I was doing... I will just remember that this life is vain.","Mtschew I con see sey anyting, even di ting I dey do, I go con remember di ting sey noting dey dis life." +"If you go out and come back without coming down with an illness and nothing is wrong with you, you should really thank God for that.","If you comot come back say you no sick, noting do you, you really thank God for that." +"Pidgin is not a language that one can master completely now, but the little ones I know, I will say it.","Pidgin no be language wey person go sabi finish now, but di little one wen I sabi, I go talk am." +Ehen.,Ehen. +"Myself, uh... I come from a ghetto.","Me, ah na from ghetto I comot from." +"So Pidgin, at least, that's what we grew up with.","So Pidgin at least, na wetin we don grow wit." +You understand?,You understand? +It's something we have been into since our childhood.,Na wetin we don dey do since from childhood. +"The, the Queen's English, we started learning it when we went to school.","Di, di correct English sef, na when we go school we start to dey learn di English." +So it's a normal thing to speak Pidgin throughout life.,So na normal ting to speak Pidgin for life. +"As for the current government, they are really doing their best for Nigeria.","Pertaining dis government, den de really dey try sha for Nigeria." +They are doing their best on the issue of corruption.,De really dey try base on corruption issue. +"Definitely, what they are doing is... it will really help the masses in Nigeria, but the people who will enjoy it... it's not time yet.","Definitely, wetin de dey do, e dey, e go really help di masses of Nigeria, but di people wey go enjoy am no be now." +It's later? the enjoyment will come later.,"Na later, later di enjoyment go come." +"Definitely, the government is doing their best.","Definitely, di government, de dey try." +"They should keep it up, up, just as it is.","Make dem keep am up, up as e dey like dat." +"And all these divisions in uh... Nigeria, the issue of Biafra, mtschew, I don't like it because if you check it [you'll realise] that in the Ea-... in the East, people are not... [there's] no, no infrastructure.","And all dis division of eh Nigeria, Biafra of a ting, mtschew I no dey kuku like am because if you check am sey for Ea-... for East, people no, de no, no any infrastructure." +"If they say they want to divide Nigeria now, where will they start?","If de say now de wan divide Nigeria now, how de wan start am?" +They don't have a place to stay.,De no get where de go stay. +"Everywhere, per se, is the secretariat.","Everywhere, per se, na secretariat." +There is no...,E no get... +"And in that place, they place high value on landed properties as if it's gold.",And de dey value land like sey na gold for dat place. +"Ehen... if you take a look at the North now, most of them (for instance in this Abuja) most of them are selling water and pushing carts.","Ehen if you con check di North now, most of dem (like for dis Abuja), most of dem na mai ruwa, mai barrow." +"Okay, if they split now and they go back to the North, now, who will buy their water and barrow, huh?","Okay if de con divide now, de con go back North, now, who go buy deir ruwa, and barrow eh?" +Will they push their barrow there?,Push deir barrow for dat side? +So let's just stay united... let's just stay together.,"So moh just dey unite, moh just unite togeder." +We will move Nigeria forward.,We go move Nigeria go forward. +Mstchew I don't watch...,Mtschew I no dey watch. +"At most, what will make me... I unwind by browsing.","Highest, wetin go make me, wetin dey make me relax na to browse." +"We browse the net, chat, I mean we get to know different things on the internet, things I didn't know until now.","We don browse, chat, as in get to know different tings, tings wey I no know before for internet." +I will go and research.,I go go research. +"Ehn, the problem is just that...",Ehn na just wetin di wahala wey... +"If I get tired, I'll go and relax with friends and come back to the house by ten o' clock.","If I don tire, I go go gist wit friends, and come back house by ten." +Good afternoon.,Good afternoon. +My name is Joke Babatunde.,My name na Joke Babatunde. +I'm from Ondo State.,I come from Ondo State. +I live in Ibadan.,I dey stay for Ibadan. +I want...,I want... +I've lived in so many places in Nigeria.,I don stay for so many places for Nigeria. +I've spent a long time living in the North.,"I don stay North well, well." +I've lived in so many places.,I stay for so many places. +I wanna teach you a recipe I learned from my friend.,I want teach you one kind of soup wey I learn from my friend. +It's eaten mostly by the Igbo people.,Na Igbo people dey chop am pass. +The name of the dish is ofe nsala.,Di name of di soup na ofe nsala. +"In the Igbo land, that means bitter leaf.","For Igbo land, dat mean sey na bitter leaf soup be dat." +"The ingredients they use for cooking it are bitter leaf, palm oil... palm oil, pepper, salt... pepper, salt, meat, dried fish, stock fish, tripe (the thing that's peeled from a cow, which was inside a cow and was peeled off), ponmo [cow skin], ogiri [a flavoring made of fermented oil seeds] and Maggi [cubes].","Di ingredients wey de dey take cook am na bitter leaf, palm oil, palm oil, pepper, salt, pepper, salt, meat, dry fish, stock fish, shaki (dat one wey dey peel for cow, wey dey inside cow body de peel am), ponmo, ogiri, and Maggi." +"The dish, you'll first of all wash the bitter leaf... the bitter leaf very well.","Di soup, you go first wash bitter leaf, di bitter leaf well, well." +"You'll wash it till the bitter taste goes away, so it won't be bitter in the dish.",You go wash am sotay di bitter go comot so dat e no go bitter for di soup. +"Then again, we need something else.",Den we need anoda ting again. +We need uh... ede.,We need ehn ede. +They call it ede in Igbo.,De dey call am ede for Igbo. +And it's uh... cocoyam.,And na ehn cocoyam. +So first I'll cook the cocoyam.,So I go cook di cocoyam first. +"Once I've cooked the cocoyam, then I'll...","If I cook di cocoyam, I go con..." +"When the cocoyam is ready, I'll wash my mortar.","When di cocoyam don done, I go wash my mortar." +"Then, I'll pound the cocoyam.",I go con pound di cocoyam. +"If I pound the cocoyam... they add cocoyam to bitter leaf because they want it to be thick, so it won't be watery.","If I pound di cocoyam, de dey put cocoyam for bitter leaf soup because de want make e thick so dat e no go be water, water." +"So if I wash my bitter leaf... when I've finished washing my bitter leaf, I'll put, put water on fire, grind my pepper, and put it in.","So if I, I wash my bitter leaf fini-... I don wash my bitter leaf finish, I go con put, put water for fire, grind my pepper, pour am inside." +"Then I'll put in my tripe, my meat, and my dried fish.","Den pour my shaki, pour my meat, pour my dry fish." +I'll add my stock fish.,I go put my stock fish. +"Once I've put everything into the pot, it will be boiling, I'll leave it so the pepper will really get into the meat.","If I don put everything inside, e go dey boil, I go leave so dat di pepper go enter am well, well." +Then I'll leave it to boil really well.,"I go con leave am make e boil well, well." +"When it's boiled very well, I add my Maggi, add my ogiri, add everything, add the salt so it will taste good.","When e boil well, well, I put my Maggi, put my ogiri, put everything, put my salt make e taste well, well." +"So if I notice that all the ingredients are done, the pepper has gotten into the meat, and the tripe, and the cow skin, everything... then, I put in the bitter leaf.","So if I see sey everything don boil, di pepper don enter di meat, and di shaki, and di ponmo, everything, I go con pour my bitter leaf." +"So when I've put in the bitter leaf, then I'll add my palm oil into it.","So if I pour my bitter leaf, I go con put my palm oil inside." +"So when I've added my palm oil, everything will boil.","So as I pour my palm oil, everything go con boil." +Then I will leave it.,I go con leave am. +"When I realise it's done, it has started entering... then I will put in my uh... then I will put in my, my ede.","As I con see sey e don boil well, well, e don dey enter, I go con put my, ehn I go con put my, my ede." +"That's my cocoyam, which I pounded.",Dat'S my cocoyam wey I pound. +I will put it on the side.,I go con put am inside. +"So once it is done, within five minutes, when I notice that it is well done, I will take it off the fire.","So once e just cook, within five minutes wey I see sey e don boil well, well, I go con carry am down." +"And you can eat this kind of sauce I'm talking about with pounded yam, you can eat it with fufu, you can eat it with uh... even your semovita.","And dis kind of soup wey I dey talk about, you fit eat am with pounded yam, you fit eat am with fufu, you fit eat am with eh even your semo sef." +But the dish... the dish is very tasty.,"But di soup, di soup dey sweet well, well." +"So this is the type of dish I know, and I want to teach you.","So na dis type of soup I, I sabi wey I wan teach you." +I want to talk about another dish which I know of.,I want talk about anoder soup wey I sabi. +"That dish, it's the Warri people... and uh... Warri people, and uh... Warri people, and uh... ban-... uh... the Bayelsa people who eat it very well.","Dat soup, na Warri people and, ehn Warri people and, ehn Warri people, and ehn ban-... ehn Bayelsa people dey chop am well, well." +All these people who are in the Niger Delta are the ones who eat this dish.,"All dis people wey dey Niger Delta, na dem dey chop di soup." +The name of the dish is banga,Di soup name na banga. +And the ingredient they cook banga with is this palm kernel... palm fruit... palm fruit which comes from pa-... uh... palm tree.,"And di ingredients wey dem dey take cook banga soup na dis palm kernel, palm fruit, palm fruit wey come from pa-... ehn, palm tree." +"So we will take fully ripe palm tree fruits, we will take them... take them and peel them.","So we go carry di palm tree wey don ripe well, well, we go comot am, comot, peel am from di back." +"Then I will boil my, my palm fruits.","I go con boil my, my palm fruit." +Then the ingred-... another ingredient which I need is Banga ingredient.,Den di ingred-... anoda ingredient wey I need na banga ingredient. +You will just go to the market.,You go just go market. +You will ask for Banga ingredients.,You go say you want banga ingredients. +"Banga ingredients, you will get all those ingredients, they'll have pounded it for you, you'll have mixed it together.","Banga ingredients, you get all those ingredients, dem go don pound am for you, you go don mix am together." +Then I need pepper.,Den I need pepper. +Then I don't need palm oil again.,Den I no need palm oil again. +"I need salt, and I need Maggi.","I need salt, and I need Maggi." +"Because once all those things are already in the dish, everything has...","Because once all those things don dey di soup, everything don..." +You don't need to add palm oil because the palm fruits will let out palm oil.,No need of palm oil because di palm fruit go bring palm oil out. +So if I cook the palm oil... then I will cook the palm fruits.,"So if I cook di palm oil, I go con cook di palm fruit." +"So once the palm fruits are well cooked, I'll boil it.","So once di palm fruit cook well, well, I go boil am." +I'll boil it.,I go boil am. +"When I finish boiling it, I will pound it.","When I boil am finish, I go con pound am." +"So once it is pounded, I will pour it into a mortar uh... this thing, wash it.","So once e don pound, I go con pour am for mortar, ehn dis thing, wash am," +"Then I'll wash it very well with my hand, take out all the palm oil in it.","Con use my hand wash am well, well comot all di palm oil inside." +"So when I've taken out all the palm oil in it, then I'll set the palm oil on fire.","So if I comot all di palm oil inside, I go con put di palm oil for fire." +"As I set the palm oil on fire, I will add the pepper I planned to add... fresh pepper.","As I put di palm oil for fire, I go con put di pepper wey I wan put fresh pepper." +I'll pound it.,I go don pound am. +"Or I can put it into it, I'll put in the Banga ingredients so that it will... everything will boil together.","Or I fit put dry pepper, anyone wey I like as I want, want am." +"So when I've poured it in, I'll add the Banga ingredients so it will... everything will boil together.","So if I pour am inside, I go con put di banga ingredients so dat e go, everything go con boil together." +"So as all the ingredients boil, I'll...","So as everything boil together, I go con..." +"Later, once it's boiled very well, when I realise that it is becoming thick and the oil has started coming up, that means that it's done, and I will add my meat.","Later once e don boil well, well, when I see sey e don dey thick, di oil don dey show on top, dat mean sey e don done, and I go con put my meat." +"I'll add my meat, add my fish, add my stock fish, add my crayfish, add all ingredients into it.","I go don put my meat, put my fish, put my stock fish, put my crayfish, put everything inside." +"So once I've added all these things, and everything in the dish has boiled, that means the dish is ready.","So once I don put all these things inside, and everything don boil inside di soup, di soup don do be dat." +"So once the dish is ready, we eat it with starch.","So once di soup don do, we dey use am eat starch." +"We'll prepare our starch, we'll eat the Banga with starch.","We go do our starch, we go use banga eat starch." +We can eat our Banga with uh...,We fit use our banga chop ehn... +"We can eat it with Akpu, we can eat it with rice.","We fit use am chop akpu, we fit use am chop rice." +"If we don't have tomatoes, at times, we eat Banga with Rice.","If tomato no dey, at times, we dey use banga chop rice." +So that's the other kind of dish I know.,So na di kind of soup again wey I know be dat. +"Okay, my name is Okemute Imonirhua.","Okay, my name na Okemute Imonirhua." +"I'm from Delta State, I'm Urhobo.","I am from Delta State, I be Urhobo." +I was born in Warri.,De born me for Warri. +And I grew up in Warri.,And I grow up for Warri. +I stayed in Warri up until twenty fourteen.,I stay for Warri till twenty fourteen. +I had my primary school and secondary school education in a place close to Warri.,"Primary school, secondary school, na close to Warri I attend." +"And then, my university education too, was in Delta State.","And den, university too, na for Delta State." +"So I lived all my life in Delta State, until my job brought me to Port Harcourt in twenty fourteen.","So all my life, I live for Delta State until work carry me come Port Harcourt from twenty fourteen." +"I'm a graduate of library and information science, it's not because that's what I wanted to study in school, but my mom said I should study medicine.","I be graduate of library and information science, not because sey na wetin I like to study for school, but my mama say I must study medicine." +She wanted a doctor.,She wan get doctor. +"Thank God that my younger brother is in his final year in medical school now, so she will have her doctor.",Tank God my younger broder now don dey for final year for medical school so she go get her doctor. +But I don’t like sciences.,"But, I no like sciences." +"So, I sat for my WAEC.",So I write my WAEC. +I didn’t pass all the subjects.,I no pass all di subjects. +"Then she said, okay, I should go for the pre-degree first.",She con say okay make I just do pre-degree first. +"Then I would sit for it again, until I got to study medicine.",Den I go rewrite again till I must study di medicine. +"But as I got accepted to study library science, I told myseft that nothing would make me go back to sciences.","But as I enter pre-degree do library science, I tell mysef sey noting go make me go back to sciences." +So that's what made me study library science at school.,So na wetin make me study library science for school. +"And I, I didn't do bad at school.","And I, I don't do bad, for school." +"I came out with good grades (you know), which they call two one.",I come out wit better grade (you know) wey de call two one. +And then...,And den... +But what I really wanted to do before now is broadcasting.,But wetin I really like to do before na broadcasting. +"So when I finished my education, then I got a job in a radio station as a first experience.","So when I finish school, I con get work for radio station by first experience." +With no training.,No training. +I did that.,I do dat one. +Then I went into the Youth Service Corps in Bayelsa State.,I con go for service for Bayelsa State. +"During service, I went to a radio station for training.","During service, I con go radio station to go learn." +I was supposed to teach but I went to the school and said that they should reject me.,I suppose to teach but I go meet di school say make de reject me. +I don’t have an interest in teaching.,I no get wetin I wan use teaching take do. +So I went to a radio station.,So I con go radio station. +"There, they trained me in phonetics, and everything, news reading.","De train me for dere for phonetics, and everyting, news reading." +"Then after NYSC, I got a job again in Warri.","Den after NYSC, I con get work again for Warri." +"So I worked in Warri, in a radio station, as a presenter for about uh... two years.",So I work for Warri for radio station as a presenter for about eh two years. +Then I left Warri to come...,I con leave Warri come... +"Actually, I wanted to come to Port... come to Port Harcourt at that time, but it didn’t work out that way.","Actually, I wan come Port, come Port Harcourt dat time, but e no work out like dat." +Then I came to Port Harcourt in twenty fourteen.,I con come Port Harcourt for twenty fourteen. +I got a job as uh... they call it a call screener on the radio.,I get job as (ehm de call am call screener for radio). +Not a presenter.,No be presenter. +You're the one who sits where they receive phone calls.,Na you go sit down for where de dey receive phone call. +"So before the call gets to the studio, first you'll first listen to the people, screen them.","So before di call go enter studio, you first listen to di people, screen dem." +"If what they want to say doesn't make sense, you cut them off.","If wetin de wan talk no make sense, you go cut dem." +"But if what they said will contribute to the program, you allow them to conne-...","But if wetin de talk get contribution to di programme, you go allow dem conne-..." +Uh... you connect them to the studio.,Eh you go connect dem to di studio. +I didn’t do that for long.,I no do dat one for long. +Then I got an administrative job.,I con get admin work. +"So now, it's administrative and HR work I do.","So now, na admin, and HR work I dey do." +"But because I still love uh... broadcasting, I get to read news, along the line.","But because I still like eh broadcasting, along di line, I dey read news." +"But the thing is making it very stressful for me because the administrative work is there, and the time for news is a very sacred time.","But di ting dey make e dey too stressful for me because admin work dey dere, and news time na very sacred time." +"So sometimes I miss the news, I go to read it late.","So sometimes I go miss di news, I go go read am late." +So I had to drop news reading.,I con get to drop news. +But I'm still hopeful for the time when I'll be able to go back to broadcasting.,But I still dey hope for when I fit go back to broadcasting. +"Before we started a TV station in our company, I was working for Cool FM, Wazobia FM, Nigeria Info.","Before we con start TV station for our company, I dey work for Cool FM, Wazobia FM, Nigeria Info." +"They opened Wazobia Mass TV, and it’s a Pidgin Station.","De con still open Wazobia Mass TV, and na Pidgin station." +So I went for auditioning.,So I audition. +"Even my boss told me, ""ah, just try it, just try it.""","My oga now even tell me sey ah just try am, just try am." +"""After all, you grew up in Warri.""","After all, na Warri you grow up." +"""So it's Pidgin.""",So na Pidgin. +"You know that Pidgin... to speak Pidgin, and to broadcast, mtchew, is not the same thing.","Una know sey Pidgin, to talk for Pidgin, and to broadcast, mtschew no be di same ting." +But I went for the audition.,But I con audition. +I got the job.,I get di job. +So we are yet to go live.,So we never start to go live. +"When we go live now, I will be anchoring the morning show.","When we go live now, I go dey do di morning show." +And then uh... the food show.,And den ehn food show. +We have already started recording the food show (because I like food a lot) on the Wazobia Mass TV.,"We don dey record di food show already (because I like food well, well) for Wazobia Mass TV." +"Uh... one issue I would like to talk about very briefly, is this issue of feminism.","Ehn one issue I like to talk about very briefly, na dis issue of feminism." +"Me, I'm a feminist.","Me, I be feminist." +I believe in equality of the sexes.,I believe in equality of di sexes. +"Even my mother, when we were growing up, anything which my brothers were doing, we would do it too.","Even my mama, when we dey grow up, anyting wey my broders dey do, na we dey do too." +"She didn't... she let you know that if your brother can do it, you should be able to do it too.","She no dey, she will let you know sey if your broder fit do am, you go fit do am too." +"So even if she may not know what feminism is, but she, she was a feminist.","So even if she fit no know wetin feminism be, but she, she be feminist." +Because she suffered at the hands of her father.,Because she suffer for her papa hand. +Her father believed that girls are not valuable.,Her pa believe sey girl no be pikin. +"So the father didn't get her educated, he made her suffer a lot.","So papa no gree train her, suffer her well, well." +"So because of that, she treated all her children equally.","So because of dat one, she treat all her children equally." +"But with feminism now, me, I feel that some people are taking it to another level.","But feminism now me, I feel sey some people dey take am to anoder level." +So this feminism is not feminist.,So dis feminism no be feminist. +They hate themselves as women.,De hate demsefs as women. +"Because I have read that... I read recently that some women, maybe, are saying, ""ah, why should the Boy Scouts be making women join the Boy Scouts?""","Because I don read sey, I read recently sey some women maybe dey talk sey ah why Boy Scouts go dey make women fit dey join Boy Scouts." +"And then some women are calling themselves kings, king of queens.","And den some women dey call demsefs kings, king of queens." +Nothing is wrong with being a queen.,Noting dey wrong wit being a queen. +Because a man is a man.,"Because, male human being na man." +A woman is a woman.,Female human being na woman. +"So sometimes when you say the queen is a king, it means that you are not satisfied with being a queen, and nothing is wrong with being the queen.","So when you say sometimes di queen is a king, e mean sey you no dey satisfy wit being a queen, and noting dey wrong wit being di queen." +The Queen of England is a queen.,"Queen of England, na queen." +"And she has a husband, but nothing has taken her position away from her.","And she get husband, but noting take her position from her." +Some of these feminists...,Some of dis feminist... +"I am a feminist, but some people are not feminists.","I be feminist, but some people, de no be feminist." +"They are misleading other women, they hate being women, they want to be men by all means.","De dey mislead oder women, de hate to be women, de wan be men by all means." +"I should say that many of these feminists (other than...), they are not feminists, they are anti-feminists but in the name of feminism, they are taking the struggle to a whole nother level.","I should say, many of dis feminism, oder dan de no be feminist, de be anti feminist, but in di name of feminism de dey take di struggle to anoder different level." +"What I know is that if I will... when I have the opportunity to air my show, I will talk about it very well.","Na wetin I know sey if I go, when I get di chance to do my show, I go talk about am well, well." +That hating men will not make you say that we are superior to men.,"Sey to dey hate men, no be im go make you say we dey superior to men." +"In fact, to say that you are superior to someone, you already know that you are inferior to that person.","Infact, if you wan say you dey superior to person, you know sey for your mind, you feel inferior to dat person." +There is nothing wrong with being a woman.,Noting dey wrong wit being a woman. +"And you can get all the respect you think you deserve, achieve anything you want to achieve while you still retain your respect as a woman, still living in...","And you fit get all di respect wey you feel sey you deserve, achieve anyting wey you wan achieve while still maintain your respect yoursef, as a woman, still dey live in..." +I don’t know if I've been speaking for five minutes.,I no know wey I don talk reach five minute now. +Or should I keep speaking?,Abi make I still dey talk dey go? +Should I continue?,Make I still continue? +So yes sir.,So yes Sir. +One of the issues which I am passionate about is feminism.,"One of di issues wey I dey passionate about, feminism." +"Again, another thing which I am passionate about is my belief in God.",Anoder ting again wen I dey very passionate about na my belief in God. +"You know, yes, uh... I won't be able to say anything about myself without mentioning God and Christianity, you know.","You know yes, ehn I no go fit talk anyting about mysef without mentioning God, and Christianity you know." +"Ah, I'm not trying to preach right now.",Ah no be sey I wan preach now o! +"But basically, Christianity, for me, is not a religion.","But basically, Christianity for me no be religion." +It's just a new life.,Na just a new life. +"Entering into a new life, and seeing things differently.","Entering into a new life, and seeing tings differently." +Because there was... I grew up... I was born in a Christian family.,"Because e get, I grow up, de born me for Christian house." +"But at a point in my life, I just told myself, ""please, uh... God alone is not the way.""","But at a point in my life, I con just tell mysef sey abeg eh no be only God wey fit be di way." +I tried to explore Eckankar.,I try to explore Eckankar. +"Nothing is wrong with it, but then, I had an encounter with God one day.","Noting dey wrong wit am o, but, I con get eh di encounter one day wit God." +What made me...,Wetin come make me... +"That day, I woke up and I was crying.","Dat day I wake up, I con dey cry." +I won't be able to talk about it now because it would be too long.,I no fit talk about am now because e go dey too long. +"But, but that personal encounter made me say, ""ah, I believe in God"", not because I was born into a Christian home, but because of that personal encounter with God.","But, but dat personal encounter na make me say ah I believe in God not because de born me for Christian home, because of dat my personal encounter wit God." +"And in my work, I have been seeing many different things.","And in my work, I don dey see many different tings." +"Before, I used to be very harsh but when, you know, reading about loving your neighbour as yourself, all those things changed me.","Before, I be who dey harsh well, well, but when you know read about loving your neighbour as yoursef all dose tings dey change me." +And nothing is impossible with God.,And noting dey impossible wit God. +That's what Jesus Christ spoke about.,Na wetin Jesus Christ talk about. +"And I've seen it, that nothing is impossible.",And I don see am say noting dey impossible. +"Because even my life journey, from where I started from to where I am right now, everything is a journey of faith.","Because even my life journey from where I start to where I dey right now, everyting na journey of faith." +"Even the TV show which I want to start so... which I know that I will do very well, is also a journey of faith.","Even di TV wen I wan start so, which I know sey I go do very well too, na too journey of faith." +"So, my Christian life makes me believe that nothing is impossible for me to achieve.","So, my Christian life make me believe sey noting dey impossible for me to achieve." +"I can live like... get everything which I've wanted in life, and enjoy life beautifully in health, in peace, and of course when I die, I still have hope in where I am going.","I fit live like get everyting wen I want for dis life, and enjoy di life beautifully in health, in peace, and den of course when I die, I still get hope of where I dey go." +And uh... hehe... thank you!,And eh hehe thank you! +Uh... good afternoon.,"Eh una, good afternoon." +My name is Lekan.,My name na Lekan. +"And myself, I work with Lasaco Assurance PLC.","And me, I dey work with Lasaco Assurance PLC." +"And basically, what we do isn't just collecting money from people.","And basically, wetin we dey do no be sey we just dey collect money from people." +And I know that you have heard about insurance before.,And I know sey una don hear about insurance before. +"And you will be asking the question, ""what exactly do they do in insurance companies?""",And una go dey ask sey wetin dem dey do for insurance company? +We're very simple.,We dey very simple. +"You know that in life, there is danger everywhere.","You know sey as person dey live, danger dey everywhere." +"You sleep, you wake up, you take your bath.","Sey you sleep, wake up, you bath." +You go out.,Sey you go out. +It's a risk in itself.,Na risk on its own. +"And in our company, what we do is that all those risks that people face (you look for what to eat on a daily basis), those are the risks we accommodate.","And wetin we dey do for our own company be sey all dose risk wey man dey face (you dey find wetin you go chop on a daily basis), na dose risks we dey accommodate." +"That is... we protect you so that if anything happens, we will give you money.","Na im we dey protect una sey if anyting happen, we go give una money." +See!,See! +"With insurance, you see, you can...",For insurance eh you fit... +"We can protect anything you place value on, anything you love, anything you treasure.","Anything wey you place value, anyting wey be sey you love, anyting wey you treasure, we fit protect am." +That's what insurance does for people.,Na wetin insurance dey do for people be dat. +"We can insure your car, we can insure your life and we can insure your house.","We fit insure your car, we fit insure your life, we fit insure your house." +"Even your children who you love, we can make insurance policies for them.","Even your children wey you love sef, we fit do insurance policy for dem." +And all these things have their own benefits.,And all dese tings get im own benefit. +"Not that someone will just be collecting your money, and you will be afraid.","No be sey person go just dey collect your money, and you go dey fear." +Nobody knows what will happen tomorrow.,Nobody know wetin go happen tomorrow. +Someone can sleep and not wake up tomorrow.,Person fit sleep make e no wake up tomorrow. +And you already have plans to send your lovely child to school.,And you don plan for your mind sey you want send dat your lovely child go school. +Insurance can guarantee that the child will go to school whether you're around or not.,"Insurance fit guarantee sey dat child go go school even weda you dey around, you no dey around." +"So, Insurance is beautiful.",So insurance dey beautiful. +"But as time goes on, we know that we will get to a level in this country of ours and everyone will appreciate what insurance does for people.","But as time dey go, we know sey we go reach one level for dis our country, and everybody go appreciate wetin insurance dey do for people." +"To enjoy life, to sleep with both eyes closed.","To enjoy life, to sleep with your two eyes closed." +"In fact, don't be going k-...",In fact no dey go k-... +"Older people say that if you want to go to sleep, leave one eye opened, but we can guarantee you that with insurance uh... you can sleep with both eyes closed.","Elders talk sey if you want sleep, make you open one eye, but we fit guarantee you sey with insurance eh, you fit sleep with all your eyes closed." +No problem.,No shaking. +We've got your back covered.,We get your back. +So that's what insurance does for people.,So na wetin insurance dey do for people be dat. +Thank you!,Tank you! +"Sometimes, you will be wondering about insurance packages for rich people... can someone who is not wealthy buy an insurance packages?","Sometimes una go dey wonder sey shey insurance dey for person wey get money, person wey no too get money, shey im fit buy insurance?" +"See, the truth is that there's an insurance package for everyone.",See di truth be sey insurance dey for everybody. +"But because we are afraid because of the impression that only someone who doesn't need... who has lots of money, can buy insurance packages, but with five thousand naira, you can also buy life insurance policies.","But because we dey fear sey na person wey don chop wella, wey im pocket full fit buy insurance, with five thousand naira, you fit buy insurance policy for your life." +You can protect your house with less than five thousand.,You fit protect your house with less dan five thousand. +Insurance was not created for rich people.,Insurance no be sey dem create am for person wey get money. +"In fact, it's more beneficial to people who really don't have much money.","In fact, na people wey no too get money di ting dey benefit pass." +"If you built a house and your house is worth maybe ten million naira, the amount you will pay us to protect your house in case of a fire isn't even three thousand naira.","If you build house, and your house na maybe ten million naira, di money wey you go pay us to protect your house if fire burn am no reach three thousand naira." +So compare... you should compare the amount you will pay to the danger that will come up if that house gets burnt!,"So compare, make una compare di money wey you go pay with di danger wey go happen if dat house burn!" +"So whether you are rich or poor, for any product you want to buy, you will be the one to tell us the protection you need, and we will offer you some advice.","So wheda you get money, abi you no get money, any product wey you want buy, na you go tell us di protection wey you need, and we go give you advice." +"We will tell you the amount you will pay, what you can protect, how you will go about it.","We go tell you how much you go pay, wetin you fit protect, how you go go about am." +"See, insurance is beautiful, even in schools, anywhere you are, in the church too.","See, insurance dey beautiful, even for school, anywhere wey you dey, for church." +I know that pastors will ask you to put your faith in God.,I know sey pastor go tell you sey make you carry your faith put am for God. +That God's got your back covered.,Sey God get your back. +It's true!,Na true! +It's not a lie!,No be lie! +"But God... since God has already gotten your back covered, He has also given you brains, which you are supposed to use to protect yourself.","But God, as God don get your back, im don give you brain say make you take protect yourself too." +That's what insurance does.,Na wetin insurance dey do be dat. +Make...,Make... +I am not telling you that God does not protect people.,No be sey I dey tell you sey God no dey protect people. +No!,No! +God protects people.,God dey protect people. +"He's got our backs covered, for sure, but you also ought to do a thing or two.","E get our back accepted, but yousef suppose do one, or two tings." +You should add a thing or two.,Make you add one to two. +"So that everything will stand strong and if anything happens, you are sure that the fund you need to keep you on your feet is available somewhere.","Make everyting dey, take tanda sey if anyting happen, you sure sey money dey somewhere wey go keep you on your feet." +"It's not a good thing to be at work, searching for what to eat, and then something happens, and you cannot make money again.","E no good when you go dey work, you dey find wetin you go chop, and someting happen, you no fit make money again." +If you are unable to make money again with insurance... will the money you were making while you were still working keep coming in?,"If you no fit make money again with insurance, dat money wey you dey make while you still dey work go dey enter?" +"Insurance will ensure that any money you were making before... in fact, now that something has come up, whether it's in the form of an accident or a sickness, or death...","Insurance go ensure sey any money wey you dey make before, even now when something don happen (wheda na accident o, wheda na sickness o, abi death)..." +I know you will speak.,I know sey you go talk. +We all pray to live a long life.,All of us dey pray sey make we live long for life. +That's it!,Na so! +"But if it happens, insurance has guaranteed that if death eventually occurs... that if it happens, there's an amount of money which they will give your family members like ""the loss you suffered, your husband or your wife has planned for that, he had such things on their mind for you.""","But if e happen, insurance don guarantee sey if death eventually occur, sey if di ting happen, money dey wey dem go give your family say di loss wey una suffer, una husband, abi una wife don plan sey, na so, so, so thing e get in mind for una." +"Insurance can help you get what you have in mind, whether you are around or not.","Dat ting wey you get in mind, insurance fit even make you achieve am wheda you dey around, abi you no dey around." +"You can come, and you can insure anything.","Una fit come, and you fit insure anyting." +"You know in... so far you love that thing, you, you know that that thing uh... is very important.","You know in so far you love dat ting, you, you know sey dat ting eh dey very important." +Insurance is the answer you ought to get.,Insurance na di answer wey you suppose get. +"Insurance is the way out, which will protect everything you value in this life.",Insurance na di way out wey go protect everyting wey you place value on for dis life. +"It can be your life, it can be your wife, it can be your children.","E fit be your life, e fit be your wife, e fit be your children." +"It can be their education, since you want them to go to school, they should study, they should become lawyers, they should become doctors, they should become anything in life.","E fit be deir education sey you want make dem go school, make dem study, make dem become lawyer, make dem become doctor, make dem become anyting for dis life." +Insurance will help you achieve that.,Insurance go help you achieve dat one. +"In fact, if you were employed before but later became unemployed, insurance can still protect the salary you were earning, the one you were being paid by your employer.","In fact, you dey work before, work no dey again, insurance still fit protect di salary wey you dey earn before, wey you dey collect from your employer." +So it doesn't matter if...,So e no mata wheda... +"Oh, I've lost my job, I can't keep paying.","Oh I no get work again, I no fit dey pay." +"In fact, when you're retired, when you've told your employer that I've been working for you long enough, and now, I want to rest and enjoy my money, insurance can protect that money as well.","In fact, after you don retire, when you don tell your employer sey di one wey I don do with una don do, sey now I want rest and enjoy my money, insurance still fit protect dat money as well." +"Which means that if you spent all the money they gave you, we will continue paying you as far as you've asked us to protect the money which you collected.","Wey be sey even if you finish di money wey dem give you, we go dey pay you dey go so far you don come tell us sey you want protect dat money wey you collect." +We call that annuity.,"Dat one, we dey call am annuity." +"So you will realise that if you take a good look at insurance, it is full of advantages.","So you go see sey if you look insurance very well, e get advantage." +Not that someone will collect your money.,No be sey person go collect your money. +"In fact, it is so beautiful that once you enter into business with us, you will enjoy it.","In fact e dey beautiful sotay once you enta business with us, you go enjoy am." +We were established for your sake.,Na because of una de establish us. +We have come to serve you.,Na una we come serve. +And the amount you will pay is not so much.,"And di money wey una go pay, no be sey di ting much." +"So if you have informed us of what you want to protect, we'll advise you that okay, since you have told us what you want to protect, we will tell you that you will pay a little bit of money.","So if you don tell us wetin you want protect, our own na to just give you advice sey okay o, as you don tell us sey na dis one you want protect, we go tell you na shikini money you go pay." +"If you combine... if you compare the amount you will pay and what you want to protect, you will realize that it is indeed a small amount of money.","If you combine, if you compare how much you go pay, and wetin you want protect, you go see sey na shikini money." +You s-... hustled... struggled to buy a million naira car.,"You s-... hustle, you struggle buy car one million naira." +You pay fifty thousand naira to protect that car.,You pay fifty thousand naira to protect dat car. +"If it gets stolen, you will get another one; if it gets burnt, you will get another one.","If dem steal am, you go get anoda one, if fire burn am, you go get anoda one." +"If you hit someone, and someone... or someone hits your car, we will repair it for you.","If you jam person, and person, or person jam you, we go repair am for you ni." +So you should look into it too.,So you too look am! +"Fifty thousand to one million, you will think that it's a small amount of money.","Fifty thousand to one million, you go tink sey na shikini money." +"Even for your life, your properties, anything... the money we will give you as compensation based on the fact that you have a contract with us, that we want to protect you, if you compare it to the money which you, you will pay us, it's just a small amount of money.","Even for your life o, for your property o, anyting, di money wey we go give you sey we take compensate you, sey you get contract with us, sey we want protect you, if you compare am to di money wey you, you go pay us, na just shikini money." +You will not even feel the impact on your pockets.,You no go even feel am for your pocket. +It's not even up to the amount you will sp-... spend to have fun between January and December.,E no even reach money wey you go sp-... spend jolloficate from January to December. +"So with this money you spend anyhow, you can protect yourself, protect your children, protect your family members, and protect the people around you.","So with dis money wey you dey spend anyhow, you fit use am protect yourself, protect your children, protect your family, and protect people around you." +That's what insurance has come to do for people.,Na wetin insurance come do for people be dat. +Thank you!,Tank you! +My name is Ibrahim Salomi.,My name na Ibrahim Salomi. +What I want to tell you about is how egusi is prepared.,Di ting wey I want talk about na how de dey take prepare egusi soup. +"First of all,you will grind your egusi depending on how much you want to make.","First of all, you go grind your melon, depending on di quantity weh you want prepare." +"After you've ground the egusi, you will pound pepper and keep it on the side.","After you don grind di melon, you pound pepper keep." +You will get everyt-... all your ingredients ready so that the dish will be easy to prepare.,You go make everyt-... all your ingredients ready so dat di soup go dey easy to prepare. +"After you've ground your pepper, uh... you slice your vegetables.","After you don grind your pepper eh, you slice your vegetable." +"Maybe, if you want to use ugwu, it's either ugwu, or bitter leaf, but mostly, as for me, I like to use uh... pumpkin leaf (that is ugwu) to prepare my egusi.","Maybe if you want use ugu, it's eider ugu, or bitter leaf, but mostly, me, I dey like use eh pumpkin leaf (dat is ugu) to prepare my melon soup." +"Then after I've sliced the ugwu, then, I wash my meat, my okporoko (that is dry f-... uh... stockfish), and then my dryfish.","Den after I don slice di ugu, den, I wash my meat, my okporoko (dat is dry f-... eh stockfish), and den my dry fish." +I wash everything together.,I wash everyting togeder. +Then I... I steam it with the meat,"Den I, I steam am with di meat." +"Then I add some seasoning like Maggi cubes, salt, and onion.","Den I add some seasoning like Maggi cube, salt, and onion." +"After it's steamed thoroughly, I take it down.","After di ting don steam well, well, I carry am down." +"Then, I put the oil in my pot.","Den, I con pour di oil inside my pot." +"As I put the oil into my pot, I like to fry my egusi.","As I pour oil inside my pot, me, I dey like fry my melon." +It has this kind of taste it gives me.,E get di kind taste wey e dey give me. +Then I put the egusi in the oil and fry it well to my taste.,"Den I go con pour di melon inside di oil, fry am well to my taste." +"After I've... after I've fried the egusi, then I'll put in the meat and the fish, and stockfish I have already seasoned.","After I don, after I don fry di melon, den I go con pour dat meat, and di fish, and stockfish wey I don already season." +Then I'll put it into the egusi.,I go con pour am inside di melon. +I'll leave it on the fire to boil for about ten minutes.,I go leave am on top of di fire to boil like ten minutes. +"After it has boiled properly, I'll put in the pumpkin leaves I've washed thoroughly.","After e don boil well, den I go con pour di pumpkin leaf wey I don wash well, well." +Then I'll put the pumpkin leaves into it.,Con pour di pumpkin leaf inside. +"I'll leave it in the pot... on the fire, for it to steam like... it should cook for about ten more minutes.","I go leave am for pot, for fire meh e steam like, meh e cook like more ten minutes." +Then my egusi dish is ready.,Den my egusi soup is ready. +"After I've taken it down, then I'll decide whether I want to eat it with akpu, pounded yam, or garri.","After I don carry am down, I go con decide wheda na akpu, or na pounded yam, or na garri I want take chop am." +"Then, you can enjoy it with your akpu, garri,or pounded yam, whatever you want, but me personally, I am in my place, my hometown, Kogi State.","Den, you fit still enjoy am with your akpu, garri, or pounded yam, anyone of your choice, but me, personally, I dey for my place, my home town, Kogi State." +"So, as I was coming back now, I got off the bus.","So as I dey come back now, I con come down from bus." +Then this one criminal picked my pocket and took my purse.,"Naim one criminal like dat con do me pick pocket, con comot my purse." +He thought there was money in it.,E tink sey money dey inside. +"Meanwhile, I had my school ID card, and just my ATM card, in the purse.","Meanwhile, na my school ID card, and just my ATM card na im dey di purse." +"So when I realized, I turned back and said quickly ""hey, give me my purse!""","So when I con discover, I con turn back sey oya give me my purse." +"Immediately, he was... afraid, so he gave me the purse back.","Immediately e con, con fear, con give me di purse back." +"So, that was how he and I walked away.","So na so o me, and am take waka o." +He can't steal from me because I've been around the block.,"E no fit thief me because me sef, I be agboro." +That is how the story ends.,Na so di story take end o. +Ah!,Ah! +I just...,I just... +"When I just finished uh... taking my SSCE exam, so, when I finished taking my SSCE, I was there looking for a job, uh...","When I just finish eh writing my SSCE, so when I finish writing my SSCE here, I dey dey look for job, dey..." +"After I finished that SSCE, I was looking for some menial job to do.","After I finish eh dat SSCE, dey look wheder I go get some menial job to do mtschew." +"So, I started uh...",So I started eh... +"Sometimes, I joined some people working on construction sites and helped them.","At times, I go too follow some people dey go site, dey do dis labourer work, dey carry help am." +I now...,I con... +"One day, I thought to myself, man.","One day, I con tink for myself o mehn." +This isn't what you do if you wanna get somewhere in life.,Dis tin no be di tin wey person go carry become human being for life o. +Because this isn't skilled labor.,"Because dis tin no be, no be, no be handwork." +"Then, I called one of my older brothers who was in Lagos at the time.",Naim I call one of my elder broder wey dey Lagos dat time. +"I told him, ""man is it good to be a skilled worker.""","I tell am sey oh boy, man, e dey good meh person dey get just handwork." +Sometimes you can...,"At times, make..." +If someone...,If somebody... +"If you're a skilled worker, you can still use that to get by if school doesn't work out.","Dat handwork, if di school no work out, at least, we go carry dat one dey patch up life." +"So, he told me OK, go find somewhere you can pick up a skill.","So e con tell me sey okay make I go make en-... enquiry where, any place wey I go fit learn di work." +"So, I arrived, I started going up and down the streets of Gwagwalada looking for something to do, so I could maybe learn the skills.","So I reach, I start to dey waka di whole street of Gwagwalada dey find where I go make tins, wheder I go learn di work." +"So, any place I went, they would ask me for a lot of money. Wherever I went, they would ask me for a lot of money.","So any place where I go, dem go call big money for me, any place where I go, de go call big money for me." +"So, I went to a place.",So I come go one place. +That's when I met the man.,So naim I meet di man. +I talked with him.,I follow di man talk. +"I told him ""oga, this your luck, uh... work, I like it, I want to know more about it.""","Tell am sey Oga, dis your luck, eh work o, I like am, I wan sabi am." +He asked if I wanted to learn it.,E say I wan sabi am? +I said yes.,I say yes. +He said OK.,E say okay. +So what now?,How we go do now? +"I told him ""me, I want to learn it.""","I tell am sey me, I wan sabi am." +I want to know uh... our agreement.,"How, I wan know e, di agreement wey e go carry." +Uh... how much he'll take to teach me his job.,Ehn how much wey e go carry teach me dis work. +"So he said ""OK, no problem.""","E con say, okay no problem!" +He'd teach me his job for about ten thousand naira.,"Dat di amount wey e go carry teach me dis work, na about ten thousand naira." +"I said ""OK, no problem.""",I say okay no problem! +I went to call my people.,I go call my people. +"""Let's sign, OK?""",We sign abi? +"He said I should bring malta, or soft drinks and cookies, which I did.","E say I go bring malta, or mineral and biscuit, which I give am." +"So, at the end of the day, I started learning the work.","So at di end of di day, I start to dey learn di work." +I spent a year and six months learning the job.,"When I learn di work, I learn di work a year, and six month." +"After I learned the job for a year and six months, I realized I'd mastered it.","After I learn di work a year, and six month, I see sey I don sabi di work." +"I then called him, Oga, and said what you're gonna do now is let me go.","I come call am Oga, di tin wey you go do be sey, now be sey you go free me o." +"At least, I should also be independent like you, who's feeding your own family.","At least, meh me too become man of myself as you kuma become man of youself dey feed your own family." +"He said OK, no problem since the, the, my time with you has, has, has finished, he will let me go with some money.","E say okay no problem, dat since de, di, my time with you don, don, don do, sey e go settle me." +"So I kept working for him for like two or three months before he let me go, so that makes a year and eight months.","So I come serve am for some two, or three months before e come settle me making a year, and s-... eight months." +"Uh... so a year and uh... nine mon-, uh... ten months.","Eh making a year, and eh nine mon-... eh ten months." +"So, when I se-, he let me go with some money, I started to hustle on my own, going from one site to another.","So when I se-... e settle, e settle me, I start to dey hustle my own sef dey go site to site." +"Even as I was going to different sites, I thought that, man, as soon as you finished learning the job, you'd be a millionaire.","Upon sey I dey go site to site, me, I tink sey mehn na when you just learn dis our work, you go don become millionaire." +"I didn't know that when you learn this work, hehe, you can forget about that!","I no know sey when you learn di work sef, hehe comot sef." +"That's when you find out that no, no, no, life's no piece of cake.","Na dere you go know sey dis, dis life ni, dis life no, no, no be small tin." +"So, that was how I started hustling to get by.",So na so I start to dey hustle o. +"I was going from one site to the next, telling them, giving them my business card.","I go go site to site dey tell dem, dey give dem my complimentary card." +Uh... I'm an aluminum technician.,Ah I be aluminium technician. +"I do this, I design these windows.","I dey do dis one, I dey design dis window." +I know how to design these windows.,I sabi design dis window. +"I do this uh, uh... sliding net, case, casement, open and swing doors.","I dey do dis eh eh sliding net, and, and case, casement open, and swing door." +"They'd say OK, no problem.",Dem go say okay no problem! +Life in our line of work isn't... it's not easy.,"Life for dis our work, no, e no dey easy o." +"So, the first time there was a contract that I got, that they...",So di first time I get one contract wey I hit wey dem... +Somebody just called me.,Somebody just call me. +It was my friend's dad.,Na my friend papa. +"As he called me, thinking he would help me out, I billed him almost sixty thousand naira for a work worth a hundred thousand because I needed the money.","As e call me, thinking maybe as e go help me do sometin, I charge am work say I go do di work almost sixty thousand naira for am (work wey dem dey do hundred thousand) because of hungry." +"I said ""OK, give me sixty thousand naira.""",I say okay bring sixty thousand naira. +"Eventually, he gave me forty thousand naira.","To di extend, e give me forty thousand naira." +I bought a lot of materials.,"I buy material, buy material." +"Eventually, I finished the work.","To di extend, I do di work." +There was twenty thousand naira left.,Remaining twenty thousand naira. +The...,Di... +"When the guy saw that I had done the work, he refused to pay up.","When di man don see sey I don do di work finish, di man swallow di money." +"So, I thought about it, well.",So I look am toh. +"This guy is my friend's father, you know.",Dis one na my friend fader now. +What can I do?,Wetin I go do? +"I couldn't face, face him and stand up to him.","I no go fit follow, follow am go di highest talk." +I forgot about it.,I look am. +"As time went on, I was still there, hustling on different sites.","As time goes on, I dey dere dey hustle to site, to site, to site, to site." +"If I saw a small job to do, I took it.","I go see small work, I go do." +"At times, I'd do jobs in the area, in the area, that weren't even in my field, just to put food on the table and get by in life.","At times, di work wey no be my own work sef I go, I go enter am do am in area, in di area to get wetin man go put for bele, wetin man go just carry dey survive, patch up dis life." +Because I know life isn't easy.,"Because I see sey dis life, e no dey easy." +"So when man... when God created huma-, man... as men, we have a lot of things to face. We have a heavy cross to bear.","Hence man don, God don create man become huma-... man, we get a lot of tins to face, we get a lot of cross to carry." +"So, that's it.",So na im o. +"So much that even last year, when they called me for a job, I did it.","To di extend sef, even last year sef, where de call me for work, I do di work." +"When I finished the job, the guy told me there were some problems with the work I did.","When I do di work finish, di man come tell me sey dat di work wey I do for am, e dey, e get some problem." +So much that he wanted to get out of paying me.,"To di extend, e wan carry style swallow di money." +I called him.,I call am. +"Oga, there's no, no problem with the work.","Oga, di work no do some, no get problem." +"Call uh... some aluminium technicians now, let them take a look.",Call eh some aluminium technicians now meh dem view di tin. +"Eventually, he went and called some aluminium technicians behind my back.","To extend sef, e go call some aluminium technician on my back." +They told him there were no problems with the work.,"Con tell sey Oga, dis work no get problem." +So later on he admitted that the work was fine.,So na later e con dey confess to me sey di work no get problem. +"So later, he paid me my money.","So later, e con pay me my money." +That's the money I used to do something for myself.,Na dat money I come carry do sometin for mysef. +I put some on...,Put some on... +"So that that even recently, one of my friends handed one of his sites over for me to manage.","To di extend sef, even recently now sef, e get one of my friend wey don handle one of im site sef for me make I dey manage." +"So the site, I'm mana-... I'm managing it.","So di site sef, I dey mana-... I dey manage di site." +"To the extent again that I've just become become the site engineer, supervising the building.","To di extend sef, na me just become engineer for di site, dey supervise di building." +"And I know that, when the time comes, at least, he will give those, those aw-, ar-, ar-, windows to me.","And I know sey when time come, at least, e go throw dat, dat aw-... ar-... ar-... windows for me." +I will do them.,I go do am. +I will do them.,I go do am. +I will survive.,I go survive. +That's it.,Na im. +"In this life, becoming a man isn't easy.","Dis life, to become man, e no dey easy." +"My people, I welcome you all to this Sunday service.","My people, I welcome una to dis Sunday o." +"As it is, you all know that we are already in the season of Lent.","As e be so, una see sey we don enter di season of Lent." +"And the season of Lent, as discussed on Ash Wednesday, is the season of preparation for the glorious passion of our Lord.","And di season of Lent, as we talk for Ash Wednesday, na di season of preparation for di glorious passion of our Lord." +"On Ash Wednesday, we told you that this period is the time of fasting, it's the time of alms-giving, it's the time of prayer.","On Ash Wednesday, we tell una sey dis time na time of fasting, na time of alms giving, na time of prayer." +Those are the three pillars of Lent.,Dose na di three pillars of Lent. +"And as we did to you on Ash Wednesday, you all received ashes on your foreheads.","And as we do for una for Ash Wednesday so, una receive ashes for forehead." +The ashes are to show you that you are mourning for sin.,Di ashes na to show una sey una dey mourn for sin o. +It doesn't mean that you put the ashes on your forehead to start fighting.,No be sey una put di ashes for forehead begin dey fight. +"And that's why Prophet Joel told us that we should rend our hearts, not our garments.",And na so Prophet Joel tell us sey make we render our hearts not our garments. +"And if we take a good look at today's reading, you will realize that the temptations will be much greater than usual in this time of Lent.","And if we look the reading today so, you go see sey temptation go even plenty for dis time of Lent well, well." +"If you take a look at Jesus, He went into the desert.","If we look Jesus, e go desert." +He fasted for forty days and forty nights.,"E fasted for forty days, for forty nights." +"Thereafter, He faced temptations.",E faced temptation after. +That is to show us what Hebrews four fifteen told us.,Dat na to show us wetin Hebrew four fifteen tell us. +Jesus was tempted like us.,"Sey Jesus, dem tempt am like us." +"But in His own case, He did not sin.","But im own, e no sin." +Because it's not true that it is bad to be tempted.,Because no be sey e bad make person dey tempted. +All of us will face temptations.,All of us go face temptation. +The bad part is when you fall into the temptation.,Di bad side na when you fall into di temptation. +And God has a way of giving us grace.,And e get di way wey God take dey give us grace o. +God gives us power to overcome our temptations.,God dey give us power make we take overcome our temptation. +"But it depends on us, whether we want to use the power or we don't want to use the power.","E con depend on us whether we wan use di power, or we no wan use di power." +But the power is available.,But di power dey. +Because God will not expose us to temptations which are above our capacity.,Because God no go give us temptation wey go pass our power. +He exposes us to temptations which we will have the capacity to overcome.,Dey give us di temptation wey be sey we go fit get di power to overcome. +"If we take a good look at Jesus, Satan tempted him in three areas.","If we look Jesus so, Satan tempt am for three areas." +"He tempted Him with pleasure, he tempted him with power, he tempted him with money.","E tempt am for pleasure, e tempt am for power, e tempt am for money." +Who doesn't like pleasure?,Who no like pleasure? +Everybody likes pleasure.,Everybody like pleasure so now. +It you look at uh... Eve...,"If you look ehm, if..." +"When Satan tempted her, Satan told her that if you pick the fruit, that the fruit will be sweet.","When Satan tempt her, Satan tell am sey if you pluck di fruit, sey di fruit go sweet." +He said that Eve will become like God.,Sey Eve go be like God. +"She will be able to know what is good, she will be able to know what is evil.","E go fit know wetin good, e go fit know wetin evil." +Who doesn't want to be like God?,Who no wan be like God? +"Eve looked at the fruit, like this.",Eve look di fruit like dis. +"As she looked at it, she said... she said ""it's good.""","As e look am, e say, e say e sweet." +She noticed that the thing is pleasurable.,See sey di ting dey pleasurable. +She ate it.,E chop am. +"That's hunger now, it's an issue of hunger.","Na hunger now, na hunger issue." +The same Satan came to Jesus.,Di same Satan con meet Jesus. +"He said, ""you have been fasting for days, you need to turn stone into bread now, so that you can eat.""","E say you don dey fast since, you need to turn stone to bread now, make you fit chop." +Who doesn't want to eat?,Who no wan chop food? +But Jesus told him.,But Jesus tell am. +"He said, ""get thee behind me, Satan.""",E say get behind me Satan. +Is that not so?,No be so? +Part of the temptations you face is an issue of hunger.,Part of di temptation wey una dey face na issue of hunger now. +You are hungry.,You dey hungry. +You can do anything to get food.,You fit do anyting for food. +But Jesus said you should not do just about anything to get food.,But Jesus say make you no do anyting for food. +"He said you will be able to tell Satan ""get thee behind me, God is more powerful than you are.""","E say you go fit tell Satan sey get behind me, sey God get power pass you." +"Now, let's go to the issue of power.",Den make we go di issue of power. +Who doesn't like power?,Who no like power? +Everybody likes power.,Everybody like power. +"The husband wants to have power over the wife, the wife wants to have power over the husband.","Husband want get power over di wife, wife want get power over di husband." +Is that not what we hear on the news these days?,No be wetin we dey hear for news today? +"People kill for power, people do so many things for power.","People dey kill for power, people dey do so many tings for power." +Did a woman not stab her husband the other day?,No be one woman stab her husband di oder day so? +She said that the husband was not good enough.,"Sey di husband no dey do well, well." +Everybody wants power now.,Everybody wan power now. +"And Satan knows that Jesus, as a human being, wanted power.",And Satan even know sey Jesus as human being wan power. +He told him.,E tell am. +"He said, ""climb the mountain, jump down.""","E say climb di mountain so, jump down." +"""You will be able to show everyone that you are powerful if you can jump down from that high mountain.""",You go fit show everybody sey you get power if you fit jump down from dat high mountain. +But Jesus told him the same thing.,But Jesus tell am di same ting. +"He said, ""get thee behind me, Satan. You shall not tempt the Lord, your God.""","E said get behind me Satan, you shall not tempt di Lord, your God." +So you also have power to tell Satan that he should get behind you.,So you sef get power to tell Satan sey make e get behind you. +"If the whole issue of... let's say power, comes up, you want to be powerful.","If the whole issue of say power come, you wan get power." +You want to show that you are in charge.,You wan dey show sey na you dey dere. +Nobody is totally in charge.,Nobody dey dere now. +Only God is in total control.,Na only God dey. +So the best thing is to calm down.,So di best ting na sey make you calm down. +Let everybody humble him.,Meh everybody humble himsef. +Let everyone calm down totally.,"Meh everybody pele well, well." +"If you calm down totally, and you are humble, God will give you the power you need.","If you calm down well, well, and you humble, God go give you di power wey you need." +"And then, we move to the third one, money issues.",And den we go to di third one money issue. +"Everyone wants money these days, everybody does anything for money.","Everybody, na im want money dese days, everybody, na im dey do anyting for money." +"Children kill mothers, mothers kill their children.","Pikin dey kill mama, mama dey kill pikin." +All because they want money.,All because e want money. +Everybody wants money.,Everybody want money now. +But even Satan tempted Jesus over money issues.,But even Satan tempt Jesus on top money issue. +He showed Him all the glory.,E show am all di glory. +He showed Him all the wealth.,E show am all di wealth. +He said all this was available.,E say dis one dey. +Better things are available if you'll just bow... just bow to me.,"Better dey if you fit just bow, just bow to me." +"Once you bow to me, you will take possession of all the money.","Once you bow to me, so you go get all di money." +What do we all bow to nowadays?,Wetin all of us dey bow to now? +We bow to different people.,We dey bow to different people. +"We bow to people who lie to us, we bow to traditionalists, we bow to different people, all because we want money.","We dey bow to people wey dey lie to us, we dey bow to traditionalists, we dey bow to different people, all, because we want money." +But Jesus is telling us.,But Jesus dey tell us. +"He said you don't need to bow to people, bow to God alone!","E say you no need to dey bow to people, bow to only God!" +God will provide what you need.,God go provide wetin you need. +That's what Jesus wants us to do.,Na wetin Jesus want make we do. +So we all need to learn that nobody is free from temptation.,So we all need to learn sey nobody free from temptation. +And the fact is that it is not a sin to be tempted by the Devil!,And di fact na sey no be sin sey Devil tempt you o! +It's not a sin at all because the Devil tempted Jesus.,No be sin at all because Devil tempt Jesus sef. +The only instance where it is considered sin is when you fall into the temptation.,Di only where wey sin dey na when you fall into di temptation. +So do not worry.,So make una no worry. +Go on facing temptation.,Make una dey face temptation. +"In fact, you will face many more during this period.","Una go face more even dis time well, well." +Because this period is a very serious one.,"Because dis time na very, very serious time." +It's a time to deprive yourself of so many things.,Na time to deprive yoursef of so many tings. +"A time to say, this thing... I will not do it again.","Time wey you go say dis ting, I no go do am again." +"All the bad things I did before, I do them no more.","All di bad, bad tings wey I dey do before, I do dem no more." +Because Jesus came to change us.,Because Jesus come to con change us. +And another good thing about this period is that it is a season of mercy.,And anoder good ting for dis period na sey na season of mercy o. +God forgives all our sins.,God dey forgive all our sins. +No sin is too big for Him to forgive.,No sin wey too big for am to forgive. +"That's why He said (in what Paul said in First Corinthians) ""where sin abounds, grace abounds even more.""","Na why e say (for wetin Paul talk for first Corinthians) sey where sin abound, grace abounds even all di more." +"Where there is sin grace is abundant, even all the more.","Where sin dey, grace, e plenty even all di more." +So there's no sin that God cannot forgive.,So no sin wey God no fit forgive. +The important thing is that you tell Him the sin.,Di major ting na sey make una tell am di sin. +Tell Him your sins and let me tell Him my sins.,"Tell am your sin, make I tell am my sin." +"If you hide your sins, there's nothing Jesus cannot see.","If you hide your sin, noting wey Jesus no fit see." +"So if you tell Him your sins, He will forgive you.","So if you tell am your sin, e go forgive you." +He will blot it all out.,E go remove everyting comot. +"You know, if you look at it very well, a man, uh... Mahatma Ghandi, said it.","You know, if you look am well, well, one man, ehm Mahatma Ghandi talk am." +"He said one day, he stole his father's bracelets.","E say one day, e steal im papa bracelets." +"Immediately after he stole them, the father started looking for the bracelets.","As e steal di ting like dis, naim im papa dey look for di bracelet." +"As his father was looking for them, he didn't know what to tell the father.","As im papa dey look for the ting, e no know wetin to tell im papa again." +"Then he... one day, he wrote it on a piece of paper.","E come one day, e con write am for inside paper." +"He told the father ""I stole your bracelet.""",Tell di papa sey na me steal your bracelet. +"If you were the father, and your child showed you that kind of thing after you'd gone through the trouble of searching for it, what will you do to him?","If na you be di papa so, and your pikin show you dat kind ting after you don suffer dey find di ting, wetin you go do am?" +You will want to slap him.,You go wan slap am. +"But as the father received the paper, he read it and he smiled.","But as e papa receive di paper read di ting, e just smile." +He just laughed at Mahatma Ghandi.,E just laugh to Mahatma Ghandi. +"Mahatma Ghandi was shocked and said ""a'ah, why is father laughing at me?""",Mahatma Ghandi con shock say aha why papa dey laugh give me now? +"The father tore up the paper, then he hugged the boy and he said to him, ""I have forgiven you, don't worry"".","Di papa con tear di paper, e con hug di boy, e con tell am sey I don forgive you, no worry." +From that day uh... Mahatma Ghandi loved his father deeply because he wasn't expecting what the father did.,"From dat day eh, Mahatma Ghandi love im papa no be small because e no expect wetin di papa do." +Jesus does the same thing for all of us.,Di same ting wey Jesus dey do for all of us. +All we need to do is to tell Him all our sins.,All we need to do na make we tell am di sin. +He will tear everything off.,E go tear everyting comot. +"And He will love us more, and we will even be worthy of hugging Him so tight because He is God.","And e go love us di more, and we go even fit hug am well, well because na im be God." +He is not a man.,E no be man. +It's a man who may not forgive.,Na man fit no forgive o. +Man may not forgive.,Man fit no forgive. +"That's why they say, ""to err is human, to forgive is divine.""","Na why de say to err is human, to forgive is divine." +Man may not forgive at all but God forgives all sins.,"Man fit no forgive at all, but God dey forgive all di sin." +What we need to do is to tell Him.,Wetin we need do na to tell am. +"So this season is the best time, the best time for all of us.",So dis season na di best time o di best time for all of us. +Let's come back to Jesus.,Make we come back to Jesus. +"If we have sinned before now, let's not sin again.","If we don sin before, make we no sin again." +That's why we are in the season of Lent.,Na why we dey di season of Lent. +"And that's the main reason we told ourselves on that Ash Wednesday ""remember that you are dust, and to dust you shall return.""","And na di main reason wey we tell ourselves on dat Ash Wednesday sey remember dat you are dust, and to dust you shall return." +It's dust we are made of.,Na dust na im dem form us from. +"The basic difference between us and those things fine artists do is that God breathed life into us, but those things... nobody can put life into them.","Di basic difference between us, and dose tings wey fine artist dey do na sey God breathe life into us, but dose tings, nobody fit put life into dem." +But God loves us so much.,But God so much love us. +"When He finished forming us, He brought life into us.","After e form us finish, e bring life into us." +And we are going back to that same dust.,And we dey go back to dat same dust. +So that's it for today.,So na so e be today o. +That's how it is today.,Na so e be today. +Let us all do well.,Make all of us dey do well. +Let's journey through this season beautifully and we will discover that the mercy of God will be upon us.,"Make we journey through dis season well, well and we go see sey di mercy of God go dey upon us." +And His life will remove every darkness which is upon us because we all have one form of darkness or the other.,"And im light go remove every darkness wey dey our body because all of us get one form of darkness, or di oda." +"So I appreciate you all for coming because if you don't show up, what will we do?","So I tank una o as una come so because if una no come, wetin we go do?" +The church will just be empty.,Church go just empty now. +"So as you all came here and as we are offering this eucharistic sacrifice, we pray that God will accept our sacrifice.","So as una come so, and as we dey do dis Eucharistic sacrifice, we pray make God accept our sacrifice o." +"We pray that God will have mercy on us, forgive us, and He should remove all our sins through Christ, our Lord, amen.","We pray meh God have mercy on us, make e forgive us, and make e remove all our sins trough Christ, our Lord, amen." +"Eh myself, well my father, he is a policeman.","Eh me, my fader sha, na police man im be o." +I'm a policeman's daughter.,I be police man daughter. +So work... I came to this school.,"So na work I, carry me come dis school wey we dey." +My parents are...,Na my parents dey. +My father is a policeman.,My fader na police man. +"My mother, she is a businesswoman.","My moder, na business woman she be." +"Even myself, I go into small scale businesses.","Even me sef, I dey touch small, small business." +I'm not just into teaching.,No be only dis teaching work I dey do. +"I am also into business, selling shoes and bags.","I still dey do my business, dey sell shoes, dey sell bag." +"Sometimes, I travel to Lagos to buy them and bring them here.","Sometimes, I dey travel go Lagos, go buy dem come." +You know that things in Lagos are also nice.,"You know sey Lagos tings, e dey also fine." +"I go there to bring the goods to Jos, and then sell to my people.","Go carry am come Jos, come sell am for people." +"But if it's okirika [used] things, it looks like we have the best here in Jos because things are very cheap, your clothing... anything you want to buy.","But if na okirika market, e be like sey we get di best for dis Jos because tings dey very cheap for your clothings, anyting wey you want buy." +"Children's clothes are also available, the used ones, you'll get them almost new.","Even children cloth sef, for dat Okirika, you go get dem first grade." +A lot of people go there to buy it.,Plenty people dey go dere go buy. +There are lots of fruit in this state.,E get plenty fruit for dis state. +You've noticed.,Una don see am. +We have fruit.,We get fruit. +We buy them really cheap.,We dey buy dem very cheap. +"It's not expensive at all, never.","E no cost at all lai, lai." +"Watermelons, oranges, bananas which... they are very cheap.","Watermelon, orange, banana wey dey very cheap." +"So people don't get sick in Jos anyways because our weather is good, our food is good, and it's not expensive.","So Jos people no dey sick anyhow sha because our weather good, our food good, and e no cost." +Anybody can come to this...,Anybody fit come to dis... +You can... you can come to Jos to buy the fruit.,"You fit, you fit come dis Jos buy di fruit." +You will enjoy it.,You go enjoy am. +"And accomodation isn't costly in this town, at all.","And accommodation for dis town, e no dey costly at all." +Vistors... strangers can come anytime.,"Visitors, stranger fit come anytime." +They don't pay much in rent.,"Di money wey dem dey pay for rent, e no cost." +"And the people of Jos... even if you don't know anyone and you are new in this town, you'll meet people who won't make fun of you.","And Jos people, even if you no sabi anybody, you just enter dis town, you meet stranger, no go want carry you do yeye." +"They would want to help you, show you the way, show you a place you can stay.","E go want help you, show you your way, show you where you fit stay." +They would even tell you areas where accomodation is expensive and where it is cheap.,"E go even tell you where accommodation dey expensive, and which one dey cheap." +That's who Jos people are.,Na so Jos people dey. +They are very peaceful.,Dem dey very peaceful. +They don't look for trouble!,De no dey look for trouble o. +"They don't like to fight, or anything.","De no dey like fight, or anyting." +"As you see, whether you are a Christian or a Muslim, we all live together.","As you see, wheder Christian, Muslim o, we dey live togeder." +We don't like trouble at all.,We no dey like trouble at all. +So Jos is a very beautiful state.,So Jos na very beautiful state. +I like this state.,I like dis state. +I like to stay in Jos.,I like to dey stay for Jos. +"Even if I go to Lagos, the heat over there makes it uncomfortable for me to stay long because I'm already so used to this town.","Even if I go Lagos, heat no dey gree me stay because I don dey use to dis town." +This weather here is so beautiful.,"Dis our weather, na beautiful weather." +And we don't like to leave it anyways because this is home.,And we no dey like to dey leave am anyhow like dat because here na home. +It's just like we're in America.,E just dey like sey we dey America. +It's not...,E no... +"People say that if a guy from Jos goes to America, he won't have problems adapting because the weather also gets so cold here like...","De say if Jos man go America, e no go suffer again because di cold wey dey here sef be like sey..." +I haven't been to America yet but the cold here is like what they describe in America.,"I never go America sha o, but di cold, e be like di one wey dem dey describe for America." +"So if someone leaves Jos for America, they can stay there because you're already used to the weather.","So if person leave Jos go America now, e fit stay because you don dey use to di weather." +"Hm... about our hair, you know we have lots of hairstyles which we like to plait here in Jos.","Hm for hair, you know sey we get plenty hairstyle wey we dey like to dey plait for dis Jos." +We have exotic hairstyles.,We get beriberi style. +"We plait our hair to the front, and to the back.","De plait am front, and back." +"They will pack it like this, it's beautiful and really cheap.","Dem go pack am like dis, e go fine, e dey very cheap." +"You'll see, our girls like it.",You go see our girls dey make am. +We don't really wear weave here.,No dey too wear weavon for here. +It's mainly plaiting.,Na plaiting. +"People wear weave, but no-... not much.","People dey wear weavon, but no-... not much o." +"Here, we plait our hair, mainly.",Na plaiting we dey plait for here. +Because plaiting here isn't expensive at all.,"Because to plait, for here, e no cost at all." +And the people of Jos are experts in the hairdressing business.,And Jos people sabi to make hair. +"In fact, before you go, I can show you where you can get your hair done.","Before una go sef, I fit show una where una go fit go make una hair." +You'll like it.,Una go like am. +"It's really cheap, really affordable and it will last longer on you.","E dey very cheap, very affordable, and e go last you." +We do our hair now and leave it on for a month.,"We fit make hair now, carry am for one month." +You'll still see it.,You still see am. +It'll still look neat.,E go still dey new. +Becaust they'll plait it very well.,Because dem go plait am well. +"But in Jos, dressing hair... (just because hairdressing is the main business of the women here), you can't just call up your hairdresser and say you want to get your hair done.","But Jos, to make hair (just because di hair sef, na im be di main business for women here), you no go fit just call your hairdresser sey you want go make hair." +You'll need to book ahead of time because there's always a lot of people there.,You go book her because people dey plenty for dere. +"There are many, many girls who dress hair in this place, but first you, you will book a space because the wait is mostly long.","E get plenty, plenty girls wey dey make hair for here, but you, you go book first because di queue dey plenty most of di time." +Do you see why I like Jos?,"See why me, I like Jos?" +Because life here is easy.,Because life for dis place na jeje. +"No problems, no hustle and bustle like in Lagos, no heat, nothing.","No wahala, no rushing like all dese Lagos, no heat, nothing." +"Even when it rains, you'll just notice that our weather is nice.","Even as rain dey fall sef, you go just see sey our weather sweet." +You don't have any problems.,You no get any problem. +Wo-... reach... uh... rashes won't appear on your body because the weather isn't hot.,"Wo-... reach, eh rashes no go dey comot for your body because heat no dey." +The weather is good here.,Na better weather dey here. +I can't compare it with Lagos because there's too much heat over there!,No go fit compare am with Lagos because heat too much for dat side! +"You'll see rashes, you'll see people's skin being affected with all kinds of things, but here, the weather is good on us.","You go see rashes, you go see people skin dey spoil, but for here, di weather dey sweet us." +"We don't worry about rashes, or anything.","We no dey worry for rashes, or anyting." +"With the way the weather is, we don't really put on makeup.","As di weather dey sef, we no too dey do any makeup." +"And if you insist on putting on makeup, it wont get messed up.","And if you say you go do your makeup, e no go spoil." +"You know that if the weather is too hot, it it messes up makeup, but here, people who wear makeup wear it for longer because the weather is cold.","You know sey if heat too much, e dey spoil makeup, but for here, people wey dey do makeup, e go last dem because di weather dey cold." +It's nice and it doesn't affect makeup.,"E dey good, and e no dey affect makeup." +"So myself, I love this Jos of mine a lot.","So me, I like dis my Jos very well." +"Plateau State is the home of peace, and tourism, a beautiful place to be.","Plateau State na home of peace, and tourism, a beautiful place to be." +"And I'm sure that before you leave, even if you go back home right now, you will feel like you've left a better place.","And I sure sey before una go go, if una go back house now sef, una go dey feel am sey ah una don leave better place now." +"Because the weather... I know that you are feeling cold, but you are starting to get used to it by now.","Because di weather, I know sey una dey catch cold, but by now una don dey use to am." +Because we have good weather here.,Because na good weather dey here. +There are no problems with it.,Dere is no any wahala about it. +"The people are very peaceful, very accommodating.","Na very peaceful people, very accommodating." +"They will listen to you when you speak; if you need anything, even if you've lost your way, you will come across lots of people who will guide you.","If you talk, dem go listen to you, if you want anyting, if you lost your way sef, you go see plenty people wey go guide you." +Nobody wants to get money out of you.,Nobody want collect your money. +Nobody!,Nobody! +We don't have pickpocketing in Jos.,We no dey do picking pocket for Jos o. +It's hard.,E dey hard. +They don't do that here at all.,No dey do dat one for here at all. +They don't snatch people's bags in Jos anyhow.,De no dey snatch people bag for Jos like dat. +Hm'm!,Hm'M! +People are plenty happy with the little they have.,Di people dey very okay wit di little wey dem get. +"They're a very peaceful people, and very accommodating.","Na very peaceful people, and very accommodating." +We are not that troublesome.,We no get wahala like dat. +That's what I want to tell you about Jos.,Di ting wey I go tell una about dis Jos. +Thank you very much!,Tank you very much! +"Things have been so hard that if a man and a woman like each other and say to each other ""we'll get married tomorrow. You will be faithful to me alone. Don't be faithful to another person."", it's a lie!","Tings don so hard sotay if man, and woman like each oda, con tell each oda sey we go marry tomorrow o, na only me you go dey follow o, no follow anoda person o, na lie!" +It doesn't work like that.,E no dey work like dat. +"That agreement we had, one of us will go and break it.","Dat agreement wey me and you get so, one of us go go back go scatter am now." +Uh... I know the question you're asking.,"Ehen me, na now me know di question wey you dey ask." +What you want to know is why they will go and ruin it.,Now wetin you want know be dat sey why de go con go scatter am? +Good.,Good. +"You see uh... on this first point, let me be the first to talk.","You see ehn first place wey we dey so, make I first talk man own." +Why will men cheat on women?,Why man go dey go dey cheat on women? +"You see, men, as they are, they have too many bad friends.","You see men, as you dey see dem so, de too dey get bad, bad friends." +I am not talking about you.,I no dey talk to una. +"And the friends, they're so en-... he-... they lead them astray.","And di friends dem so ehn, e, dem dey mislead dem." +"So those ones, even the pastors you see around, who go to church, yeah, are not left out.","So dose ones, even pastor wey you dey see so, wey dey go church so, some yeah dey dere." +Yes indeed!,Yes o! +"When they meet and talk privately, one pastor will tell the other uh... you know we are humans, so God understands.","When dem don go meet demself dey talk for back, one pastor go tell di oda one sey hm you know sey we be human being, so God dey understand." +"Then you who's never done it, would think it's true. It's not a big deal. It is a minor sin.","Den you wey never do am before, you go con look am sey na true sha, no be big ting, na small sin." +"So, they influence each other.",So dem dey influence each oda. +That's what makes...,Na im dey make... +That's what I've seen.,"Hm na wetin me, I see o!" +"Men cheat because the circle of friends they follow around, they don't see it as a big deal if you're not faithful to one woman.","Men dey cheat because sey di circle of friends wey dem dey follow dey waka, de no see am as big deal sey you no stay with one woman." +"In fact, it'll look like you're stupid.","In fact, e go be like sey you stupid sef." +"In this generation of ours now, being with only one woman, you don't have shortcuts (They call it shortcuts! Yes!), if you don't have shortcuts, what will you be like?","For di kind generation wey we dey now, sey you dey follow only one woman, you no get shortcut (de dey call am shortcut, hm), sey you no get shortcut, you go be like wetin?" +Are you Jesus?,You be Jesus? +That's how they are.,Na so de dey... +And it's what I see.,And na wetin me dey see o! +Yes.,Hm! +"So, they are...",So de dey... +"The cheating that is going on now, uh... from men's side, it's the type of friends they have, they are the ones teaching them how to cheat.","Di cheating wey dey go on so now ehn, from men side, na di kind friends wey dem get na im dey teach dem how to cheat." +"And I really mean it, so much that those who go to church are not left out.",And I mean am sotay reach sey even dose wen dey go church. +"If you don't have good friends, you will go to church (you know) and you will still cheat.","If you no still get better friend, you go still go church (you know), you go still cheat." +"Yes mtschew, man, are you open? Do you understand?","Hm mtschew dis my broda, you, you open, you sabi so?" +Do you get around?,You dey waka? +"If you don't go around, it's as if you're not aware of the things going on around you.","You no dey waka, e be like sey you no dey see road!" +You don't go out!,You no dey see road. +Go out!,Meh dey see road o! +Men cheat everywhere.,Men dey cheat up and down. +Women also cheat but men cheat more.,"Women dey cheat o, but na men own plenty pass." +And I'm telling you the reason why they cheat.,And I dey tell you di reasons why dem dey cheat. +Uh?,Hm? +This is because their friends encourage them.,Because sey deir friends dey encourage dem. +They don't have friends who will tell them that it's very bad.,De no get friends wen go tell dem sey e dey very bad. +"In fact, their friends will make it look like you don't know what's up if you don't cheat.",In fact deir friends go make am look like sey you no know what's up if you no dey cheat. +How can you just say you will be faithful to only one woman?,"How you go just say only one woman, na im you go just dey follow?" +That is a big problem that makes cheating happen in relationships.,"Dat na big problem wey dey make cheating dey, dey happen for relationship." +"Then, the other thing that happens is that the women themselves are bad.","Den di oda one wey con dey happen be sey women sef, dem bad." +We are the ones working against ourselves.,Na we dey do ourselves. +"If not, if a man asks the secretary out, and the secretary knows that a lady comes to see her boss, it means you know this boss has a wife.","If not, if man con meet secretary, and secretary know sey madam dey always come see oga, e mean sey you know sey dis oga get wife." +"How come, when the boss started flirting with you, when he started asking you out, you also agreed?","How come when oga con begin dey cut eye for you, con begin dey toast you, you sef, you gree?" +You are not supposed to agree.,You no suppose to gree so. +"So, apart from the fact that men are not focused (That's how we say it in pidgin. They're not focused. They don't have good friends.), we women, we're bad too.","Apart from sey men, deir eye no done (na so we dey talk am for Pidgin o, deir eye no done, dem no get better friend), we, women sef, we bad." +We are working against ourselves.,We dey do oursefs. +"This is because if you said no, the man would walk away.","Because if you say you no gree, di man go go." +"But if you give in, yes, the show begins.","But if you gree, ehen parade don start." +Yes.,Yes o! +"You call it a business, but I call it a show.","Na you call am business, na parade I call am." +Yes.,Ehen! +"Then, you see this cheating we are talking about uh... mtshew, our culture is bad.","Den, you see dis cheating wey we dey talk so ehn mtschew, culture dey bad." +"In this Nigeria we're in, if I am going out with your brother and your brother cheats on me, if I report him to you, you know what you will tell me now.","For dis Nigeria wey me and you dey so, if I dey go out with your brother, your brother cheat, I con report am give you, you know wetin you go tell me now." +Ah!,Ha! +You'll ask me if he was circumcised for my sake alone.,You go tell me sey weda na because of only me dem circumcise am? +"A woman once said to a girl, ""why do you say he should not flirt with another woman?""",One woman don tell one girl like dat sey why you'll say make e no follow anoda woman? +"""Is it because of you alone I circumcised my child?""",Na because of only you I circumcise my pikin? +"So, culture itself does not help in this matter at all.",So culture sef e no help matter at all. +"You will go and report to the mother and the mother will ask you, ""why? Let my child taste!""","You go go report give mama, mama go tell you sey why, make my pikin taste!" +"""Tasting"" they call it.",Or na taste dem dey call am o! +Let him taste other women.,Make e taste oda women. +"Yes, that is it!",Hm na so! +"Then you see this issue of cheating, I am talking about the men's.","Den you see dis cheating, na men own I dey talk o!" +Women's own uh... is more serious.,"Women own eh, e plenty." +Yes.,Hm! +"Then you see this cheating men indulge in, some women have money.","Den you see dis cheating wey men dey cheat so, some women get money." +They use it to catch men like this.,De dey take am catch men like dis. +They will buy them.,Dem go buy dem. +"But a man who you know is married, whose wife is managing, when he tells you he wants to celebrate his birthday, you will go and buy him an iPad, and the, all those other big things you give as gifts.","But man wey you know sey don marry, im wife dey manage, when e tell you sey e want do birthday, you go go buy am Ipad, and di, all dose big, big tings wey you take am do gifts." +"The greedy man then will begin to say madam, thank...",Di long throat man now go con begin dey say madam thank... +"Madam, Madam will soon become your name.","Madam, madam go soon start to become your name." +Then he'll start calling you by your name.,E go con start to dey call you your name. +Uh... Titi uh... thank you for yesterday.,"Eh Titi, eh thank you for dat yesterday." +"From there, bad things start happening.","From dere, bad, bad tings dey happen." +"So, because men are greedy, they're looking for better places.","So because of sey men greedy, de dey find where sweet." +The wife at home can't buy them an iPad for their birthday.,Di wife for house no dey fit buy dem Ipad during birthday. +"The rich women who know how to start making men sleep with them, if they like you, they will start buying nice things for you.","Rich, rich women wey dey find how dem go just take begin dey make men sleep wit dem, if dem see you say dem like you, de go begin buy big, big ting dey give you." +So indiscipline.,So indiscipline! +I call that indiscipline.,I call dat one indiscipline. +"Apart from greed on the part of the man, it's indiscipline.","Apart from greed on di part of di man, na indiscipline." +Good.,Good! +"Then, personally and finally, the women in the house, the wives at home, they are making some men cheat.","Den my own o, finally o, di women for house, di wife for house, de dey make some men dey cheat." +We know ourselves.,We know oursefs. +"Some men, as they are, they cannot control their body.","Some men, as you dey see dem so, dem no dey fit keep body." +They like their body to touch other bodies.,Dem dey like make body dey touch body. +"But you see, some women, uh... there is that time when we say we have a headache, we are not well, we did this, we did that.","But you see some of us, women, hm na dat time we go talk sey we get headache, we no well, we do dis, we do dat." +Ah!,Ah! +"Wherever a man will come, he will come.","Where man go come, e go come." +"You, you will be the only one to open your mouth and ask, ""please, is sex a kind of food?""","You, only you go con open your mouth, tell am sey abeg sex na food?" +Lea-... leave me... leave me... leave me... leave me alone.,"Le-... leave me, leave me, leave me, leave me alone." +Is that not so?,No be so. +Men will just go and cheat on you!,Di man go go cheat o! +"So, we women at home, we are the wives, uh... we contribute to why men cheat.","So we, di women wey dey house, wey be di wives eh, hm we dey contribute to why men dey cheat." +And some wo-... some women are dirty!,And some of wo-... some women sef dirty! +Oh!,Heh! +Mtshew oh Jesus!,Mtschew oh Jesus! +You...,You... +"A man whose secretary uses deodarants, perfumes and some other sweet... long-lasting and sweet-smelling things... you have been in the house all day and you have not even brushed your teeth.","Man wey im secretary for house dey use deodorants, dey use perfume, dey use swe-... strong, sweet, sweet, sweet, sweet smelling tings, you, you dey house since morning, you never even brush mouth." +Let alone take a shower.,Amawe to bath. +"When your man comes home, do you expect him to give in to you?","When di man go come house, you go con expect sey na you wan enter im..." +If you see the skimpy skirts these young girls wear nowadays uh... they are witches!,"If you see di short, short skirt wey dis children dey wear nowadays ehn, dem be witch o!" +Those girls... Ah! They are real witches.,"Dose girls, ah hm dem be better witch." +But if the woman in the house could try not to be too fat!,"But if di woman for house sef try, no fat full everywhere!" +Package!,Package! +They call it packaging.,Dem dey call am package. +Package yourself well.,Package yourself well! +Uh... I am not... hehe!,Ehn no I no dey humhum! +Package yourself well.,Package yourself well! +"E-..., e-..., e-...",E-... e-... e-... +Some men even like women to be full-figured.,Some men dey even like make women get body. +They call women like that 'grab something women'.,Dem dey call dose kind women grab someting women. +"Ah, let me grab some!",Ah mah I grab someting! +"Yes, so, the woman should try to be...",Yes so di woman go try make she... +"If you are full-figured, pack it well.","If you get body, dey package am well!" +Your man will like it.,Di man go dey like am. +"Then, as for women, why do they cheat?","Den on di part of di women, why dem dey cheat?" +Uh...,Hm! +You know women uh... as you are seeing them over there hey!,"You see women ehn, as you dey see dem dere so ehn, hai!" +Hm!,Hm! +How shall I put it?,How I wan take talk am o? +They are not satisfied with little things.,Small ting no dey reach dem! +"Since our university days, this my husband has never bought me a phone.","Since we go university together, dis my husband, e never buy me phone one day." +It's a cheap phone.,Na kpalasa phone. +"Meanwhile, this friend of mine, her husband bought her this and that.","Meanwhile, dat my friend, im husband buy am dis, e buy am dat." +It... it gets them worried.,"E dey, dey, e dey worry deir brain." +Their brain doesn't... it doesn't get tuned to the right place.,"Deir brain no dey, e no dey twist for right place." +"Yes, that's greed!",En na greed. +I said it.,I talk am. +Women are very greedy.,"Greed dey worry women well, well." +You can also call it indiscipline.,You go still call am indiscipline. +You can still call it...,You go still call am... +How can I even put it?,How I wan take even describe am? +"So, such women uh... at any available opportunity, they sure will cheat on the man.","So dose kind women ehn, small opportunity like dis, dem go cheat on di man o!" +"Even if you are married to her, or you're still dating, they will cheat on their man.","Wheda you don marry am for house sef, or una still dey date, de go cheat on di man." +"Do you understand me, man?",You dey understand me so my broda? +"Then, you see those women over there, don't you?",Den you see women wey you dey see dere so ehn? +Hum!,Hm! +"Men, as they are, uh... we call them predators.","Men, as dem be so ehn, we dey call dem predators." +Predators.,Predators! +They will...,Dem go... +Yes!,Yes o! +"Once they see a woman they like, they will move heaven and earth.","Once de don see woman wey dem like like dis, de fit turn di heaven, and earth upside down." +They must... they must get that woman.,"Must, de must get dat woman, de must get dat woman." +"So it will take the grace of God for a wo-... wo-... a woman that a man will tell, ""I must get you"" like this, it will take the grace of God for her not to fall.","So e go take di grace of God for wo-... wo-... woman wey man talk sey I must get you like dis, e go take di grace of God make you no fall." +Because...,Because... +"Eh, what?",Eh wetin? +Am I talking to you?,I dey talk to you? +"So, because the man, uh... He will study you, study everything.","So because dat man, ehen e go study you, study everyting." +Your...,Your... +"He will understand what you suffer from, what you need.","E go understand wetin you dey suffer, wetin you dey lack." +Then he'll start giving you those things,E go con begin dey give you. +May God catch you!,Meh God come catch you! +"If your husband starts misbehaving or if he is not serious, you will just fall.","Your husband for house sef, e come dey misbehave, or na one kind yeye man, you go just fall." +"Here's the news, which Afoda Samuel is about to read.",Na di news be dis wey Afoda Samuel wan read. +"First, let me tell you the highlights from the news.","First, make I yarn you di koko wey dey for inside di tori." +The Senate President has gone to inspect some power plants in Berlin.,Senate Presido don go inspect some power plant wey dey for Berlin. +The FRSC has caught six hundred and fifty seven people for failing to install speed limiting devices in their vehicles.,"Frsc don catch six hundred, and fifty seven people on top sey dem no put speed limiting machine for inside dem vehicle." +A woman has been arrested in South Africa over a baby that was kidnapped.,Dem don catch one woman for South Africa on top baby wey dem kidnap. +"Sunshine Queens, they are ready for the new Nigeria Women Premier League Season which is about to start.","Sunshine Queen, dem don ready for di new Nigeria women Premier League season wey wan start." +"Now, let's tell you the news in full.","Now, make we yarn you di full tori." +"How to handle the law on... how they generate power, transmission and how they distribute it, can be the best thing which can be done to solve the current electricity problem facing the country.","How to take handle law on how dem take dey generate power transmission, and how dem take dey distribute am, e be di best thing wey dem fit do o to solve di current electricity problem wey dey shele for di country." +"In an interview with the Project Leader, Warner Fortwiter, he said that Nigeria... they will still benefit from the plan to switch to renew-... build energy... from electricity generation.","For one interview with di project leader, Warner Fortwiter, im dey yarn sey Nigeria, dem go still benefit o from sey dem wan switch to renew build energy from electricity generation." +Let's listen to him.,Make we hear as e talk am. +"The Senate President, Bukola Saraki, says this while on a tour with others to an energy self sufficient village located in Germany.","Di Senate Presido, Bukola Saraki, na im dey yarn dis one when e do one kind tour wey dem follow am do for one energy self-sufficient village wey dey for Germany." +"He said the National Assembly must rework the law which will allow communities to generate energy, and allow people to use their brain, and involve people in the private sector as well.","E say di National Assembly, dem gats to rearrange di law o wey go allow communities make dem fit dey generate energy, and to allow people make dem dey use deir brain, and to even involve people wey be sey dem be private business." +Let us hear as the President says it.,"Di Lake Chad Basin Commission, LCBC, na im don identify o sey na dis kind ozigi wey dem dey call insurgency, and climate change na dem be di major gbege wey be sey e dey follow effective groundwater management for di basin." +"The Lake Chad Basin Commission, LCBC, have identified that the kinds of issues known as insurgency and climate change are the major problems facing effective groundwater management in the basin.", +"In Abuja, their Technical Director, Doctor Mana Bubakari, says that the situation has become complicated by the growth of people... the number of people which keeps increasing in the region due to the many people who have been forced to leave their homes.","Dem technical director, Doctor Mana Bubakari, na im dey yarn for Abuja sey di situation, na im don pakaso by di growth of people, number of people wey be sey e dey increase for di region following as people wey war don pursue comot for deir house, as dem dey plenty for dere." +He said there are almost nine million people whose livelihoods depend on the lake staying in the region.,"E say na like nine million people who be sey how dem take dey live deir life, e dey depend on top di lake na dem dey stay for di region." +"Their commission is a kind of intergovernmental organization that oversees water and other natural resources, and how they are used in the basin.","Dem commission na one kind intergovernmental organisation wey be sey na dem dey oversee water, and oder natural resources, and how dem take dey use am for inside di basin." +The eight member government was chosen because they are close to Lake Chad.,"Di eight member government, na dem just choose o sey, because sey dem dey close to Lake Chad." +"They are Cameroon, Chad, Niger, Nigeria, Algeria, the Central African Republic, Libya and Sudan.","Dem be Cameroon, Chad, Niger, Nigeria, Algeria, plus including di Central African Republic, Libya, and Sudan." +"The Joint Admissions and Matriculation Board, JAMB, has said that they will start selling the twenty seventeen UTME (Unified Tertiary Matriculation Examination) form on March twentieth.","Di Joint Admission, and Matriculation Board, JAMB don yarn o sey dem go start to dey sell twenty seventeen UTME form on March twenty." +"The Chief spokesman for JAMB, Doctor Fabian Benjamin, said this today in Abuja.","Di oga for JAMB talk, talk, Doctor Fabian Benjamin, na im dey yarn dis one today for Abuja." +Doctor Benjamin said that the date was fixed for the twenty-fourth of January following the agreement they made on the harmonization of the examination timetable in a meeting with other examination bodies.,"Doctor Benjamin yarn sey di date, na im dem fix o following one kind agreement wey all of dem take together for di harmonisation of di examination timetable for one meeting with oder examination body for di twenty-fourth of January." +JAMB said recently that they will arrange an optional mock exam which anyone interested can sit for before the twenty seventeen UTME [Unified Tertiary Matriculation Examination].,"Jamb, recently, na im dey yarn sey dem go arrange one kind optional mock examination wey anybody wey like am fit do before di twenty seventeen UTME." +"According to what the board said, what they want to do with the mock exam is to allow candidates to have a feel for what the examination... what it will look like.","According to wetin di board yarn, wetin dem wan take do di mock examination na to allow candidate mey dem feel o wetin di examination, wetin e go be like." +They said candidates can choose whether or not they want to take the mock examination.,"Dem say candidates, dem fit choose o wheda dem wan do di mock examination, abi dem no dey do." +"The Federal Road Safety Corps, FRSC, in Anambra has said that they have arrested no fewer than six hundred and fifty seven motorists who have not installed the speed limiting device in their vehicles in February.","Di Federal Road Safety Corps, FRSC for Anambra don yarn sey dem don catch like six hundred and fifty seven people wey dey drive car on top sey dem never put di speed limiting device for inside deir car in February." +"Speaking on the subject, Area Commander, Mister Sunday Ajayi, said that while one hundred and seven people were caught by a kind of mobile court, one hundred and two of them were deemed guilty and have been handed punishments.","Di oga for di area, Mister Sunday Ajayi, na im dey yarn dis one for one interview wen he dey yarn sey one hundred and seven people, na im dem catch by one kind mobile court, and one hundred and two of dem o, na im dem see sey deir hand no pure wey dem sama punishment." +"According to him, fifty one of them were guilty of non-installation of the device while others were involved in other offences including passing through roads they were not supposed to.","According to him, fifty one of di people, na im de gats to do with sey dem no put di device while oders na due to oder offences including sey dem dey pass different ways wey be sey dem no suppose pass." +"They were speeding too much, which the whites call overspeeding.",Dem too dey run wey Oyibo dey call overspeeding. +They were overloading or driving recklessly.,"Dem dey overload, and dem dey drive very, very dangerously." +"He said we have X to drive home with road users, people who operate different kinds of cars [fleet operators].","E say we don X able to drive home with road users, people wey be sey dem dey operate different kind of cars." +"On Nigerian roads today, you cannot drive in any way without installing the device we asked you to install.","Sey for Nigerian road today, una no fit dey drive anyhow without sey una put di device wey we say make una put." +"This is still the six PM news on Lagelu, ninety-six point seven FM.","Na still di six p.m. news be dis on top Lagelu, ninety-six point seven FM." +"Still from this news bulletin, a woman has been arrested for the kidnapping of a baby in South Africa.","Still for inside dis tori, de don catch one mama on top baby wey dem kidnap for South Africa." +"Sunshine Queens, they are ready for the New Nigeria Women Premier League Season.",Sunshine Queens dem don ready for New Nigeria Women Premier League season. +We will take a short break now.,We go take a chikini break now. +"When we come back, we will read you more news.",When we show back we go yarn una more tori. +Don't leave!,Make una never waka. +I just came to the shop this morning.,"Dis morning, I just come shop o." +My friend said we should go eat.,My friend say meh we go eat. +"I said well, myself, I don't have the money to spend on food.","I say toh me, I no get money wey I go take eat." +He said we should go.,Im say make we go. +"I said this is the last two hundred naira on me, and you want us to spend it on food, right?","I say na di last two hundred naira wey dey my hand, and you want make we use am go eat?" +I said he knows that business is slow.,I say because im know sey work no dey. +He said we should go eat.,Im say meh we go eat. +And so we went to eat.,Na so we go eat. +"When we finished eating, he said I should take him to Wazobia Park, he wants to buy some stuff.","When we eat finish, e say mah carry am go Wazobia Park, im wan go buy market." +"I said aha again, I don't have fuel for the bike.","I say aha again, I no get fuel for bike." +"He said I shouldn't worry, he would buy me fuel, we will go.","Im say mah no worry, im go buy fuel for me, we go go." +We bought fuel.,We buy fuel. +And that's how we left.,Na so we go. +We went to buy the goods.,We go buy di goods. +"As we were coming, this, uh, highway... we wanted to pass the highway, so a lot of bikers were there, and you had to climb.","As we dey come, dis eh highway (we wan pass di highway), so okadas con plenty for dere, and you gats climb up." +"Before you climb, you have to pass through the place.","Before you go climb, you go pass di place." +"I didn't know that my guy, he was sitting down, he was carrying goods.","I no know sey my guy, im siddown, im carry goods." +He was carrying goods.,Im carry goods. +I didn't know that he was not sitting properly.,I no know sey im no siddown well. +"And so, I moved, I stopped, I moved, I stopped.","Na so I dey move, I dey stop, I dey move, dey stop." +"When it was time to climb and keep moving, I just didn't see my guy again.","When time go reach, wey I go climb up dey go, I no just see my guy again." +"I didn't know that he had fallen off and was on the ground way back, and myself, I was far away.","I no know sey im don fall for ground dey for back and me, I don waka go." +"After I had crossed, so I had to turn back.","Till when I don cross, naim I con turn back." +Then I saw him carrying goods.,Naim I see am carry goods. +"I, I didn't even know that anybody got off my motorbike.","I, I no even know sey person don even come down for my machine o." +I just saw him carrying goods and standing at the back.,I just see am carry goods stand for back. +"So I said, ""okay, well, let me turn back and meet him.""","So I say okay toh make I come back, con meet am." +"He said no, I should just stay where I was.",Im say no mah just stay. +"That was how he went carrying the goods, he stopped another bike and was going.","Na so im carry di goods dey run, stop anoder bike, con dey go." +As if...,As if... +What did I do wrong?,Where I get fault for inside? +Did I screw up?,I get any fault for dere? +"Me, I didn't know that he fell on the ground.","Me, I no know sey im fall for ground now." +"And me, I...","And me, I..." +"And because the place was high up, he was on my back.","And because di place dey up, im dey for my back." +So he fell as I moved.,"So as I move, naim fall." +People told me he had fallen.,People con tell me sey im don fall. +And I had...,And I gats... +That place is a busy place.,Dat place na busy place. +"I had to be careful, so that nothing would hit my bike, or something.","I gats park well wey be sey noting go hit my bike, or someting." +That's how I turned.,Na so I con turn. +Then we met at the shop.,We con meet for shop now. +"He was telling people that uh... that I, I don't know how to ride a bike.","E con dey tell people sey eh, sey me, I no sabi drive machine." +"That's how it is, I ride the motorbike anyhow, he fell, etc., etc., etc.","Na so I just drive di machine anyhow, im con go fall for ground, wetin, wetin, wetin." +That's why he didn't ride my bike on the way back to the shop.,Na im make I no con climb my bike come back again. +"I said well, no problem.",I say toh no wahala o! +"That's how I laid the matter to rest, then I moved on.","Na so I con leave am, con move ahead." +I don't know if I did something wrong.,I no know wheder I get fault for di someting wey I do. +There's this boss of mine who trained me.,De get dis my oga wey teach me work. +"So everytime myself, and another guy, we always go to his house.","So everytime me, and one man, we dey always go im house." +We used to go.,We dey go. +"Like... sometimes, we would buy bottles of beer, and we would drink.","Like sometimes, we go buy beer, we go drink." +I used to look at this guy.,I dey see dis guy. +"In the morning, before he went to work, he would just come, he would buy bottles of beer, he would drink as much as he wanted, and we, we would be in his house aha.","In di morning, before im go work, im go just come, im go buy beer, im go drink well, well, and we, we go dey im house aha." +"Then, I asked...","Den, I con ask..." +"In, in the evening, we would still be there, in his house.","In, in di evening, we go still dey im house dere o." +He would still come back.,Im go still come back. +That's how he would buy drinks.,Na so e go buy drink. +"He would drink, I mean enjoy himself.","E go drink, as in enjoy imsef." +"Then I was asking my guy, ""ah, this guy, what kind of work does he do?""","I con dey ask my guy sey ah dis guy, which work im dey do?" +So he told me that...,Naim e con tell me sey... +"Because then, I didn't even know what they called car AC (Air Conditioning).","Because den, I no even know wetin de dey call car AC sef." +I only knew that cars had AC.,I just know sey car get AC. +Do you understand?,Shey una understand? +So I should have asked my...,Naim I for ask my... +Because I just completed my ND (National Diploma) then.,"Because den, I just finish my ND." +But it's not that I actually finished the programme.,But no be sey I even round up. +"Based on one or two issues, I only left the place over finance, and some other things.","Based on one, or two issue, I just free di place because of finance, and some oder tings." +"I only left the school so I wouldn't get into the wrong hands, or something.","I just leave di school so dat meh I no go meet myself for wrong hand, or someting." +"I just left the school, I came back.","I just leave school, I come back." +So I went to join the...,So naim I con go join di... +So I went to Zuba to stay with one of my friends.,Naim I con go Zuba go stay wit one of my friend. +So we started going to that guy's place.,So we con dey go dat guy place. +"Now, he told me that the guy worked on car AC.","Now, e con tell me sey di guy dey do car AC." +"I said, ""what is car AC?""",I say which one be car AC? +He said AC for motor cars.,Im say AC for motor. +"So I said, ""ehen.""",Naim I con say ehen. +He said...,Im say... +"I said, ""where is the guy's shop?""",I say where di guy shop dey? +He said it was where they sell spare parts for cars.,E say e dey for motor spare part. +I said ehn.,I say ehn. +"I said okay but mstchew, that car AC... me, I'd like to get some experience in that area.","I say okay but mtschew dat car AC, me, I go like get experience for dat ting." +"Because me, I am a technical person.","Because me, na technical man I be." +Because I was in the Engineering department from SS (Senior Secondary School) one to SS three.,"Because from my SS one, to SS three, na engineering department I dey." +Doing Electrical Electronics.,Dat is elect elect. +You understand?,Shey you understand? +"And for my... and for my ND (National Diploma), I was in Electrical Engineering.","And for my, for my ND, na electrical engineering I dey too." +So he said that t-... not at all.,So im con tell me sey t-... no o. +That mstchew... that... my friend said no.,Sey mtschew dat my friend con tell me sey no o. +That I wouldn't be able to do it because me I'm above that.,"Sey me, I no go fit do am because me, I don pass." +That uh... he sees me as a big boy.,Sey ah im dey see me like big boy now. +"That me, I wouldn't be able to do it.","Sey me, I no go fit." +"I said, ""man, in this life, you've gotta be smart","I say oga, dis life, you gats see." +"I mean, you have to be loyal.",As in you gats loyal. +"I mean, you have to be humble to get what you want.",As in you gats bring yourself down to achieve wetin you want. +"So he told me that well, he'd go see the guy.","Im con tell me sey toh, sey im go go see di guy." +So I said okay.,I con say okay. +"The next day, I went up to him and said we should go and see the guy.","Di next day, I go meet am sey meh we go see di guy." +He said he wanted to go somewhere.,Im say im wan go somewhere. +"So me, I walked to the guy's house.","Na so me, I waka go di guy house." +"And I said ""boss...""",I con tell am sey oga... +I greeted him.,I greet am. +"He said, ""yes.""",Im say ehn. +So we chatted since he knew me.,We con greet based on sey im know me. +He saw me around from time to time.,Im dey always dey see me. +They have even told hima about me.,De don even tell am tings about me. +Then he told me that...,Im con tell me sey... +"I told him, ""man, I heard you work on car AC, mstchew.""","I con tell am sey oga, I hear sey you dey do car AC o mtschew." +I'm interested in that line of work since I've noticed how you're doing.,I dey interested for dat work because I just see as you dey go. +I want to get an idea.,I wan get di idea. +Then he laughed.,Im con laugh. +"And he said, ""hh.""",Im con tell me sey ah. +"But he heard that me, I'm an electrician.","But im hear sey me, I be electrician." +That I... I went attended the polytechnic.,"Sey I, I do ehn poly." +"I told him I attended the polytechnic but I didn't finish the program, but I n-... I need to get busy.","I tell am sey I do poly, but I no round up, but I n-... I need to put myself busy." +"Daily activities and things like that, you know?","Everyday activity like dat, shey you understand?" +"Then he said, ""well, no problem at all.""",Im con tell me sey toh no wahala now. +"He said well, since I... since I came on my own, he believed I could do it.","Sey toh since I, since na me carry myself come, im believe sey I go fit do am." +"Since I understood technical things, he believed I could do it.","Since I get idea for technical tings, sey im believe sey I go fit do am." +I said I will.,I say I go fit. +"He said okay, I should come and meet him in the shop the next day.",Im say okay mah con meet am for shop di next day. +So I went to meet him in the shop the next day.,Na so I go meet am for shop di next day o. +"From that day on I went to meet him in the shop, he started observing me, he was observing my attitude.","From dat day, as I go meet am for shop, im con dey observe me, dey observe my attitude." +"He was wondering if mstchew, I'd be showing him lip or whether...","Im dey reason wheder mtschew I wan dey form big boy for am, or wheder..." +He would hand me errands he wasn't supposed to give me.,Im go send me some kind message sef wey im no suppose send me sef. +He would notice that I did them.,Im go see me say I go do di message. +"Then one day, I just came to work.","Den e get one day, I just con work." +It's not that I got there really late.,No be sey I too con late. +He asked me to kneel down at the gate,Im tell me sey mah kneel down from gate. +And said I should crawl from there until I get inside the garage.,Mah use my leg dey crawl dey come inside garage. +So I... so I kneeled down right there,"Na so I, na so I kneel down for dere." +And I started crawling towards him.,Start dey use my leg dey crawl dey come. +I was crawling towards him.,Dey use my leg dey crawl dey come o. +That was how...,Naim... +He c-...,Im c-... +"Someone said ""ah, Chris!""",Na person con tell me sey ah Chris! +He said they they sin-... they asked me to stand up.,Sey de sin-... de con tell me mah stand up. +"When I stood up, later, later in the day, another guy in charge of mechanics said ""uh, Christopher""... he said your boss shouldn't...","When I con stand up, later, later in di day, naim one oder oga for mechanic con tell me sey ah Christopher, sey meh your oga ehen..." +He said I should...,Tell me sey meh... +That I shouldn't be angry about what my boss did in the morning.,Sey meh I no vex for wetin my oga do me in di morning o. +He said my boss just wanted...,Sey my oga just wan... +That was two weeks after I joined him.,"Dat was after two weeks, when I join am." +He said my boss just wanted to test me.,Sey my oga just wan test me. +Maybe I'd show him an attitude.,"Wheder me, I go dey do big boy for am." +Maybe I'd be stubborn.,Wheder I go do strong head. +"I told him that no, I can't do that.","I tell am sey no, me, I no fit do like dat now." +Because when you wanted to get trained for something... you submitted yourself as an apprentice.,"Because where you wan learn someting, you carry yourself come say you wan learn someting." +Your... you will... you have to be loyal.,"Your, you go, you gats dey loyal." +You can't show attitude or say anything.,"You no go dey form big boy, or say anyting." +"So the next day, my boss asked me to go and bring my training fee, come with drinks and afterwards sign the apprenticeship form.","Naim di next day, my oga con tell me sey meh I go bring my money, come wit my drinks, meh I con sign." +That was how I signed the apprenticeship form and continued till I got myself a shop and started hustling here in Gwagwalada.,"Na so I take sign di work till I con get my shop, con dey hustle for Gwagwalada here." +"This is where we prepare shawarma, and this place is Lucky Special Shawarma, which we make here.","Na here we dey do shawarma, and dis place na Lucky Special Shawarma wey we dey do here." +"Well, I'm the one who makes it.",Toh na me dey do am. +My name is Fidelis Isaac.,My name na Fidelis Isaac. +"About shawarma, it has...","As shawarma dey like dis, it has eh..." +We have it in grades.,We have grade by grade. +It comes in grades.,E dey grade by grade. +So we have the one worth five hundred naira.,So we have di one of five hundred naira. +And the one which is worth seven hundred.,And e dey di one wey e be seven hundred. +The other one is one thousand naira.,Di oder one na one thousand naira. +That... all of the shawarmas are big.,"Dat, all of dem na big shawarma." +We have one which is Chicken Shawarma.,We get di one wey be chicken shawarma. +"And as this is one of the favorites, the one for five hundred, we make it with just one sausage.","And as de dey like dis now, di one of ehm five hundred, na one sausage wey we dey put am." +"The one for seven hundred, we make it with two sausages.","Di one of seven hundred, two sausage, na im we dey put am." +"But the one for one thousand has two sausages, and it will be jumbo size.","But di one of one thousand, na two sausage, and e go be jumbo size." +"So since we make it here, the market is growing because the price is this uh... constant, you know.","So as we dey do am here, na so market dey grow because di price is dis eh constant you know." +"Now, the ingredients we use is salad.","Now di ingredients now, na salad wey we dey use." +Salad is cabbage.,Salad na cabbage. +"We'll slice it, add carrot, add uh... corn, green beans, and all these things.","We go slice am, put carrot, put eh sweet corn, green beans, and all dis things." +And uh... you will add beef.,And ehn you go put beef meat. +Beef comes from cows.,Beef meat na cow meat. +You will add uh... chicken.,You go put eh chicken. +"Chicken is a bird, you now.",Chicken na fowl you know. +So this is pepper which we also add.,So dis one na pepper wey we dey put am also. +And this is Lebanese bread... Chinese bread.,"And dis is Lebanese bread, Chinese bread." +We put all these ingredients on it and then we fold and wrap it.,"Naim, we dey use put all dese ingredients come fold, and wrap am." +This is my toaster.,Dis is my toaster. +So these are the things we use to make shawarma.,So dis are di things dat make shawarma. +"And for someone to sell Shawarma, it's all about, you know, time, and discipline.","And it has to do wit you know time, and discipline for someone to sell shawarma." +So it's a... it's a commitment thing.,"So it's a, it's a thing of commitment." +That's... we do it here.,Na im we dey do am here. +"So since jobs are not readily available in Nigeria nowadays, that's why we said we should be making shawarma.","So as work no dey for Nigeria now, we just say meh we dey do shawarma." +At least to create an opportunity for work.,At least to create jobs chance meh person dey work. +Uh... this is Ajegunle.,Eh here na Ajegunle. +So um... we do okay enough business.,So ehm people dey try sha. +"That's why the price is as low as five hundred naira, so that people will buy it.",Na im make di price come small like dis five hundred naira so dat people go buy. +"And by His... by the grace of God, they are buying... they are buying... they are trying.","And by His, by di grace of God, de are buying, de are buying, de are trying." +"Anyone who wants to pass... who wants to buy, they will come in.","Anybody wey want pass, wey wan buy, im go come." +That's why I stay here to sell it.,Na im make me stay here dey sell am. +That's how it is.,So na so e be. +"Taking myself for instance, I'm here in this place... this side of Ajegunle, I open by one o clock in the afternoon and I close by eleven.","Like me, here wey I dey, dis place now o, dis side of Ajegunle, na one o'clock wey I dey open for afternoon, con close eleven." +"So at that time, I believe that people coming back from work will stop at my spot... my Shawarma Spot, to buy some.","So as dat time now, I believe sey people wey wan return work go branch my spot, my shawarma spot, con buy." +Um... that's all.,Uhm dat is it. +"Ladies and gentlemen, the Yoruba people have an adage which says, ""to ba kowaju si o, ko o ta; to ba keyin si o, ko o ta; to ba ku iwo nikan, ko o tun ero ara re pa."" [Meaning: Take charge of every situation; be in control at all times]","Ladies and gentlemen, Yoruba people go talk am for one adage won ni to ba kowaju si o ko ta to ba keyin si o ko ta to ba kun iwo nikan ko tun ero ara re pa." +"That means, if a situation challenges you from the front, give it your full attention and overcome it.","That is to say if di tin face you, dem say make you shoot am o." +"If the challenge is from behind, equally give it your attention and overcome it; but when you are left all alone, with the situation still lurking somewhere, ladies and gentlemen, apply wisdom!","If e back you, make you shoot am, but when be sey na only you, and am dey, ladies, and gentlemen, make you use your brain o!" +They are talking about the whistle blowing policy... engage in gossip and make money.,"Dem dey talk sey whistle blowing policy, make una con dey do ofofo dey collect money." +"But, well, before you engage in gossip in order to collect money, think about it deeply","But sha o, before you do ofofo to collect money, reason am well, well o." +"Because here's a man, he engaged in gossip and now he's in trouble, courtesy of he himself, but they are fighting on his behalf.","Because sey one man now, e don do ofofo, e don enter gbege for himsef, by himsef o, but sha dem dey fight for am o." +"The Socio-Economic Rights and Accountability Project, SERAP... they have sent an open letter to the Minister of Foreign Affairs, Geoffrey Onyeama Godfrey.","Di Socioeconomic Right, and Accountability Project, SERAP, dem don send one kind open letter to di Minister of Foreign Affairs, Geoffrey Onyeama Godfrey." +What are they saying to Godfrey?,Wetin dem dey tell Godfrey? +"They said they should make sure that the workers who were sacked on account of whistle blowing [gossip]... (he went to report that they were fraudulent, they were into malpractices of all sorts, they were involved in corrupt practices in the uh.. ministry)... were reinstated.","Dem say make dem make sure sey di workers wey dem sack on top sey e do ofofo (e go talk sey, dem dey do jibiti, dem dey do mago, mago, dem dey do makaruru for inside eh ministry), make dem give am im work back o." +"They said one Intia Thompson, is the one who was sacked through a post on the Directorate of Technical Cooperation for Africa's Notice Board.","Dem say one Intia Thompson, na im dem sack through a post on top di Directorate of Technical Cooperation for Africa's Notice Board." +What did Thompson do?,Ki ni Thompson se? +What did Thompson do?,Wetin Thompson do? +Thompson gossiped?,Thompson don do ofofo o? +"He said they engage in fraud, tricks... fraud of two hundred and twenty nine thousand dollars in the Ministry of Foreign Affairs.","Sey dem dey do jibiti, wayo, fraud of two hundred, and twenty nine thousand dollars for di Ministry of Foreign Affairs." +"They deceived people in a letter which was dated March ten, twenty seventeen.",Dem dupe people for one letter wey dem date March ten twenty seventeen. +They are demanding that Oyama act swiftly.,"Dem dey ask Oyama o to act sharperly, sharperly." +"He should comply with the whistle blowing policy of the government of President Muhammadu Buhari, and the international standards which say that anyone who gossips under the whistle blower... against what they call harassment [idunkokomoni - harassment] they will not do what?","Make e comply with di whistle blowing policy of dem government of President Muhammadu Buhari, and international standard wey dey talk sey anybody wey dey do ofofo under di whistle blower against wetin dem dey call harassment, idunkokomoni, dem no go do wetin?" +They will not threaten them; they will not intimidate them.,"Dem no go threaten am, dem no go intimidate am o." +"He will just blow the whistle, and he will collect money, and he will go.","E go just do di ofofo, and e go collect money, and e go go." +Don't they say that every profession has its hazards?,Shebi dem dey talk sey na every work e get im own hazard. +"If you want to be a whistle blower, one of the hazards of your own profession is that they will harrass you, they will intimidate you, in fact they can kill you if God is not on your side.","If you want be whistle blower, one of di hazard of your own profession be sey dem go harass you, dem go intimidate you, dem fit even kill you if God no dey your side." +"SERAP, in a letter which was signed by the Deputy Director, Timothy Adewale, was saying how did they sack Thompson?","Serap, for one letter wey dem sign by dem Deputy Director Timothy Adewale, dey yarn o sey how dem take sack Thompson?" +The Ministry will appear to say they're hiding information concerning the fraud.,"Di Ministry go appear o to say rua, say dem dey hide information ni ontop di jibiti." +"They insist because the public has the right to know what is going on, how the money disappeared.","Why dem dey insist be sey public dem get di right o, to know wetin dey shele, how di money matter, how e take waka." +"Well, SERAP has been saying that Thompson should be called back.",Toh SERAP sha don dey talk sey make dem carry Thompson back o. +Or else Aijebe...,Or else Aijebe... +They said what?,Dem say wetin? +"The issue, it will take a new turn.","Di matter, e go be as e get, e go get as e be." +Lord have mercy.,Oloun sanu wa. +"Ladies and gentlement, I won't say you should not do what... you should not blow the whistle.","Ladies, and gentlemen, I no go say make you no do wetin, make you no blow whistle o." +"Blow the whistle because if you blow the whistle, you will become a millionaire, but if your whistle fails or you get caught before the people who were supposed to hear the whistle... you get caught... may God have mercy on you.","Blow whistle because sey if you blow whistle, you go turn millionaire, but sha o if your whistle no con loud, abi dem catch you before di people wey de suppose hear di whistle dem catch you, oloun sanu e o." +That means what?,Dat means sey wetin? +"Only you, for yourself, by yourself and your family, will get into trouble.","Na only you for yoursef, by yoursef, and your family na im go enter trouble." +God have mercy on us.,Oloun sanu wa. +"Well, I have left that kind of story.",Toh I don comot from all dose kind tory. +"I am in the 'wonders shall never end corner', the one they call what?","I don enter pekele, pekele arugbo jegbese, di one wey dem dey call wetin?" +Stories from the women's angle.,Woman angle story. +God have mercy on us.,Olorun ma saanu wa. +"What is this, what did I see?","Wetin be dis, wetin I see?" +God have mercy on me again.,Olorun maa tun saanu mi ke. +There's nothing much to do about it.,"Dis matter, e be as e get, e get as e be o." +"It's not true that you employ a person so that they can become someone in life, but when the one you employ kills you, what do we do?","Sebi na person dey employ person make im too con become better person for life, but when person wey you con employ con kill you nkor, wetin we go do?" +How do we handle this?,Ki ni ka ti seyi si? +"It was said that a man in a restaurant in the Awoyaya area of Ibeju Lekki in Lagos State, has been arrested by oro-... operatives of the Lagos State Command because the man robbed his Mistress, one Paulina Paul.","Dem say one sales man for one restaurant for Awoyaya Ibeju Lekki for Lagos State, dem don catch am o by oro-... operatives of di Lagos State Command on top sey di guy rob im oga, one Paulina Paul." +"The suspect, a twenty two year old Stephen Otuyi... the guy is said to have joined hands with... he connived, he collaborated with one Ibrahim Muhammad, and others who happened to have stole away.","Di suspect, twenty two years old Stephen Otuyi, dem say di guy nko, e go ledi apo po, e go connive go do collabo with one Ibrahim Muhammad, and oders wey be sey dem don run o." +"They harrassed the woman in her house which is in Olomide Idiala Street, Oria-... Oribanwuwa Phase Two in Ibeju Lekki.",Dem go harass di woman for her house wey dey for Olomide Idiala street Oria-... Oribanwuwa phase two for Ibeju Lekki. +We heard that Otuyi owns the restaurant.,"We hear o sey Otuyi, na im get di restaurant." +The reporter also heard that the gang stole her phone.,Report man too hear sey di gang dem thief her phone o. +"They stole her jewellery and clothes among other things, which means that her money, if it's taken to the market, will be like... about uh... two million naira.","Dem thief her jewellery, and clothes among other tings wey be sey im money, if dem carry am go market, dey go like about eh two million naira." +Shout.,E pariwo. +Allah.,Pe Allahu. +"A whopping sum of two million naira, what did the woman do to them?","Two million naira (tan yan, yan) wetin di woman do for dem?" +What did she do to them?,Wetin e do for dem? +Aunty Sola Alison sang about it.,Shebi Auntie Sola Alison don take am sing. +"That's just to say that if there's no accomplice, if you don't have an informant in the house, it is said that the enemy coming from outside cannot succeed.","Dat is to say if dere is no accomplice, if you no get anybody for inside di house, de say di enemy wey dey come from outside, e no get wetin e fit do o." +"But it's actually this employee who gathered people to rob his Mistress, who pays his salary.","But sha o dis person wey de employ, na im gangan, na im gather people wey dem con rob im oga wey dey pay im salary." +Shout Allah akbar.,E pariwo pe Allah akbar. +God have mercy on us.,Olorun sanu wa. +Father God should do what?,"Baba God, make e dey do wetin?" +He should save us.,Make e dey save us ni o. +"Just a twenty two year old suspect... twenty two years old, what was he looking for?","Twenty two years old suspect pere, twenty two years old, wetin e dey find?" +"It was said that Paul started working in the restaurant sometimes in January, twenty seventeen.",De say Paul start to dey work for di restaurant o sometimes in January twenty seventeen. +And he was sacked after one week.,"And after one week, dem sack am o." +"After he lost the job, on the last day, he asked for the payment of his salary which is about three thousand five hundred, but the woman was telling him that she didn't have cash on her, so he would have to come back.","After di work don close, on di last day, e say make dem pay am im money wey be sey na like three thousand five hundred, but di woman dey tell am sey e go come back ni, money no dey for ground o." +"Around ten pm on January twenty one, the guy went to threaten his Mistress in the restaurant","Around ten p.m. on January twenty one o, naim di guy go di restaurant, go threaten im oga o." +"That if you refuse to pay my money right now, now, now, now, now, trouble looms.","Sey if you no pay my money now, now, now, now, now, gbado, gbado a gbowo agbado lowo." +That's just to say that you will regret your actions.,Dat is to say you go regret yourself o. +"On January twenty two, at about two thirty am, they robbed the house, they entered Paul's house with a gun and cutlass.","On January twenty two, about two thirty a.m., de rob house, de enter Paul house with gun, and cutlass." +"It's been said that ""If something enters with a gun, with bullets... Mister, lie flat"".","Won ni tawon Kini Kan ba wole pelu ibon, pelu bullet ogbeni dubule." +"That was how they entered with a sinister looking cutlass [ada Lam/Lam's cutlass], and they took away her property, including a Toyota Matrix car.","Na so dem take enter o with ada Lamu, and dem carry away her property including a Toyota Matrix car." +They said the incident has been reported to the police.,"Dem say di incident, dem report am to di police o." +That was what led to Otuyi and Muhammed's arrest.,"Na so dem take catch Otuyi, and Muhammed." +But they guy insists that he doesn't know anything about the case.,But di guy still dey talk sey e no know anytin about di matter o. +That he was just threatening her.,Sey e just dey threaten. +Just an empty threat.,"Ni o, ni o, enu lasan ni." +Just talk.,Na just mouth. +Talk is cheap.,Ofe lohun. +"I was just saying things, I don't know anything, I don't have anything.","I just dey make mouth, I no sabi anything, I no get anything." +But you know it's possible that this guy doesn't know anything indeed.,But you know sey dis guy fit no know anytin sha. +God have mercy on us.,Olorun sanu wa. +"Ladies and gentlemen, don't talk when you are angry.","Ladies, and gentlemen, if you dey vex, no talk." +Did you hear him?,Shey you don dey hear am? +This guy's mouth got him into trouble.,"Dis guy now, e mouth don put am for trouble o." +"He said, ""I was working with the lady as a Sale's Representative, in her restaurant.""",E say I dey work with madam as a sale representatives for her restaurant o. +"""She was paying me fifteen thousand naira per month, and two hundred naira for transportation every day.""","She dey pay me fifteen thousand naira per month, and two hundred naira for transportation every day." +"""I only worked for a week.""",I only work for one week o. +"""I left because the second Sale's Representative, Justina, was telling the lady that I was not treating her well.""","I left because sey di second sales representative, Justina dey tell madam sey I no dey treat am well." +"""I just gave her some advice.""",I advise her o. +"""So she could get into the habit of saving money on a daily basis if she's planning to go back to Akwa Ibom, her home.""",Meh e dey save money on a daily basis if you wan go back to Akwa Ibom where she for come o. +"""She reported to the lady that I was encouraging her to steal money.""",She go tell madam sey I dey advise her make she dey thief money. +What!,Ewo! +It's a long story but the guy has been taken away.,"Di matter sha, e long, but sha de sha don carry di guy go sha o." +"The Magistrate presiding over the case, Mrs O. A. Amhohia, has granted him bail at the amount of five hundred thousand naira.","Di presiding magistrate on top di matter, Mrs O.A. Amhohia, e con grant am bail in di sum of five hundred thousand naira." +"Shout ""Allah.""",E pariwo pe Allahu. +Where will the person fighting for the payment of three thousand five hundred naira get five hundred thousand naira from?,Where im go see five hundred thousand naira person wey dey fight for three five? +Both of us are warrantors of the same money.,We two sureties each o for di same money. +"Then she adjourned the case till April twenty eight, twenty seventeen.",E con adjourn di matter till April twenty eight twenty seventeen. +"Well, Father God will help him; He will set him free; he will be able to escape.","Toh Baba God, e go help am, e go free am, e go fit comot." +For what?,On top wetin? +"On the level of e pele parile, parile, on the program today, a dishonest, fraudulent, deceitful, scam expert and thief, whose name is Eze Udoh, it's been reported that he has been arrested by men of the Umuahia Central Police in Abia State because the guy withdrew the sum of one million, forty nine thousand, five hundred and forty five naira from his victim's account.","Ontop di level (e pele parile, parile), ontop di programme for today, one magomago, jibiti, wayo, 419, jaguda pali wey e name na Eze Udoh, dem say dem don catch am o by men of di Umuahia Central Police for Abia State on top sey di guy go withdraw di sum of one million forty nine thousand five hundred, and forty five naira from im victim account o." +A policeman was saying what?,"A policeman, na im dey yarn sey wetin?" +"They have been searching for the suspect since a complaint was lodged by the victim, Mister Oka Monday, that the suspect stole his ATM card, and he collected all the money in his account.","De don dey find di suspect when dem go complain by di victim, Mister Oka Monday wey be sey di suspect, e thief im ATM card o, and e collect all di money from im account." +"According to the source, the victim who is from Amachara Umukpara, a satellite town close to the capital city, Umuahia, was making an attempt to withdraw some money from an ATM which is attached to the Commercial Bank in Umuahia when the suspect said he would help him because the network was bad.","According to di source, di victim wey come from Amachara Umukpara, a satellite town wey dey near di Capital City Umuahia, e dey make attempt o to withdraw some money from one ATM ni wey dem attach to Commercial Bank for Umuahia when di suspect e say e go help am because sey network dey fail." +"We heard that when the attempt to withdraw the money failed, the suspect had already memorised the victim's secret pin, he advised him to follow him to a nearby bank where the transaction will be easier.","We hear sey after attempt to withdraw di money, e fail, di suspect, e don memorise di victim secret pin card o, advise am to follow am to a nearby bank where dem go for do am easier o." +"Eh, what?",En sey wetin? +"What happened when they got there? He just... did he, he end up doing what he wanted to do?","When dem con reach di place nko, e sha, shey, e sha do wetin e go do?" +"Well, he ran away with the... he ran away with the ATM card.","E sha run away with di, e sha run away with di ATM." +I don't understand that.,"Dat one too, I no understand o." +Why would you give a stranger your ATM card and your pin too?,Why you go just carry your ATM give stranger give am your pin? +It was said that... what happened after that... he just started getting different alerts... debit alerts and the like.,"Dem say after dat one nko, e just dey get plenty, plenty alert ni o, debit alert pe ah aye o." +All his money was collected.,Dem don collect money finish. +God have mercy on us.,Olorun ma saanu wa. +They are watching us closely.,Dem police us hard o. +The security operatives started searching for the suspect following the intelligence report they gathered.,Sey security operative dey start to dey search for di suspect following intelligence wey dem gather o. +And their efforts later paid off when the suspect was caught.,"And di tin con later pay off when di suspect, dem catch am." +"He pointed out that while searching the suspect's house, they found thirteen different ATM cards belonging to different victims.","E point out to sey during im search for di suspect house, thirteen different ATM card wey belong to different victims, na im dem see o." +"The State Commissioner of Police, [hau] the overall boss [hau], Mr Adeleye Oyebade, confirmed the arrest of the suspect.","Di state oga patapata of police, shugaban kasa, kasa, Mr Adeleye Oyebade, e confirm di arrest of di suspect o." +He said he has confessed to the crime.,Sey e don confess witch. +He said he's the one stealing people's pins and their ATM cards.,"E say na im be di one wey dey chop people pin, and deir ATM card." +"Well, we thank God that he's been apprehended.","But sha o, we sha thank God sey God don catch am." +"If you are listening to me and you also steal people's ATM cards, by the grace of Allah, by the grace of Jesus, you will be caught at your next attempt.","If you dey listen to me, and you too you dey tief people ATM card, di next one wey you go go, dem go catch you insha Allah insha Jesus." +"Ladies and gentlemen, that's as far as we can go today on the programme, ""Naija Na Wa O"", we'll come your way again tomorrow by the grace of Allah, by the grace of Jesus.","Ladies, and gentlemen, na so di matter go reach for today on top di programme Naija Na Wa O to come back your way again tomorrow insha Allah insha Jesus." +"This is Lagelu, ninety six point seven.",Lagelu re ninety six point seven. +No longer on ninety six point three.,No more ninety six point three o. +We've done what?,We don do wetin? +"We've moved to a higher ground, just to serve you better.",We don port to higher ground just to serve you better naa ni. +"I will not leave the air today until I say a happy birthday to our Mommy, Mrs Kikelomo Orimolade, Mama Ilu, Mommy Ayodeji.","I no go go on top di air programme today until I say happy birthday to our mummy, Mrs Kikelomo Orimolade, Mama Ilu, Mummy Ayodeji." +Talking of what?,Talking of wetin? +Illusions.,Illusions. +"I say ""Happy Birthday, Mommy!""","I say mummy, happy birthday!" +Two hundred years is like a year to you.,"To you, two hundred years is a one year." +Two hundred years is like a year.,Igba odun odun Kan ni. +Long life and prosperity!,Long life and prosperity! +Happy birthday to you!,Happy birthday to you! +"Ladies and gentlement, until tomorrow when I will come your way again, I'm still your buddie, your brother and man on the radio.","Ladies, and gentlemen, till tomorrow when I go come your way again, na still me be your personal person, your brother man on di radio." +"A.K.A. Afuda Samuel is the full name, but you can simply call me Afuda Babba Agbalagba [Afuda the elderly one].","Aka Afuda Samuel is di full name, but you simply call me Afuda Babba Agbalagba." +"I sit on the ground, I am bending over, I am rolling on the ground, begging you to please take good care of yourselves, for my sake, simply because I love you all to the bone.","I sit down for ground, dey bend for ground, dey roll for ground, dey beg you to please take a wonderful care of yourself for me simply because I love you all to di bone." +Bye for now.,Bye for now.